Multichoice announce shut down of Showmax streaming platform

Wia dis foto come from, Showmax streamer
Multichoice don annouce say dem dey phase out dia streaming service wey dem dey call Showmax.
For press release wey dem drop on Thursday, dem reveal say di reason behind di closing of dat streaming network, na money or as dem tok am, "di plenti yearly losses wey di Showmax business don get dey unsustainable".
Dem add say, "di decision to phase out Showmax show our focus to building sustainable, competitive business for di long term for global streaming environment wey just continue to dey grow dey go."
Dis na as dem tok say dis move no go affect any of di staff wey dey currently work for Showmax as dem dey go through di transition.
Di statement tok say di "decision bin dey made by di Showmax Board of Directors and show di continued focus of MultiChoice wey be CANAL+ company about financial discipline and investment optimization, for di highly competitive and captial intensice global streaming environment".
Howeva dem add for di statement say dis decision no mean say dem don dump evritin about streaming o!
Dem tok say "streaming still be strategic pillar of di Group plan for MultiChoice. To stop showmax go let us to streamline efforts and optimise di customer expecrience for our core output."
Although dem neva drop date wen be say ShowMax go shut off for di last time, dme add say for di mata of streaming, "we dey invest well-well for DStv Stream."

Wia dis foto come from, Piotr Swat/SOPA Images/LightRocket via Getty Images
Multichoice call dem self say dem be global media and entertainment company wey be part of CANAL+ SA dey provide mostly cable services around Africa through dia DSTV and GOTV cable plans.
But na for 2015, di streaming platform start from South Africa.
E dey operate for 44 sub-Saharan kontris and produce original series for three main markets: South Africa, Nigeria and Kenya.
Di streaming broadcaster go unveil dia first original series from Ethiopia and Tanzania later dis year.
Unlike international streaming companies wey dey operate di African branches of companies wey base abroad, Showmax dey rooted for African life and culture.
Dem tok say dia vison na to offer beta collavo of original African content, first and exclusive international series among odas.
For 2022, nine out of ten most streamed titles by Showmax for Ghana all dey produced for Africa. For Kenya, South Africa and Nigeria, di majority of di top 10 most streamed titles also dey produced for Africa.
For January, 2024, dem announce plans to offer mobile only product make pipo fit use to watch di premier League.
But streaming technology fit face challenges for African markets.
"E no too get many plans, and one single movie dey consume plenti data," Ivan Biljan, head of demand generation for UniqCast, one video streaming company tok.
"If you need pay by di megabyte, you constantly dey under pressure.
According to Biljan, di lack of affordable and reliable broadband access and internet piracy also be serious wahala for companies wey wan sell video on demand.
However, he dey hopeful about di future of streaming on di continent:
"I tink say di future dey bright for Africa sake of say e get plenti tins wey oda markets, like Europe and America, no get. For years to come, Africa go get 400 to 500 million new custom








