Champions league results: Arsenal top table afta week six

Noni Madueke wear Arsenal red jersey and white shorts wit red stripes, Erling Haaland wear Mancheter City green jersey on dark green shorts a e raise im hand to celebrate goal, Dominik Szoboszlai wear Liverpool red jersey.

Wia dis foto come from, Stuart MacFarlane/Arsenal FC via Getty Images) UEFA, Nur Photo via Getty Images

Wetin we call dis foto, Noni Madueke, Erling Haaland, Dominik Szoboszlai
Read am in 3 mins

Arsenal dey ontop of di Champions League afta match day six. Di Premier League team show Belgian side Club Brugge pepper afta dem sama Club Brugge 3-0 for away from home.

Noni Madueke score two goals den Gabrielle Martinelli score di third goal.

Arsenal Manager, Mikel Arteta describe Noni Madueke goal as "an unbelievable goal," Arteta said.

"Wen you tok about individual quality and magic moments, na im be dis"

Arsenal wey just dey come back from dia 2-0 los to Aston Villa ova di weekend show class against di Belgian club.

Anoda Premier League club Manchester City beat 15 - time Cup winners Real Madrid 2-1 for dia house for di Bernabeu.

Newcastle too no slack, dem play 2-2 draw wit German side Bayer Leverkusen.

On Tuesday Italian side Atalanta beat Chelsea 2-1 while Liverpool lose to Inter Milan 1-0

See full results

Graphics wey dey show Champions League results

Wia dis foto come from, BBC Sport

Arsenal balance ontop of di Champions Leagie table wit 18 point afta six matches.

Di Gunners use three points pass Bayern Munich wey dey second for di table wit 15 points.

Paris Saint Germain, Manchester City and Atalanta get 13 points each.

Inter Milan, Real Madrid, Atletico Madrid and Liverpool get 12 points each while Borrusia Dortmund wey get 11 point complete di top 10.

Champions League table afta week 6

Graphics wey dey show Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Graphics wey dey show Champions League table

Tottenham, Newcastle, Chelsea and Barcelona dey for di second half of di table wit 10 and 11 points.

Bayer Leverkusen complete di top 20.

Graphics wey dey show Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Graphics wey dey show Champions League table
Graphics wey dey show Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Graphics wey dey show Champions League table
Graphics wey dey show Champions League table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Graphics wey dey show Champions League table

Plenti matches still dey to play for dis Group phase and di table go continue to change.