Nigeria don qualify for World Cup 2026?

Line up of Nigeria Super Eagles for dia match against Rwanda for Uyo, Akwa Ibom State, South-South, Nigeria

Wia dis foto come from, Adekunle Ajayi/NurPhoto via Getty Images)

Read am in 2 mins

Nigeria Super Eagles performance on Tuesday for di 2026 Fifa World Cup qualifier against Benin dey make pipo ask weda dem don qualify or not.

Eric Chelle team wire Gernot Rohr side 4-0 to qualify for di play-offs wey be di next round of qualifiers.

Nigeria bin need three goals but dem score four goals wey carry dem from third position for di group to second place wit 17 points behind leaders, South Africa wey qualify wit 18 points.

So all di best second placed teams wey pipo also know as best losers from di Group Stage qualify for di play-offs.

Which kontris finish as best second

DR Congo for Group B wit 22 points.

Nigeria qualify for di play-offs wit 17 points.

Cameroon qualify for Group D wit 19 points.

Gabon progress to di play-offs wit 25 points.

How Caf select di kontris wey qualify for playoff

E get some kontris wey get higher points for di table, but at di end dem no qualify for di play-offs.

Confederation of African Football [Caf] bin bring out letter to notify teams on how dem go select teams for di playoffs.

According to di letter, Caf say dem deduct points wey each second placed kontri get from di bottom kontris for di Group.

So afta Caf deduct di point

Gabon get 19 points from dia original 25 points

DR Congo 16 points from 22

Cameroon 15 points from 19

Nigeria 15 points from 17

For di African play-offs e go be Gabon vs Nigeria, Cameroon vs DR Congo

How dis kontris go qualify for World Cup

To qualify for Play-offs no mean say dis kontris don get automatic ticket to di World Cup.

For dis kontris to make progress, dem go play each oda for di African play-offs first wey go hapun for Morocco for November.

Any of dis four teams wey win for Morocco go qualify for anoda intercontinental tournament wey six teams go play.

Na for Guadalaja and Monterrey, Mexico dem go play di tournament for March next year.

Di two teams wey go win for dis intercontinental tournament wey go feature di winner of di African playoff go face di winners from Bolivia, New Caledonia and two teams from Central America, and one from Asia.

Na afta dis process dem go qualify for di 2026 Fifa World Cup finals wey USA, Canada and Mexico go host di expanded edition of di World Cup.