UK go offer families wey dia asylum fail up to £40k to comot dia kontri

Wia dis foto come from, PA Media
- Author, Joshua Nevett
- Role, Political reporter
- Author, Paul Seddon
- Role, Political reporter
- Read am in 6 mins
UK govment go offer families of failed asylum seekers up to £40,000 to comot di UK under one new pilot wey di Home Secretary Shabana Mahmood announce.
Mahmood tok say govment go use force remove failed asylum seekers if dem no accept di "incentive payments" of up to £10,000 per person, wey dem limit at four per family, within seven days.
Di scheme dey expected to target about 150 families wey dey live for taxpayer-funded accommodation.
Di Home Office estimate say dem fit save govment £20m if e dey successful.
Mahmood unveil di scheme as she try make case on why Labour restrict support to some asylum seekers for inside one speech to one left-leaning think tank on Thursday, 5 March.
UK govment already dey run one voluntary returns programme wey dey provide up to £3,000 in financial support to eligible asylum seekers wey choose to leave di UK.
Mahmood tok say housing a family of three for asylum accommodation dey cost up to £158,000 per year.
Di Home secretary tok say UK govment wan offer "increased incentive payment" wey go represent one "ogbonge saving to di taxpayer", wey look like di reforms dem introduce for Denmark.
"Now we dey consult on how di removal of families wit children must take place for manner wey go dey humane and effective.
"For too long, families wey don fail for dia claims know say we no dey enforce our rules, wey create a perverse incentive to make Channel crossing wit children for inside small boat."
For her speech, Mahmood also announce say dem go throw out of government-funded accommodation asylum seekers wey break di law, or wey work illegally. Di asylum seekers go also dia support payments.
Di Home secretary dey plan to remove di current legal duty to guarantee support to dos wey dey at risk of destitution wey dey await asylum decision.
Di Conservatives say make Mahmood go "much further", while di Green Party don accuse her of echoing di rhetoric of di far right.
Di home secretary bin don already unveil several measures to toughen up di migration system ahead of her speech for di Institute for Public Policy Research (IPPR) on Thursday.
Di measures include making refugee status temporary and stopping pipo from four countries to apply for study visas.
Her speech na to pitch to pipo for her party wey no too dey sure of her approach. Mahmood repeat am say her changes go make di asylum system "compassionate but controlled".
Some left-wing Labour MPs dey call for di govment to change dia approach on migration for di wake of di party defeat to di Greens for last week by-election for Gorton and Denton.
About 100 Labour MPs don sign one private letter to di home secretary and express dia concerns about her plans to make refugee status temporary.
Tony Vaughan, di Labour MP for Folkestone and Hythe for di letter argue say e go "undermine di govment integration and cohesion objectives" by "leaving open di possibility of forced removal of settled refugees even afta 20 years of lawful residence".
But for her speech, Mahmood argue say "restoring order and control for our border no be betrayal of Labour values, na an embodiment of dem".
'Unacceptable'
Under di plans, dem go replace di current statutory legal duty wey dey guarantee support and accommodation to asylum seekers wey dey at risk of destitution wit a more conditional approach.
Home Office tok say di changes wey go take effect for June, go limit accommodation and support to "dos wey genuinely need am", although dem neva set out in detail how dis go work.
Di legislation wey di Home Office go publish on Thursday go echo di approach wey Denmark take.
Dem fit deny asylum seekers wey get right to work further assistance under di plans, as dem go see am as pesin wey now get di means to support themselves.
Di Home Office tok say dis go also include dos wey lodge asylum claim afta de menta di kontri wit visa wey give dem right to employment.
Govment fit also ask dos wey get assets to contribute to di cost of dia accommodation, as ministers bin previously suggest say dem go treat cars and e-bikes as assets.
E neva dey clear how many pipo go dey affected by dis change, as di department no disclose how many asylum seekers dey able to work for UK.
For inside one policy document last November, di Home Office say currently, "criminality no exclude asylum seeker from receiving state support".
Di document say: "Dis dey unacceptable, and we go sanction those wey take advantage of our generosity. Dis go extend beyond do wey break law and include dos wey refuse to relocate to a different accommodation site and dos wey dey spoil things for dia accommodation setting."
'Cheap soundbites'
Mahmood bin use di speech to step up her attacks on di Greens, as she accuse di party say dem wan create "a world without borders" and say dem dey call for "di most expensive and expansive migration policies anywhere in di world".
On dia website, diGreen Party say in govment dem go "treat all migrants as if dem be citizens" and "scata di Home Office".
One Green tok-tok pesin say di home secretary "deliberately dey misrepresent Green Party Policy and dey reduce am to cheap soundbites".
Di Green Party tok say dem recognise "di great contribution wey migrants and refugees dey make to British society and we wan see policy wey go treat everyone wit dignity rather dan treating dem harshly for political gain".
Mahmood also criticise Reform UK, wey she tok say go oversee a "nightmare" of "pulling up di drawbridge and shutting out di world" if di party dey for govment.
Reform UK home affairs tok-tok pesin Zia Yusuf tok say Labour dey "take British pipo for mugs," and add say: "Thousands more don cross di Channel illegally already dis year".
Chris Philp MP, shadow home secretary, say Labour "suppose put foreign criminals on top plane to dia kontri, no be to put dem on British streets".
Di Refugee Council, one charity, warn say di plans fit lead to rise in rough sleeping, shifting costs to local councils and di NHS.
Imran Hussain, dia director of external affairs, tok say speeding up slow decision-making na "far more effective" way to reduce costs.
Just ova107,003 pipo for UK bin dey receive taxpayer-funded asylum support for di end of last year, including around 30,000 for hotels.
Di govment don promise to phase out di use of hotels by 2029, and dey plan to move pipo to lower-cost large sites wey include former military bases.






