Judge clear man after e spend 48 years in prison for crime e no commit

One judge for Oklahoma inside USA don clear one man wey spend almost 50 years for prison after dem later confam say e no commit di crime.
Dem bin arrest Glynn Simmons now 70 years old for one murder wey happun for 1974.
Sabi pipo say for America dis na di longest pesin wey don serve for prison for crime e no commit.
Dem release Simmons for July wen judge order new trial after e confam say wetin dem use jail am no dey conclusive.
But on Tuesday di 70 year old wey spend 48 years behind bars completely become free man afta judge declare am ‘innocent’.
"Dis court find by clear and convincing evidence say di offence wey oga Simmons dey convicted, sentenced and imprisoned for... e no commit am,” she tok for her ruling.”
“Dis na lesson in being patient and focused” di released man tok afta di judgement.
“Let no man tell you say something no fit happun because e really fit happun,” Simmons add.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Simmons bin serve 48 years, one month and 18 days for prison for di murder of Carolyn Sue Rogers during one alcohol store robbery for Oklahoma City suburb.
Dis make am di longest-serving inmate to be cleared, according to di National Registry of Exonerations.
Simmons at di time dey 22 years old wen im and one Don Roberts, chop conviction and sentence to death for 1975.
Dem later reduce di punishment to life in prison becos of US Supreme Court rulings on death penalty.
Oga Simmons bin tok say im bin dey inside im house for state of Louisiana wen somebody kill di woman.
Simmons and Roberts chop jail in part becos of testimony from one teenager wey dem shoot for back of im head during di incident.
Di teenager bin point to several oda men during police line-ups wey happun afta.
Wrongfully convicted people wey serve time for Oklahoma dey eligible for up to $175,000 (£138,000) as compensation.
Simmons currently dey battle liver cancer, according to im GoFundMe, wey don raise thousands of dollars to help support im living costs and chemotherapy.










