Wia Cameroon opposition leader Issa Tchiroma Bakary dey?

Tchiroma Bakary dey wear white traditional attire, as im siddon for chair dey tok to tori pipo

Wia dis foto come from, DANIEL BELOUMOU OLOMO/AFP via Getty Images

Read am in 4 mins

Cameroon opposition leader Issa Tchiroma Bakary don claim say military dey support and protect am for one secure location afta di govment tok say im go face legal actions Reuters report.

"I thank di loyalist army, dem shown patriotism by escorting me to safe location and currently dem dey ensure my protection," Tchiroma tok dis for im Facebook page.

Tchiroma Bakary bin claim say na im win di 12 October, presidential election for Cameroon but di constitutional council declare Paul Biya di winner of di election on Monday 27 October.

Although, Tchiroma Bakary don dey im house for northern city of Garoua since di presidential election on October 12 but e don come out to claim say dem don kidnap two members of im family and personal cook for im Garoua hometown.

Di 76-year-old opposition leader tok say im don move to safe location by im "loyalists" in di military, afta one big protest break out in di kontri ova di weekend.

Cameroon Interior Minister Paul Atanga Nji blame di opposition leader Tchiroma Bakary say na im dey organise di "violent post-election" protest wey don lead to di loss of lives across di kontri.

At least four protesters don die as di tension kontinu to grow afta di consitutional council declare Paul Biya as di winner of di election.

Inside anoda statement on Friday, Tchiroma Bakary call for national lockdown protest against di election results from November 3 to November 5, im ask di pipo make dem observe "ghost town across di kontri.

"Despite dis climate of terror to make us retreat, we no go give in. I diafore call on you, from Monday, November 3 to Wednesday, November 5, to observe ghost town," e tok.

"Make di entire kontri come to standstill, so di whole world go know say we dey resist and say we no go gree.

"Make we close our shops, suspend our activities, sidon for house, in silence, to demonstrate our solidarity and to remind dis regime say di strength di economy na di pipo — and di pipo no longer recognize dem as dia leader.

"Cameroonian pipo. Dis no be di time to dey for fear or dey divided. Make we remain standing, united, proud, and in solidarity against pipo, wit Machiavellian cynicism, invoke peace while sowing terror as dem continue to rule through misery and blood.

"I repeat, dem no go steal our victory. I don make solemn pledge neva to betray una, and I no go fail. Dis na di reason for di rest of my life. We go win dis togada."

Tchiroma Bakary call for "ghost town" afta days of post-electoral violence wey don lead to di arrest of plenty pipo, some don die and some wunjure.

Di UN, EU, France, Canada and rights groups such as Human Rights Watch and Amnesty International don condem di killings.

Although normalcy don dey return to some parts of di kontri afta di protest, but di situation on ground remain unpredictable.

On Facebook, Tchiroma Bakary praise di pipo for dia courage and unity for standing against di "seizure of power."

E tok say across di regions, from North to South, East to West, Cameroonians don express demselves peacefully, wit di only weapon wey di constitution grant to dia "voice."

"And yet, dem welcome dis voice by di use of arms. Real bullets respond to di chants of freedom. Dem don steal our parents, our children prime, and peaceful marches don turn into blind repression, wit facie crimes.

"Hundreds don die and wunjure. Entire family dey in grief, recalling di traumatic events of 1984.

"While di pipo dey mourn dia misfortune, pipo wey dey responsible for dis tragedy dey celebrate shamelessly, displaying on social media dia cynicism and contempt for di pipo.

"Inside one video, di President of di Constitutional Council imself, don drink champagne, e dey boast say im don "ensure" di outgoing President' victory."