Tinubu order security to block Kwara forests, two oda states

Nigeria President Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency

Read am in 4 mins

As part of im response to di recent kidnapping and attacks for Nigeria, President Bola Tinubu don order make di military prevent access of jaduga pipo into forests of di three states wia deadly attacks take place for di last one week.

President Tinubu make di announcement say make 'total security' dey for forests for Kwara state afta di recent kidnappings wey happun.

On Tuesday 18 November, 2025, jaguda pipo enta Christ Apostolic Church for Eruku community, Ekiti local goment area of Kwara state, north central Nigeria. Dem abduct about 38 worshippers while dem kill some.

Howeva, few days afta, di 38 worshippers wey jaguda pipo kidnap from di church bin regain freedom, according to di President.

Since dat time, Nigeria president don hold different security meetings wit security chiefs on how dem go take secure di affected areas.

According to Sunday Dare, wey be special adviser to President Tinubu, e say na di recent kidnappings and terrorists activities bin make di president give order say make di military cordon di forests.

"President Tinubu don direct di Air force to expand dia air surveillance across di innermost parts of di forests for Kwara state wia e believe say di terrorists dey hide."

Nigeria president Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency

According to oga Tinubu, di Air force gatz maintain 24 hours surveillance for di forests.

Two oda states, Kebbi and Niger state also dey part of wia President Tinubu order say make military begin do surveillance and make dem cordon.

Na on Saturday, 22 November 2025, authorities for Niger state northern Nigeria bin confam di kidnap of 315 school children for Saint Mary's School, wey be Catholic school for Papiri community for Agwara Local Government Area of Niger State.

Few days later, report come say 50 of di children don return from dia captors to "don reunite wit dia parents.", according to wetin di Christian Association of Nigeria announce.

All of dis don cause serious kasala as citizens of Nigeria dey call for di safe return of dose wey still dey di hand of di terrorists.

Na part of wetin make oga Tinubu order surveillance for di forests of di three states.

"Dem go maintain a 24 hour surveillance and link up wit di booths on di ground. Dis order equally apply to di Kebbi and Niger States axis wia many still dey expected to dey rescued."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Anoda attack in Kwara state?

We don see reports say anoda attack bin happun for Kwara state again, but dis time na for Isapa community for di Ekiti Local Government Area of Kwara State.

According to locals, di incident happun on Monday evening 24 November wia terrorists bin invade di town.

Isapa community na few distance from Eruku wia di bandits bin abduct worshippers.

According to reports, di bandits don abduct one pregnant woman, 10 children, and odas.

One local community media, Ekiti Kwara gazette report say local vigilantes bin face di bandits wen dem come attack Isapa community.

Dem say na around 7:00 and 8:00 p.m. di attackers bin come, but di vigilantes bin quickly mobilize diasef.

No report or update on di numbers of pipo wey di bandits bin abduct yet.

Dis oda attack dey come barely a week wen di jaguda pipo bin invade Eruku, a neighbouring community.

For all dis attacks, President Tinubu tok say im dey "depressed" about di recent terrorists activities plus di kidnap of di schoolgirls, kidnap of di Catholic school and di oda securiti issues wey di kontri dey face.