Which Nigerian states dey affected as UK release list of unsafe place to travel go

Foto of traffic for Nigerian highway wit armed police officer and di UK flag

Wia dis foto come from, Olukayode Jaiyeola/NurPhoto via Getty Images

Read am in 4 mins

Di United Kingdom Foreign, Commonwealth, and Development Office (FCDO) don issue list of Nigerian states wey dem sama say e no dey safe to travel.

UK Foreign office say dem get 'high threat of terrorist attack globally wey dey affect UK interests and British nationals'.

Dem also add say some groups dey view UK and British nationals as targets.

Howeva, di UK foreign office say di advisory dey related to di different attacks and threats wey dey go on for Nigeria.

Bifor for October 2025, di UK Foreign Office bin add eight kontris to one list wey dey warn of di risk of methanol poisoning from fake or tainted alcoholic drinks- and Nigeria dey among di list.

Di advice bin come afta increase for di cases of serious sickness and death wey alcoholic drinks wey get methanol cause for popular overseas travel destinations.

'We go defeat terrorism'- Tinubu

Meanwhile, Nigeria President Bola Tinubu don hala say dem go defeat terrorism wey dey give di kontri serious security challenges.

President Tinubu say Nigerians go go bow to fear, say di "govment go defeat evri form of terrorism and secure evri part of di country."

Dis dey come in di light of di situation wia US President Donald Trump bin declare Nigeria as Country of Particular Concern (CPC).

"We get problems? Yes. We dey challenged by terrorism? Yes. But we go go defeat terrorism. We go overcome di CPC designation."

"Nigeria na one happy family, and we no go spare any effort until we eliminate all criminals comot from our society. We want make our friends help us as we step up our fight against terrorism, and we go eliminate am," President Tinubu tok during di last federal executive council meeting.

Areas wia FCDO advise against travel

Di UK foreign office list stae for di North-east, North-west, Southern parts of Nigeria as part of places wey make pipo take caution bifor dem travel go or make dem no go at all, if e no dey essential.

Di affected states include:

Borno, Yobe, Adamawa and Gombe State for North East dey among di states wey FCDO bin advise against all travel to.

States wey UK FCDO advise against unless e be essential travel include Bauchi.

For di North West, states wey UK FCDO advise against include Katsina and Zamfara State

While states wey dem warn against unless na essential travel include: Kaduna, Kano, Kebbi, Jigawa, Sokoto

For North Central Nigeria and di FCT, UK FCDO advise against travel to states like Niger, Kogi, Plateau, and Taraba- unless na essential travel.

Meanwhile, for di South East and South South of Nigeria, FCDO advise against all travel to di riverine areas.

States like Delta, Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom and Cross River states- dem dey among. While dose wey require essential travel na Abia State, non-riverine areas of Delta, Bayelsa, and Rivers, Anambra and Imo State.

Why di UK issue travel advisory for dose States

According to di FCDO, di reason why dem issue di travel advisory, especially to Bauchi state na sake of wetin dem describe as 'high and increasing threat from Boko Haram or Islamic State West Africa.'

Dem say di threats dey come for places of transportation, religious areas and gatherings.

"E fit get a high threat of kidnap and violent attacks. Intercommunal tensions fit lead to outbreaks of violence," FCDO write for dia website.

FCDO also add say regular military operations wey dey go on for Adamawa, Borno and Yobe states, for cause 'risk of retaliatory attacks.'

For di North West wey di UK don issue say make pioo no travel go places like Katsina and Zamfara, dem say na sake of banditry wahala.

Dem also say make pipo travel go places like Kaduna, Kano, Kebbi, Jigawa, Sokoto, unless na essential service.

FCDO say "banditry and violent attacks dey frequent and e get a high threat of kidnap."

For some oda states wey di UK issue advisory, e say na sake of "criminal and militant activity", especially for North-central states of Nigeria.

"Violent crime, wey often involve firearms don increase and spread from di outer suburbs to more central, wealthier areas of di city.

For South East and South South states, FCDO say "militant groups dey active across di Niger Delta region."

"Dem don carry out a number of attacks on oil and gas infrastructure. E get high risk of armed robbery, criminality and kidnap for di Niger Delta region."

Dem say part of why dem issue di advisory be say 'targeted attacks' don dey for roads, and securiti officials fit dey attacked too.

"Secessionist groups dey active for di south-east and attacks and violent clashes often dey occur wit di military and oda security forces."