'I don really live my dream' - Nigeria captain Troost-Ekong retire from international football

Wia dis foto come from, Photo by PHILL MAGAKOE / AFP) (Photo by PHILL MAGAKOE/AFP via Getty Images)
Nigeria Super Eagles captain William Troost-Ekong don retire from international football.
Di defender wey pipo bin sabi well-well as one of di 'oyibo wall' announce im retirement for in official Instagram page.
Troost say "playing for Nigeria na di greatest privilege of my life. Di journey fit end hia, but my support no go eva end. Dis na to di next chapter."
E share di post wit one emotional video wey show im young and early days wit di Nigeria national team, till now.
Wetin dey inside di emotional video
Inside di video, William Troost-Ekong tok about im life and im early years.
"Born and raised for di Netherlands, I don get 83 senior caps, I play for five major tournaments win three medals and break few records. I don really live my dream
Inside di video, William Troost-Ekong tok about im life and im early years for di Super Eagles afta late Super Eagles coach call am for phone for 2015.
Im say dat phone call change im life and afta one month, im play im first match for Nigeria.
Di match na Nigeria vs Chad and e show how Stephen Keshi believe am and e boost im confidence.
"Evri single time wen I wear dat iconic shirt to waka enta di pitch I dey remember dat exact moment."
"Nigeria take me in and trust me to lead a nation of of ova 230+ million pipo"
Im tok say for im to dey di team to di point of to di Super Eagles "dey beyond my wildest dreams"
Dem born William Troost-Ekong for Netherlands and na for dia dem raise am too.
Im narrate how from di small boy im growing to become "Oyibo wall" and to become "skippo na privilege."
Ekong say until now, im still wish for a different ending
'Ekong for Super Eagles'
Ekong get 83 senior caps, play for five major tournaments and win three medals.
Im also break few records and im say "I don really live my dream.
Ekong play for di Rio 2016 Olympic wia e win bronze medal.
E play for di 2018 Fifa World Cup for Russia.
And e compete for three Africa Cup of Nations for 2019, 2021 and 2023.
E win Player of di Tournament Award for di 2023 Afcon wia Nigeria finish second behind host Cote d'Ivoire and e get di silver medal.
E also lead Nigeria as captain for di 2023 Afcon and e score goal for Nigeria for di final.
Ekong na di highest scoring defender for di history of di Africa Cup of Nations. E score five goals.
"I dey at peace sake of say throughout all dis milestones I give evritin wey I get, no be for my sef alone but to try inspire di next generation, di same way di legends wey I bin dey look up to inspire me. And I bin get di pleasure to fight shoulder to shoulder wit dem."
Troost wey say e go continue im charity work for Nigeria, e thank all di coaches, player both past and present and all Nigerian fans for all di support wen im dey play well and wen e dey challenging.









