World Cup draw: Ghana go face England while South Africa go jam Mexico for di 2026 tournament

Fifa president gesture in front of di trophy. E hold card for hand and wireless mike dey im ear.

Wia dis foto come from, Jim Watson/Getty Images

Read am in 2 mins

Fifa don conduct di draws for di 2026 World Cup.

South Africa go face Mexico, South Korea and di winner of di Uefa playoff D.

Ghana dey Group L and dem go jam England, Croatia and Panama.

Oda big names for world football like Brazil go face Scotland, Morocco.

Africa giants Egypt get Belgium to deal wit, Senegal go battle 2018 Champions France.

Dis na di first-ever 48-team World Cup and na Canada, Mexico and di United States go host am between 11 June and 19 July 2026.

Fifa expand di World Cup to give oda kontris chance to qualify and also participate for di tournament wey dey hapun evri four years.

World Cup 2026 draw in full

Group A: Mexico, South Africa, South Korea, Winner of Uefa play-off D*

Group B: Canada, Winner of Uefa play-off A*, Qatar, Switzerland

Group C: Brazil, Morocco, Haiti, Scotland

Group D: USA, Paraguay, Australia, Winner of Uefa play-off C*

Group E: Germany, Curacao, Ivory Coast, Ecuador

Group F: Netherlands, Japan, Winner of Uefa play-off B*, Tunisia

Group G: Belgium, Egypt, Iran, New Zealand

Group H: Spain, Cape Verde, Saudi Arabia, Uruguay

Group I: France, Senegal, Winner of Fifa play-off 2*, Norway

Group J: Argentina, Algeria, Austria, Jordan

Group K: Portugal, Winner of Fifa play-off 1*, Uzbekistan, Colombia

Group L: England, Croatia, Ghana, Panama

Play-offs

Una remember say play-offs go still hapun for kontris to still qualify for di Fifa World Cup.

Dis na di list of play-offs wey go hapun later and di winners go complete di remaining Groups.

*Uefa play-off A: Italy, Wales, Bosnia-Herzegovina or Northern Ireland

*Uefa play-off B: Ukraine, Poland, Albania or Sweden

*Uefa play-off C: Turkey, Slovakia, Kosovo or Romania

*Uefa play-off D: Denmark, Czech Republic, Republic of Ireland or North Macedonia

*Fifa play-off 1: DR Congo, Jamaica or New Caledonia

*Fifa play-off 2: Iraq, Bolivia or Suriname