Wetin be sole administrator and who be Vice Admiral Ibok-Ete Ibas wey Tinubu appoint Administrator of Rivers State?

Ibok-Ete Ekwe Ibas

Wia dis foto come from, Ibok-Ete Ekwe Ibas

Read am in 6 mins

Nigeria President Bola Tinubu on Tuesday appoint Ibok-Ete Ekwe Ibas as administrator of Rivers afta im declare a state of emergency for di state.

E make di declaration for im nationwide broadcast on Tuesday 18 March.

Di president say im dey disturbed about di issues wey dey happun for Rivers State as di wahala neva end and efforts to calm di situation no dey yield any fruit.

President Tinubu bin invoke Section 305 (5) of di 1999 Constitution to make di declaration.

Di president suspend Govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Prof. Ngozi Odu for six month.

Oga presido also suspend members of di state House of Assembly for di same duration.

Who be sole administrator?

Sole administrator na concept wey di Nigeria military bin invent through military decree wen dem bin rule Nigeria at different times between 1970s to 1999 wen di kontri return to civilian rule.

During di military era, all di states for Nigeria bin get im own sole administrator.

So, who be sole administrator, which kain power im get and wetin bin im work?

Ogbonge Nigeria lawyer and Senior Advocate of Nigeria (SAN), Ebun Adegboruwa, say sole administrator mean say "one single pesin go combine all di powers of state give im sef, including legislative and executive powers.

"Dem go suspend di constitution, and di administration of dat state go solely depend on di decision of one single individual. Im no go follow due process, and nobody fit question in decision, or review am.

"For dis situation, all di rights of di pipo and di institutions for di state go dey suspended."

Adegboruwa say di purpose of imposing state of emergency na to allow di military to rule by dictatorship.

But for Tinubu broadcast wen e nominate di sole administrator for Rivers state after suspending Govnor Fubara, e say for dis case, di administrator no go make any new laws.

E go, however, dey free to formulate regulations as e go find say dey necessary to do im job, but such regulations go need to dey considered and approved by di Federal Executive Council and promulgated by di President for di state.

Although Nigerian states bin dey for di hands of sole administrators during military rule, one state bin experience am small afta di kontri return to democracy under former President Olusegun Obasanjo for 2004 and 2006.

Di former military Head of State, turn democratically elected president, bin suspend Plateau state Govnor, Josuha Dariye, and di state house of assembly, for six months, for May 2004, sake of ethnic clashes, come appoint Maj General Chris Alli (retd).

For October 2006, Obasanjo again suspend Ekiti State governor, Ayodele Fayose, and im state house of assembly, come appoint Brigadier General Adetunji Olurin (retd) as administrator.

But di kontri Supreme Court bin rule against Obasanjo decision as illegal, unto say di president no get dat kain power according to di Nigeria Constitution.

Who be Ibok-Ete Ekwe Ibas?

Ibok-Ete Ekwe Ibas na retired Nigerian Navy Vice Admiral, wey be di 22nd Chief of Naval Staff (CNS) of di Nigerian Navy from 2015 to 2021.

Dem born am on 27 September 1960.

Na for Nko, Cross River State, south-south Nigeria dem born am and e join di Nigerian Defence Academy as a member of 26 Regular Course on 20 June 1979 and commissioned sub-lieutenant on 1 January 1983.

E attend Nko Primary School, Nko, for 1966 and complete am for Big Qua Primary School, Calabar for 1971. E kon proceed to Hope Waddell Training Institute Calabar from 1972 to 1976.

Between 1977 and 1979, e attend School of Basic Studies Ogoja bifor e go di Nigerian Defence Academy for 1979.

Military courses wey im attend and qualifications

Ibas don attend several military courses at home and abroad, including di Sub-Lieutenant Technical Course at INS Venduruthy for India from April 1983 to May 1984 and Primary Pilot Training for 301 Primary Flying Training School at Nigerian Airforce Base for Kaduna from April 1986 to October 1987.

E proceed to di Armed Forces Command and Staff College, Jaji, Kaduna, for January 1990 and complete di Junior Staff Course for June of di same year.

For July 1992, e report at di Amphibious Warfare School of di United States Marine Corps University for Quantico, Virginia, US, and graduate wit diploma in amphibious warfare for May 1993.

For February 1994, Ibas commence di Officers Long Course specialising in underwater warfare for di Underwater Warfare School, NNS Quorra, and complete am for February 1995.

From August 1996 to July 1997, e return to di prestigious Armed Forces Command and Staff College Jaji, wia e complete di Senior Staff Course wit excellent grades.

E also be alumnus of di National Defence College, Islamabad, Pakistan, as e attend di National Defence Course from August 2005 to June 2006.

In addition, e hold a master's degree in Defence and Strategic Studies from Quaid-i-Azam University for Islamabad, Pakistan.

Military appointments

Ibas don hold many appointments for di Nigerian Navy.

As a midshipman, e serve on board NNS Ruwan Yaro, NNS Obuma and NNS Aradu.

E later serve on board NNS Ayam and NNS Ekpe as a watch keeping officer afta e bin dey commissioned as sub-lieutenant.

Ibas later become di executive officer of NNS Siri, NNS Ekun and NNS Ambe between July 1993 and August 1996 as lieutenant commander.

E bin serve as di commanding officer of di Nigerian Navy Underwater Warfare School from August 1997 to September 1998 and afta dat, e bin serve as di commanding officer of di Forward Operating Base Ibaka from September 1998 to June 2000.

Due to im outstanding performance on di Senior Staff Course, dem appoint am as directing staff at di Armed Forces Command and Staff College, Jaji, from June 2000 to June 2002.

E later return to di college for January 2009 as di director of di Department of Maritime Warfare - e hold dis position until November 2010.

Im last work for di college na as deputy commandant from January to February 2014.

Ibas bin also serve as di naval provost marshal from April 2003 to June 2004 and later serve as di principal staff officer to di then CNS from June 2004 to July 2005.

E also bin serve as di command operations officer for di Headquarters Western Naval Command, Lagos, from June to December 2006, and from December 2006 to January 2009.

Ibas also bin serve as di commander of di Naval Air Base, Ojo. Di senior officer bin later dey appointed chief staff officer at di Headquarters, Naval Training Command, Lagos, from September 2010 to March 2011.

In recognition of im versatility in staff duties and administration, di senior officer kon dey appointed to di Naval Headquarters, first as di chief of administration from March 2011 to February 2012 and later as di Navy Secretary from February 2012 to January 2013.

After dat, e become di flag officer commanding Western Naval Command from January 2013 to January 2014.

E kon dey appointed as chief of logistics for February 2014 and then di GMD/CEO of Nigerian Navy Holdings Limited for December of di same year. Dis na di appointment e hold until im appointment as di 22nd Chief of Naval Staff on 13 July 2015.

On 18 March 2025, President Bola Tinubu appoint am as di Administrator of Rivers, south-south Nigeria, afta im declare state of emergency for di state.

Di Administrator of Rivers State dey married to Theresa Ibas and dem get three children togeda.