President Paul Biya sworn in for anoda eight term in office

- Author, Paul Njie
- Reporting from, Yaoundé
- Read am in 6 mins
Cameroon 92-year-old President Paul Biya don promise to restore order for di country after di post-election violence, as dem swear am in for im eighth consecutive term in office.
For im inaugural address, di leader offer condolences to victims of di protests and blame those wey e call irresponsible politicians for di unrest.
"I fit assure you, order go reign," e promise, as e say e dey pointless to cause di country to enter post-electoral crisis.
Inside allegations of fraud, Biya describe di electoral process as satisfactory and praise di electoral body Elecam.
In recent weeks, Elecam bin don come under criticism for alleged irregularities during di election. E partly spark di protests across di country, wey lead to di killing of at least 14 pipo and arrest of over 1200 odas, as per figures from di National Human Rights Commission. Oda institutions don present higher death toll.
Meanwhile, Biya congratulate security forces for containing di protests but e fail to address complaints of too much use of force.
E insist say now di election don pass, as e ask citizens to work with am on building a "united, stable, and prosperous" country.
Di 92-year-old also promise to make issues affecting women and young pipo a priority, with commitment to tackle corruption and security challenges wey don mark im administration over di years.
Biya first come into power for November 1982, after di resignation of President Ahmadou Ahidjo. Im critics say e don rule di country with iron fist since den.

Wia dis foto come from, AFP via GETTY
Before di swearing in ceremony, several parts of di country bin dey crippled by one ghost town operation wey opposition leader Issa Tchiroma Bakary, wey claim victory for di election bin impose.
Bakary say e go resist until im "victory" dey recognised, and e go on to ask foreign powers to impose sanctions on Cameroonian officials over di recent crackdown on protests and complain over electoral fraud.
Oga Bakary bin tell pipo to protest di results by sitting for dia house and closing dia shops.
Since Monday, di pipo of Cameroon dey observe dis order in many ways.
Mohamadou Alhadji dey operate one barbershop for di northern city of Garoua wey be Tchiroma Bakary im hometown and stronghold.
E bin close im barbershop since di ghost town operation sake of e dey fear say dem go destroy am if e open am to work.
"I no wan make kasala pipo destroy my shop," he tok, as e refuse to listen to di govment calls to stop civil disobedience.
"Govment go give me money and pay for my shop if dem destroy am?"
Mohamadou no dey alone – many odas dey respect di ghost town operation.
Oga Bakary get plenty followers across di north, so many pipo say dem dey obey di order to support his political fight.
One trader for di Garoua central market - Ousmanou Ibrahima explain say "we no go open, we accept dis [ghost town] order wey dem given."
E tell BBC say e wan change for di country so e dey support di former govment tok tok pesin, Issa Tchiroma Bakary im side of di tori say im win di election.
"We dey obey dis order, na im be our president," anoda supporter Abdulkarim Nassirou wey be taxi driver for di same city, tok.
Even though im dey support di ghost town order, e tok say e don dey affect am as e dey struggle to provide for im family.
"Tins don hard well well ova di past three days, and we no fit to chop wetin we want chop sake of we no get money."

Wia dis foto come from, ROBERT FIMBAYE VIA GETTY

Wia dis foto come from, BBC Sport

Despite dis, e say im go still support di ghost town order if dem stretch am to more days.
For Garoua, like many oda parts for di Central African kontri, wey get about 30 million pipo, busy streets, schools, markets and health centres no dey work fulltime.
Dis be different from wetin dey hapun for di capital Yaoundé – wia pipo dey go about dia work.
"I no fit stay for house," one old pesin wey dey sell fruits for di roadside for di city centre tok.
Im dey watch over im oranges wey dem arrange on top a tray, as she tell BBC say dis na her only source of livelihood.
"I dey under pressure to go out because I no go get what to eat if I no go out to sell."
Few meters away, Maleke Seldei dey prepare to display im phone cases for sale afta im notice say many pipo no dey respect di ghost town order for Yaoundé.
Im decision to comot to work na sake of say govment give assurance wey make oda pipo dey go about dia work also.


Di authorities already tok say make pipo no obey calls for "insurrection," ghost towns, and civil disobedience.
Throughout di ghost town period, govment admin officials dey on di street to encourage business pipo to open dia shops.
For di economic centre Douala, wey be di centre of post-election violence, pipo don resume dia business and school activities low-key.
Many odas dey careful wey dem no be sure about wetin go hapun, as tori bin dey go round say food prices and oda tins don rise.
Odas simply close dia shops wey dem stay for house to avoid cases of vandalism.
Di Human Rights Commission of Cameroon say at least 14 pipo die during di post-election kasala between security forces and protesters, wia dem arrest and detain ova 1,200 odas.
Dem also destroy public and private properties, according to di commission.
Di ghost town order don also affect urban transport services.
On Tuesday, di Transport minister Jean Ernest Bibehe bin meet wit pipo for di sector wey im assure dem of safe and smooth transport across di kontri.
Currently Paul Biya be di oldest president for di world, im new seven-year mandate go make am rule until e go reach almost 100 years.
Biya wey already serve for 43 years go begin fresh mandate wit allegations of crackdown on di opposition, youth unemployment and security wahala.










