Wetin be career and non-career ambassadors Tinubu nominate to be di face of Nigeria for di world

Former President aide, Reno Omokri, Former Aviation minister, Femi Fani Kayode and former IEC charman, Mahmud Yakubu

Wia dis foto come from, X/@inecnigeria/@realFFK/@renoomokri

Read am in 4 mins

Nigeria goment don add 32 new names on top di three wey dem annouce during di week wey go be di kontri ambassadors.

Dis na according to statement wey di Special adviser to di president on Information and Strategy, Bayo Onanuga release.

According to di statement, di 32 pipo for di list dey divided into 15 career and 17 non-career ambassador roles and include di former INEC chairman Mahmud Yakubu and former presidential aide Reno Omokri.

Di statement call on di Senate President Godswill Akpabio make "di Senate do quick to consider and confam dem".

Di new nominees dey expected to collect posting for wia Nigeria get beta and strategic bilateral relations like China, India, South Korea, Canada, Mexico, di United Arab Emirates, Qatar, South Africa, Kenya, and to Permanent Missions such as the United Nations, UNESCO, and the African Union.

But list for dia posting go comot afta di Senate don confam dem even as President Tinubu tok say more nomiees for ambassadors still dey come.

Who dey di list of nominees?

According to di statement, qo of di pipo wey dey di list na women wit four for career ambassador list and six for non-career ambassadors.

Di list also get di names of former govnors, former minister, former commissioners and former senators dem among odas.

For none career ambassadors, dem include

  • Barrister Ogbonnaya Kalu - lawyer from Abia State
  • Reno Omokri - former presidential aide from Delta
  • Mahmud Yakubu - former chairman for di Independent National Electoral Commission (INEC)
  • Erelu Angela Adebayo - former Ekiti first lady
  • Ifeanyi Ugwuanyi - former Enugu governor
  • Tasiu Musa Maigari - former speaker for di Katsina House of Assembly
  • Yakubu N. Gambo - former Commissioner for Plateau State and di former deputy executive secretary for di Universal Basic Education Commission (UBEC)
  • Professor Nora Ladi Daduut - former senator from Plateau
  • Otunba Femi Pedro - former deputy governor of Lagos State
  • Chief Femi Fani-Kayode - former aviation minister from Osun State
  • Barrister Nkechi Linda Ufochukwu from Anambra State
  • Fatima Florence Ajimobi - former First Lady of OyoState
  • Lola Akande - former Lagos Commissioner
  • Grace Bent - former Adamawa Senator
  • Victor Okezie Ikpeazu - former governor of Abia
  • Senator Jimoh Ibrahim - businessman, lawyer and Senator from Ondo State
  • Ambassador Paul Oga Adikwu - former ambassador of Nigeria to the Holy See from Benue State.

Di career ambassadors and high commissioner-designates na:

  • Enebechi Monica Okwuchukwu (Abia)
  • Yakubu Nyaku Danladi(Taraba)
  • Miamuna Ibrahim Besto(Adamawa)
  • Musa Musa Abubakar (Kebbi)
  • Syndoph Paebi Endoni(Bayelsa)
  • Chima Geoffrey Lioma David(Ebonyi)
  • Mopelola Adeola-Ibrahim(Ogun)
  • Abimbola Samuel Reuben(Ondo)
  • Yvonne Ehinosen Odumah(Edo)
  • Hamza Mohammed Salau(Niger)
  • Ambassador Shehu Barde(Katsina)
  • Ambassador Ahmed Mohammed Monguno(Borno)
  • Ambassador Muhammad Saidu Dahiru(Kaduna)
  • Ambassador Olatunji Ahmed Sulu Gambari(Kwara)
  • Ambassador Wahab Adekola Akande(Osun)

Wetin be di difference between career and non-career ambassadors

Ambassadors na di highest-ranking diplomats wey dey represent dia kontri interest for outside dia kontri.

Di president na im dey appoint ambassadors to act as im representative for oda kontris. Dem dey always station dem for di embassy for any kontri dem send dem go.

Di ambassador work na to oversee all im kontri activities for any kontri e dey and to further strengthen foreign policy goals.

Di men and women wey dey serve as ambassadors fit be either "career" members of di Foreign Service or "non-career" political appointees.

Di career ambassadors dey trained for di work, dem go di school and don get plenty years of experience of working as diplomats.

Non-career ambassadors na political appointment. Di president fit appoint pesin as non-career ambassador maybe becos of im unique talent or expertise wey e go bring come di ambassadorial post no be because e get any training as ambassador.