'We no pay ransom', Kebbi govnor tok as 24 schoolgirls bandits kidnap regain freedom

24 schoolgirls wey bandits kidnap during di attack for Government Girls Secondary School for Maga, Kebbi State, don regain freedom, di Nigerian presidency confam.
Dis dey inside one statement way special adviser to president Bayo Onanuga release on Tuesday.
E no clear how govment take secure di freedom of di girls but, di statement tok say President Bola Tinubu welcome di freed Kebbi schoolgirls for Abuja.
Oga Onanuga add say di president don charge security forces make dem rescue di ones wey still dey captivity.
E dey happun just hours afta Tinubu order security forces to block di forests for Kebbi state so military go fit carry out operations.
Terrorists attack di school early morning on November 17 and kidnap di girls, just few moments after military detachment comot from di premises.
Di Kebbi incident trigger some oda kidnappings for Eruku for Kwara State and Papiri for Niger State.
All 38 kidnapped victims for Eruku regain freedom on Sunday. Dat same day, di Niger State chairman of di Christian Association of Nigeria tok say 50 of di missing students of di Catholic School for Niger don dey found for their parents' homes.
Di statement add say President Tinubu praise di security agents for all di efforts dem make to secure freedom for all di victims wey terrorists carry.
E charge di security agents make dem put more effort to rescue di remaining students wey still dey held captive.
"I dey relieved say all di 24 girls don dey accounted for. Now, we must urgently put more boots for ground for vulnerable areas to stop further kidnapping incidents.
My govment go give all di assistance needed to achieve dis," President Tinubu tok.
'We no pay any ransom' - Govnor Idris
For im side Kebbi state govnor Nasir Idris also, also confirm say dem don rescue di schoolgirls and right now dem dey on dia way back to di state.
E tok dis one during one press conference inside Kebbi state govment house.
"We get news say di schoolgirls wey dem kidnap for Maga, dem don rescue dem and dem dey in good health."
"As we dey tok now, dem dey on dia way to Kebbi to reunite wit dia parents."
E add say no ransom money dey involved for di rescue of di schoolgirls.
"As for us, Kebbi State govment no pay any ransom. And federal govment too no pay anytin as ransom."
E still tok say dem don already send message make di parents of di girls come Kebbi State to reunite wit dia daughters.
"By tomorrow, we dey hope to reunite di children wit dia parents," govnor Idris tok.
E tank President Bola Tinubu and di security officers wey e say work very hard to make sure say dem recover di girls safely.










