Wetin we know about di trans-Niger pipeline explosion for Rivers State

Wia dis foto come from, YEAC-Nigeria
Police dey question two pipo for di explosion wey happun for Trans Niger Delta Pipeline for Rivers State on Monday night.
Di Trans Niger Pipeline na major pipeline wey dey transport crude from onshore oilfields to Bonny export terminal. E get capacity of around 450,000 barrels per day.
Authorities no really give details of who di pipo be but dem say na part of dia efforts to find out any potential act of sabotage.
''Di situation dey under dia control, no threat to residents or di environment," police statement read.
Dis explosion happun for Kpor and Bodo communities wia shell dey operate di Trans Niger Delta Pipeline, d statement add.
Residents say dem hear loud blast followed by intense heat and flames.
Videos from social media on Tuesday show thick black smoke and fire wey dey spread on top water.
All dis happun a day afta di state House of Assembly begin impeachment process for Govnor SiminalayiFubara.
End of Di one wey oda users dey read well well
No group don claim responsibility for dis incident.
Militant groups bin don threaten to attack oil installations in response to federal goment withholding of Rivers State allocation sake of di ongoing political crisis.
Production of more dan 450,000 barrels of crude oil dey at risk
Dis explosion for Trans Niger pipeline fit affect di production of more dan 450, 000 barrels of crude oil.
Di pipeline na one of Nigeria biggest oil pipelines.
Na major crude oil transportation pipeline for Niger Delta region, wia di kontri oil reserves boku.
The TNP na important infrastructure for transporting crude oil from oilfields for Niger Delta to export terminals, primarily di Bonny Export Terminal.
Wit ova 450,000 barrels of crude oil per day capacity, na significant contributor to Nigeria oil production and export.
Nigeria na Africa largest producer of crude oil, and di 15th biggest for di world.
Na oil dey sustain Nigeria economy. Oil dey account for nearly 6% of GDP output and ova 90% of all export value.














