Canada update list of unsafe states for Nigeria make dia citizens no travel go

Nigeria and Canada flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Canada govment don list more dan 20 states for Nigeria including Abuja, di kontri capital wey dem warn dia citizens say no dey safe for travel

For di latest travel advisory Canada release on dia website, di govment say make dia citizens avoid "all travels" to dis states sake of di "unpredictable security situation" wey dey all ova Nigeria.

Dis advisory dey come for di face of di recent spate of kidnapping incidents Nigeria witness recently.

For mid-November, three major kidnappings wey lead to di abduction of ova 300 pipo wey include school children and church worshippers bin hapun wey shake di kontri.

Even Nigeria President Bola Tinubu, cancel im trip go South Africa G20 summit to battle di security challenge for house.

Wit di effort of security agencies, some of di kidnapped victims don regain freedom.

Areas wia Canada advise against travel

Canada advise dia citizens to avoid all travels to north-western and north-eastern part of Nigeria.

  • Adamawa
  • Bauchi
  • Borno
  • Gombe
  • Jigawa
  • Kaduna
  • Kano
  • Katsina
  • Sokoto
  • Zamfara
  • Yobe

Di northcentral states of:

  • Plateau
  • Niger
  • Kogi

Niger Delta states of:

  • Abia
  • Akwa Ibom
  • Anambra
  • Bayelsa
  • Delta
  • Enugu
  • Imo
  • Rivers (excluding Port Harcourt, for Rivers State)

10 km of di border areas wit Cameroon, Niger, and northern Benin (between Benin and Kebbi state).

Although di advisory exclude Calabar and Lagos states, Canada govment, however advise dia citizens to exercise a high degree of caution for dis states.

Why Canada issue travel advisory for dis states?

According to di travel advisory for dia website, threat of terrorism, banditry and kidnapping plenty for di north-western and north-eastern states for Nigeria.

Dem add say criminal groups continue to dey active for dis regions.

Violent attacks wey involve gunfire and explosives also full di areas.

For di north-central states, dem highlight violent incidents wey include bomb attacks wey bin hapun for Plateau, Taraba, Niger and Kogi states.

Episodes of inter-communal and sectarian violence also dey occur for dis states, plus increase in kidnapping for Niger State according to di advisory.

Dem say di security situation for di Niger Delta region still dey fragile and unstable.

Regional and ethnic conflicts between militant groups dey hapun for di area and e don lead to incidents of violent crime and civil unrest.

Di advisory add say for dis region, militants dey often target foreigners, dem warn say make any of dia citizens wey choose to remain for di Niger Delta despite dis advisory, to dey extremely vigilant all di time.

For dia citizens wey dey Lagos State or dey plan to visit di state, di advisory warn say, "Crime levels dey high for Lagos, and violent crime, wey include assaults and armed attacks, don dey committed against foreign nationals and for di areas dem dey go."