US stop all asylum claim decision afta National Guard shooting

US President Donald Trump dey look as e dey tok wit US Army service members for call

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Yang Tian
    • Author, James FitzGerald
  • Read am in 3 mins

Di Trump administration don stop all asylum decisions afta di shooting of two National Guard soldiers for Washington DC, na wetin US Citizenship and Immigration Services (USCIS) director tok.

Joseph Edlow tok say di break go dey "until we fit make sure say every alien don pass vetting and screening to di highest level possible".

Dis decision come just few hours afta US President Donald Trump promise say e go "stop migration permanently" from all "third world kontris".

All dis immigration actions dey hapun afta Wednesday shooting, wey leave one soldier dead and anoda dey fight for im life, and officials don accuse one Afghan man say na im do am.

Even though di first decision target Afghans wey wan enter US, oda decisions don reach plenty oda pipo.

According to CBS News, wey be BBC partner for US, USCIS – wey be branch of Department of Homeland Security – don get order make dem no approve, no deny and no close asylum applications from pipo of any nationality.

CBS report say officers fit still work on asylum cases reach di point bifor decision, but dem no fit give final decision.

But we never sabi many details about di Friday directive.

Trump no tok which kontris go dey under di migration pause, and di move fit enter court as some pipo and UN agencies don already begin push back.

All dis Trump new decisions show say im dey strong on im stand against migrants for im second term as president.

Trump still dey try make mass deportation of illegal migrants, reduce number of refugees wey go enter US every year, and stop automatic citizenship for many pipo wey dem born for US land.

Afta Wednesday fatal attack, Trump administration first stop to give visas to Afghans through di same programme wey di shooting suspect use enter US, bifor dem later suspend all immigration requests from Afghans until review finish.

Den on Thursday, USCIS tok say dem go re-check green cards wey dem don give pipo wey come US from 19 kontris, but dem no mention Wednesday attack join.

Di agency refer to June proclamation wey include kontris like Afghanistan, Cuba, Haiti, Iran, Somalia and Venezuela. But dem no explain how di re-check go take hapun.

Later dat Thursday, Trump come promise say e go "stop all federal benefits and subsidies to non-citizens."

Wetin we call dis Video, Watch: Trump announce death of National Guard member Sarah Beckstrom

'Third-world kontris'

Trump blame refugees say na dem dey cause "social wahala for America" and e promise say e go remove "anybodi wey no be better asset" to US.

"Hundreds of thousands of refugees from Somalia don dey take over Minnesota wey bifore bin great state," e tok.

"I go permanently stop migration from all Third World kontris so dat US system go fit recover well."

Di word "Third World" na old term wey dem dey use for poor and developing kontris.

Earlier dis year, travel ban don already dey for pipo from 11 African and Asian kontris, including Afghanistan. For Trump first term, e also do travel ban for kontris wey na mostly Muslims dey.

UN don beg US make dem respect international agreements on asylum seekers, according to Reuters.

Trump reaction to di shooting na "blame migrants for wetin dem no do", na wetin Jeremy McKinney, President of American Immigration Lawyers Association tok.

E tell BBC World Service Newsday before Trump latest statement say dem never know di attacker motive, and say radicalisation or mental illness fit affect anybodi.

"Dis kind issue no dey look skin colour, no dey look nationality."

Suspect for DC shooting na Afghan

All dis govment announcements dey come afta officials tok say di suspect for di shooting, Rahmanullah Lakanwal, enter US for 2021.

E come under one programme wey give special immigration protection to Afghans wey work wit US forces after America comot from Afghanistan.

One former Afghan defence and security personnel tell CBS News say Mr Lakanwal bin dey part of one "Zero Unit" na one Afghan intelligence and paramilitary group wey work wit CIA.

US dey see Zero Units as one of di most respected security forces for inside Afghanistan.

Di current CIA director don confam say e bin work wit dem bifor.

According to one senior US official wey tok to CNN, US don screen and check am two times first wen e start work wit CIA, and later wen e travel enter US.

One friend wey sabi am from childhood tell New York Times say Mr Lakanwal begin get mental health wahala afta di kain work wey e do wit im unit.

Dem tok say Mr Lakanwal get asylum after Trump come back to office, after e apply for 2024.

But Homeland Security official tell CBS say e green card request - wey join wit di asylum still dey pending.

Dem arrest di suspect afta di attack, but dem tok say e no dey co-operate wit authorities.

Trump describe di incident wey 20-year-old Sarah Beckstrom take die as "act of terror".

E still tok say di second National Guard member, 24-year-old Andrew Wolfe, dey "fight for im life".

Wetin we call dis Video, FBI: Suspect get relationship wit 'partner forces' for Afghanistan