How many matches remain for Arsenal to lift di Premier League title afta over 20 years?

Wia dis foto come from, Michael Mayhew/Sportsphoto/Allstar via Getty Images
Wit evri Matchday, di English Premier League dey move closer to di end of di season.
Di 2025/2026 Premier League season bin start for August, 2025 and na League champions Liverpool bin open di season on Friday 15 August wit home game against Bournemouth.
For di opening weekend of di season, Arsenal and Manchester United bin clash for di Emirates stadium Sunday 17 August while Pep Guardiola team Manchester City bin face Wolves..
For di league to conclude, di teams go play 380 games ova 33 weekends, and according to di timetable, di league go end for Sunday, 24 May 2026.
How many matches remain for Arsenal to win di league?
Na seven matches remain for Arsenal to play wey go decide if dem go win di league title or not.
Dia next match na on Saturday 11 April, and dem go play for di Emirates against AFC Bournemouth .
On 19 April, di gunners get ogbonge match wit dia rivals Manchester City for di Etihad stadium.
Dia last match for di season na against Crystal Palace away from home on Sunday May 24.
Di question na how many points Arsenal fit get from dis remaining seven matches? Na only den e go dey clear if rivals Manchester City or oda clubs go catch up wit dem or not.
How many matches Manchester City get for season to end?
Manchester City dey press Arsenal neck for di race to win din league title. Mancheter City currently dey second for di table even though dem play 2-2 draw wit Nottingham Forest on Wednesday night.
City still get eight matches to play before di season go end. Dia next match na against West Ham away from home on Saturday March 14, dem go play Chelsea on April 12.
Dia last match for di season na against Aston Villa for di Etihad on May 24.
Di race dey tight for Manchester City as dem dey try to catch up and also overtake Arsenal as di title race continue.
Premier League Table
Arsenal still dey lead di Premier League afta di matches wey dem play on Wednesday night. Dem get a total of 67 points afta 30 matches.
Manchester City get 60 points afta dem play 29 matches while Manchester United dey third wit 51 points afta dem play 29 matches.
See di full Premier League table.

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport
Arsenal fans and supporters dey hope say dis na dia chance to win di league title wey dem last win for di 2003/2004 season over 20 years ago and na Arsene Wenger win am.
Arsenal don come close to win di tile many times but dem dey use dia hand spoil dia games.
Arsenal finish second three times back to back. Dem bin finish as runners-up for di 2024/2025 season wey Liverpool win.
Dem finish second for di 2023/2024 season wey Manchester City win. Dem finish behind Manchester City again for di 2022/2023 season.
For di 2015/2016 season Arsenal finish second behind Leicester City. Di gunners finish second again behind Chelsea for di 2004/2005 season.









