Who be di pipo Tinubu nominate as ambassadors for US, UK and France

Ambassador Ayodele Oke, Retired Colonel Lateef Kayode Are, and Ambassador Amin Mohammed Dalhatu.

Wia dis foto come from, Nigeria Goment

Read am in 3 mins

Nigerian Presidnet Bola Tinubu don nominate non-career ambassadors to go three kontris, wey be di United States, di United Kingdon and Frace.

For statement wey di Special Adviser Information and Strategy to di President, Bayo Onanuga release, di three nominees na Ayodele Oke, Retired Colonel Lateef Kayode Are, and Amin Mohammed Dalhatu.

Dia full posting go come afta dem don pass through Senate Screening.

Retired Colonel Lateef Kayode Are don work for several goment parastatals ova di Lateef Kayode Are na Ambassador-designate.

According to di profile wey di presidency release, oga Are retired intelligence and national security expert wit ova 33 years of combined military and civilian intelligence service, including eight consecutive years as head of Nigeria domestic intelligence agency.

Dem born am for year 1955.

Lateef na retired Nigerian Army Colonel and former Director General, State Security Service.

E get Master Degree for International Law and Diplomacy from University of Lagos, Nigeria (1987).

E get im B.Sc. (wit First Class Honours) for Psychology from University of Ibadan, Nigeria (1980) wia e be di best graduating student: University Senate Prize, Faculty of Social Sciences Prize, Department of Psychology Prize.

Lateef go Nigerian Defence Academy (NDA), Regular Combatant Course 12 and become Commissioned 2nd Lieutenant of di Nigerian Army for December 1974 wia e dey among top 10 cadets.

For im military career, oga Lateef be commissioned 2nd Lieutenant of di Nigerian Army, later become Intelligence Officer of di Directorate of Military Intelligence.

Dem later promote go rank of Colonel bifor im compulsory retirement from Nigerian Army for 1993.

Oga Lateef also serve for some national positions:

From May 1999 – August 2007, e serve as Director General of Nigeria State Security Service (SSS). E become di longest-serving DG SSS for Nigerian history; e serve under Presidents Olusegun Obasanjo and Umaru Yar'Adua.

By 2010, dem appoint am as, Deputy National Security Adviser of di Federal Republic of Nigeria.

From 18 September 2010 reach 4 October 2010, a serve as acting National Security Adviser- as Interim appointment sake of di resignation of Gen. Aliyu Mohammed Gusau.

Ambassador Amin Mohammed Dalhatu na formermer ambassador wey serve as Nigeria ambassador to South Korea.

E bin first dey appointed for 2016 during President Buhari administration.

Ambassador Ayodele Oke na former Director General of di National Intelligence Agency (NIA).

Oga Oke wey bin study for Emory University for Atlanta, don also seve as Nigeria ambassador.

E bin serve for di Secretariat of di Commonwealth of Nations for London.