Wetin happun to di bandits as Nigeria secure release of over 70 kidnapped victims?

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/X
Nigerians dey demand for di arrest and prosecution of di jaguda pipo wey kidnap 25 schoolgirls from Government Girls Secondary School Maga, Kebbi State and di ones wey kidnap 38 worshippers Christ Apostolic Church, Eruku for Kwara state.
Dia demand dey come afta Nigeria govment announce di release of di kidnapped victims.
On Tuesday, 24 November, Nigeria President Bola Tinubu announce say all di schoolgirls jaguda pipo abduct from di girls school don regain freedom.
Na 17 November, pipo wey di govment call terrorists, storm di school for early mor-mor wit arms, kill two pipo and kidnap 25 students. Two girls later escape from dia captors.
Earlier, di 38 worshippers wey bandits kidnap from di church on 21 November, also regain freedom four days afta.
President Tinubu hail security forces for dia "swift response" to secure di release of di victims.
However, ova 200 school children wey terrorists kidnap from St Mary Primary and Secondary School for Papiri Niger state still dey for captivity, and govment say dem dey intensify efforts to secure dia release, dis na as 50 don already escape from di captors.

Wia dis foto come from, Kebbi StateGovernment
Di Nigerian leader, govnors of Kebbi and Kwara states no give full details on how dem take secure dia release and no mention on if dem make any arrest, and Nigerians dey kwesion why.
Meanwhile, for di wake of di kidnapping spree, President bin tok tough on di prosecution of pipo wey dey involved for di abduction.
"Dos wey threaten di peace and security of our nation go face di full weight of di law," e tok repeatedly.
Nigerians however dey worry as di tori of di release of di abductees no come wit tori say any perpetrator dey arrested or if di govment pay ransom.
One popular Nigerian musician, Folarin Falana wey pipo sabi as Falz kwesion how govment go conduct rescue operation and no tok anytin about arrest?
Anoda pesin wey call imsef Peacock on X tok say bandits no dey release captives out of goodwill, and no terrorist group dey simply "comply" wit polite requests.
E dey of di position say di govment quietly pay di bandits, and e say if dem continue to pay, kidnapping incidents go increase.
Wetin govment don tok on di release of di abductees

President Tinubu wey cancel im trip to South Africa for di G20 summit sake of di insecurity palava tok say di victims regain freedom from dia captors through di effort of di kontri security forces.
Since di incidents happun, different post on im official X account, show am dey meet wit heads of security and intelligence agencies.
"Currently, I dey for extended security meeting wit heads of our defence and intelligence apparatus including di Chief of Defence Staff, Chief of Army Staff, Inspector-General of Police, Director-General of di DSS, for di State House. We dey review di latest reports and dey take decisive actions to stabilise di affected areas and protect our citizens. I dey receive continuous briefings and don direct our security services to move wit speed, precision, and absolute resolve."
Kebbi state govnor Nasir Idris, following di release of di school girls tok say di govment no pay any ransom to secure dia release.
"As for us, Kebbi State govment no pay any ransom. And federal govment too no pay anytin as ransom."
For inside one exclusive interview wit BBC, Niger state govnor, Umar Bago confam say security forces don rescue 11 students of St. Mary's Catholic school.
E say joint operation of di military, police and local vigilantes rescue di students from one farm settlement and add say dem dey wit security agencies currently.
Di govnor no gree more details about di rescue operations.
As Nigerians on social media kwesion govment on how many kidnappers dem don arrest and negotiations dem reach wit dem, one tok-tok pesin to di President Sunday Dare tok say govment no dey ever disclose in full dat kain operation – na security mata, e add.
E say di ultimate goal na to free di captives and apprehend di terrorist.
"Di process of securing or freeing victims of kidnappings most times dey complicated and dey involve several steps and multiple security personnel, even local intelligence.
E give assurance say di perpetrators and kidnappers go soon dey prosecuted.
Di Special Adviser to President Tinubu on Information and Strategy, Bayo Onanuga for one television programme bin share small details on how di 38 worshippers bandits kidnap from Eruku, Kwara sbin regain dia freedom.
E say na di DSS plus di military bin secure dia release. "Di security operatives bin reach out to di kidnappers and demand di release of di victims, and dem obey bicos dem know di consequences of disobeying govment directives."
E explain say security forces no how dem take dey track these terrorists, but wetin dey stop dem sometimes na di risk of collateral damage.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP via Getty Images
On Tuesday night, one video bin go viral wey allegedly show di Kebbi schoolgirls for inside forest wit dia captors bifor dia release.
For inside di alleged video wey dem speak Hausa language, di girls bin siddon wit dia captors and dey follow di girls tok.
Di terrorists bin assure di girls say dem go return dem safely to dia parents.
Dem also say na through "peace talks wit big men" di girls take secure dia freedom, no be govment rescue dem.
"By di grace of God we go hand you ova through peace talks. Force no rescue you.How many jet fighters don come? So you see say govment no fit rescue you. Dem use peace talks in order to secure your release through talks wit big men" Di kidnappers tok for di video.
One security expert Ajayi Okasanmi wey follow BBC News Pidgin tok on di how di govment take secure di release of di abductees say regardless of di method of recovery, di most important thing na say dem dey safe and don reunite wit dia families.
E say Nigeria govment get di capacity to stop banditry if dem really wan do am. E say dem know di locations and sponsors of di bandits" but politics no dey sometimes allow dem.
On di method dem take secure di release of di abductees, Oga Okasanmi add say di consequences go be say di bandits go dey "bolder and unfazed" for dia kidnapping activities since dem know say govment as usual go deploy same non kinetic model of engagement to get di victims released.
E add say di pipo wey dey inolved no dey give goment correct advice on how to end banditry plus oda criminality, as e allege say bicos many pipo dey benefit from di business.










