Former Rivers sole administrator make list of ambassadorial nominees Tinubu forward to Senate for screening

Wia dis foto come from, Presidency
President Bola Tinubu don send two lists of 34 career and 31 non career ambassadors nominees for Senate to screen and confirm.
Prominent names wey dey listed as non career ambassadors include Reno Omokri, Femi Fani-Kayode, Gen. Abdulrahman Dambazau, Victor Ikpeazu and Ifeanyi Ugwuanyi.
Also listed as non career ambassadors nominees na Prof. Mahmood Yakubu, Senator Jimoh Ibrahim, Senator Nora Daduut, Fatima Ajimobi, Senator Ita Enang and former Rivers State Sole Administrator Vice Admiral Ete Ibas, among others.
Di two lists now bring to 68, di number of pipo nominated so far as ambassadors awaiting confirmation by di Senate according to NTA, wey be Nigeria national broadcaster.
President of di Senate Godswill Akpabio read di letter wey carry di request on di floor of di Senate on Thursday.
Who and who dey di list
Some of di ogbonge pipo wey dey di list na Reno Omokri, former presidential aide to Goodluck Jonathan.
Prof. Mahmood Yakubu wey be former Inec Chairman.
Former Lagos deputy govnor, Femi Pedro, former Aviation Minister, Femi Fani-Kayode.
Odas na di former Enugu State Govnor Ifeanyi Ugwuanyi, Senator Jimoh Ibrahim and former Rivers State Sole Administrator, Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas.
Many go remember Vice Admiral Ibok-Ete-Ibas sake of how President Bola Tinubu bin choose am to be di Sole Administrator of Rivers State recently.
Di former Chief of Naval Staff between 2015 and 2021 bin dey in charge of di oil rich Rivers State for six months during di emergency rule.
Na for March, 2025 President Tinubu declare Emergency rule for Rivers State and e appoint Ibas as Sole Administrator for di state. .
Ibok-Ete Ekwe Ibas na retired Nigerian Navy Vice Admiral, wey be di 22nd Chief of Naval Staff (CNS) of di Nigerian Navy from 2015 to 2021.
Di total number of pipo wey oga Tinubu nominate to be ambassador na 68 now.
Meanwhile, reports say three of dem - Kayode Are, Aminu Dalhatu, and Ayodele Oke - don already dey screened by di Senate Committee on Foreign Affairs.
Ambassadors na di highest-ranking diplomats wey dey represent dia kontri interest for outside dia kontri.
Di president na im dey appoint ambassadors to act as im representative for oda kontris. Dem dey always station dem for di embassy for any kontri dem send dem go.
Di ambassador work na to oversee all im kontri activities for any kontri e dey and to further strengthen foreign policy goals.
Di men and women wey dey serve as ambassadors fit be either "career" members of di Foreign Service or "non-career" political appointees.
Di career ambassadors dey trained for di work, dem go di school and don get plenti years of experience of working as diplomats.
Non-career ambassadors na political appointment. Di president fit appoint pesin as non-career ambassador maybe becos of im unique talent or expertise wey e go bring come di ambassadorial post, no be becos e get any training as ambassador.
Full list of di ambassadorial nominees
Full list of ambassadorial nominees by state
Career Ambassadors / High Commissioners:
Ambassador Ezenwa Chukwuemeka (Abia)
Maimuna Ibrahim (Adamawa)
Monica Ogochukwu (Anambra)
Ambassador Mohammed Mahmoud Lele (Bauchi)
Endoni Sindo (Bayelsa)
Ambassador Ahmed Mohammed Minguno (Borno)
Jane Adams Okon Michael (Cross River)
Clark Omeruo Alexandra (Delta)
Chimma Geoffrey Davies (Ebonyi)
Oduma Yvonne Ehinose (Edo)
Wasa Segun Ige (Edo)
Ambassador Adeyemi Adebayo Emmanuel (Ekiti)
Ambassador Onaga Ogechukwu Kingsley (Enugu)
Magaji Umar (Jigawa)
Mohammed Saidu Dahiru (Kaduna)
AbdulSalam Abus Zayat (Kano)
Shehu Barde (Katsina)
Aminu Nasiu (Katsina)
Abubakar Musa Musa (Kebbi)
Mohammed Idris (Kebbi)
Bako Adamu Umar (Kogi)
Sulu-Gambari Olatunji Ahmed (Kwara)
Ramata Mohammed (Lagos)
Shaga John Shama (Nasarawa)
Salau Hamza Mohammed (Niger)
Ibrahim Danlami (Niger)
Adeola Ibrahim Mopelola (Ogun)
Ruben Abimbola Samuel (Ondo)
Akande Wahab Adekola (Osun)
Adedokun Esther (Oyo)
Gedagi Joseph John (Plateau)
Luther Obomode Ayokalata (Rivers)
Danladi Yakubu Yaku (Taraba)
Bello Dogondaji (Zamfara)
Non-Career Ambassadors / High Commissioners:
Senator Grace Bent (Adamawa)
Senator Ita Enang (Akwa Ibom)
Nkechi Linda Okocha (Anambra)
Mahmud Yakubu (Bauchi)
Philip K. Ikurusi (Bayelsa)
Paul Oga Adikwu (Benue)
Vice Admiral Ibok-Ette Ibas (retd.) (Cross River)
Hon. Abasi Braimah (Edo)
Erelu Angela Adebayo (Ekiti)
Barr. Olumilua Oluwayimika Ayotunwa (Ekiti)
Rt. Hon. Ifeanyi Ugwuanyi (Enugu)
Barr. Chioma Ohakim (Imo)
Lt-Gen. Abdulrahman Bello Dambazau (retd.) (Kano)
Hon. Tasiu Musa Maigari (Katsina)
Alhaji Abubakar Sanusi Aliyu (Kogi)
Olufemi Pedro (Lagos)
Barr. Mohammed Ubandoma Aliyu (Nasarawa)
Senator Jimoh Ibrahim (Ondo)
Ambassador Joseph Sola Iji (Ondo)
Fani-Kayode (Osun)
Professor O. Adewole (Osun)
Florence Ajimobi (Oyo)
Lola Akande (Oyo)
Professor Nora Ladi Daduut (Plateau)
Yakubu N. Gambo (Plateau)
Chukwujinka Okocha (Rivers)
Haruna Abubakar (Sokoto)
Rt. Hon. Jerry Samuel Manwe (Taraba)
Adamu Garba Talba Nangree (Yobe).










