Champions League table, results, fixtures... Arsenal end Bayern unbeaten run, Liverpool crisis continue

Wia dis foto come from, Julian Finney - UEFA/UEFA via Getty Images
Arsenal FC deliver dia best performance so far dis season wen dem win Bayern Munich 3-1 for di Uefa Champions League on Wednesday night.
Dis na Bayern team wey don win almost all dia matches for all competitions dis season - except one wey dem draw.
Mikel Arteta boys shine like bright stars as goals from Jurrien Timber, Noni Madueke and Gabriel Martinelli give dem di Victory and make Arsenal di ogbonge leader of di Champions League table.
On di oda hand, Vincent Kompany and im boys who bin dey top of di table sake of goal difference, chop dia first 'L' of di season and come down to third.
For di oda games, Liverpool continue dia terrible form as dem lose 4-1 for dia home against PSV Eindhoven.
Dis na Liverpool nineth defeat out of dia last 12 matches, and e don really put Arne Slot unda pressure say im job fit dey on di line.
PSG of France sama Tottenham Hotspur 5-3 to climb to number two for di UCL table, but Spurs coach Thomas Frank say im dey proud of im boys.
Real Madrid travel to Greece to face Olympiacos, and Kylian Mbappe take matters for im own hand as e score all di goals wey Madrid take win 4-3.
Atletico Madrid also dash Inter Milan dia first 'L' wit goals from Jose Maria Gimenez and Julian Alvarez.
See all di results for Wednesday UCL matches:

Wia dis foto come from, BBC Sport
Tuesday 25 Nov - results
On Tuesday, di result of di night na for di match between Chelsea and Barcelona, wey many tok say e go be di clash of di brilliant teenagers Estevao Willian and Lamine Yamal.
Di two young players dey among di most talented football palyers for di world right now and Tuesday match present dem di opportunity to play against each oda.
Howeva, di Brazilian Estevao na im shine bright for di encounter as e score one of di goals wey Chelsea take win 10-man Barca 3-0 for Stamford Bridge.
Both players dey 18 years old, but Lamine Yamal get more experience as e breakout since wen e dey 16.
Tuesday clash don make many pipo dey tok say Yamal and Estevao fit be di next Cristiano Ronaldo and Lionel Messi, but Chelsea Coach Enzo Maresca say e dey to early to compare.
"Im (Estevao) and Lamine still dey veri young, so if you start talking about Messi and Ronaldo - e go be too much pressure," Maresca tok afta di game.
Estevao imsef describe di match as "di best moment of my career so far".
For di oda games, Manchester City lose to Bayer Leverkusen 2-0, for match wia sabi pipo tok say Pep Guardiola get wetin e deserve as e bin underestimate di German side.
Guardiola imsef agree say im no try as e make 10 changes for im starting line-up.
"I get to accept am. If we win e for no be problem, so I get to accept am say maybe di changes dey too much," Guardiola tok.
Dat match na di 100th Champions League game wey Guardiola carry Man City play, but e no end well for am.
Also, Newcastle too chop big 'L' for dia match against Olympique Marseille of France, as dem go down 2-1 sake of two good goals by Pierre-Emerick Aubameyang.
See all di results for Tuesday, 25 November 2025:

Wia dis foto come from, BBC Sport
Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wia dis foto come from, BBC Sport









