Who be Tom Edozie, di 19-year-old Wolves player wey pour sand for Arsenal title race

Tom celebrating im goal against Arsenal

Wia dis foto come from, Visionhaus/Getty Images

Read am in 4 mins

Tom Edozie na di young debut player wey pour sand inside Arsenal title hope wit im late equaliser on Wednesday night Premier League game.

Arsenal blow away dia two-goal lead to draw against di League bottom club Wolves, ending di game 2-2 at stoppage time.

Dis don raise di kwesion of weda Arsenal dey mentally ready to end dia 22-year wait to become champions.

For di first time really dis season, di title race dey completely for di control of Mikel Arteta and im players, but dem allow Wolves wey dey last of EPL table to blow am.

Na Tom Edozie fire one long shot into di net afta afta goalkeeper, Raya bin first push am, but e enta di net.

Arsenal bin dey lead wit two goals until Wolves drop in dia first goal and later, dem equalise for stoppage time.

Dat Tom Edozie goal stop Arsenal from going seven points clear for di top of di Premier League table. Instead dem get five points above Manchester City.

One big kwesion na who be dis young 19-year-old player, Tom Edozie, wey dash Arsenal hope for Premier League title.

Who be Tom Edozie

Tom Edozie na 19-years-old Wolves player wey bin dey play for di U-23 and U-21 team, bifor e make im debut for di club against Arsenal.

Edozie join Wolves as 16-year-old afta e spend time for di XYZ Football Academy for London.

E sign im first professional contract for 2024. And e dey regular for di under-21 side.

Di academy dey help players wey neva secure scholarships, but dem don help more dan 40 players progress into full-time football - including Tom Edozie.

Tom na di broda of Southampton winger Sam Edozie and e don dey train wit di first team for about two weeks.

"E impress us wit some really nice moments, e be gifted player, but we still dey learn about am ourselves," Wolves boss Rob Edwards tok.

Tom enta as substitute for Wolves and play just six minutes bifor im luck shine for di stoppage time.

Wetin be Arsenal hope to win EPL and who fit top table

Pep Guardiola Man City get one game at hand wey dem neva play and Arsenal gatz travel to Etihad stadium on 18 April to go face City.

While Arsenal dey lead di Premier League table wit 58 points, Man City dey second wit 53 points. Dis na wia di mata dey as di points dey close.

If Manchester City wit dia five points behind Arsenal for second place win all of dia remaining 12 games, including di home game against Arsenal, dem go finish first.

And If Arsenal Win all dia remaining matches including di one against Man City, dem fit also top the league table at di end of di season.

Arsenal don finish three successive runners-up and two of dem na behind Pep Guardiola Man City men.

Now, afta losing points in successive draws against Brentford and Wolves, danger dey for di Gunners and dis bring back di reminder of how dem always finish for second position for di table.

Di draw wit Wolves na damaging one for Mikel Arteta men as dem continue dia search for first league title since 2004.

BBC News Pidgin follow Sport analyst Alonge Richard on wetin be Arsenal chance of winning di league dis season and wetin dem need do to remain ontop of di table.

Oga Richard say Arsenal destiny dey dia hand wit di remaining games wey dem get to play.

"Dem only get one tin to do if dem wan win di League, dat na to win all dia games. No wait for anyone to help you win di league."

"If dem go win, make Arteta stop im approach to struggle to win wen e get di potential to win comfortably."

Di analyst say Arsenal get good defence wey dey make am difficult for opposition to break through, but wen dem dey lead, dem dey play wit struggle to win.

E say Arsenal get good chance to win di League if dem win all dia remaining games, to block Man City from overtaking dem.

E analyse how Arsenal boss Arteta no dey play some players for di correct wings, and na dia di wahala to score goals dey come from.

Oga Richard add say make Arteta give di players freedom to play from dia correct position, and no be to dey play like robots.

"You no fit buy a player like Eze and you dey play Saka for hole, na winger e be, put am for im position."

"Give di players freedom, no be to dey find set piece wey be only corner."