Wetin Cameroonians think about dia 92-year old President Paul Biya re-election

Paul Biya, 92, post im ballot as im wife Chantal, 54, dey look

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 4 mins

Reactions still dey follow di victory of President Paul Biya for di 12 October presidential elections.

Cameroon Constitutional Council on Tuesday, 27 October announce di re-election of 92-year-old President Paul Biya, di world oldest head of state, for a eighth successive term.

Di official result wey say Biya win wit 53.7%, ahead of Tchiroma Bakary wey get 35.2%, bin come as disappointment for some Cameroonians.

Although, e no come as surprise as Biya never lose election before, however, residents especially young Cameroonians dey disappointed.

'Di silence tok evritin'

Collage of Cameroonians

Wia dis foto come from, Getty Images

One resident, Amungwa Nicodemus tell BBC say, "We dey di beginning of anoda nightmare" as e lament di failing economy, corruption and add say plenty tins dey go wrong for di kontri.

"Wetin strike me first afta di proclamation of di results, na di silence - graveyard silence," Vivian Muma, for di northern city of Bamenda tok.

"Di silence tok evritin. Cameroonian pipo don decide, but dos wey make di decisions, decide otherwise," she tok.

Anoda resident question if truly na Biya dey lead di West African nation considering say dem rarely dey see am for public plus im age. She also say she don lose hope for any kain positive changes for di kontri.

"E don dey power for 43 years, no be dis seven years go change anytin. As a youth, dem born me and I grow up to know am as president, as graduate, I no fit boast of beta job," she tok.

Meanwhile, anoda Cameroonian, Abolo Denis, ask Cameroonians to accept di result, e say peace dey of di utmost importance.

Protesters carry placard

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Supporters of Issa Tchiroma Bakary bin clash wit security forces bifor di declaration of di result

Meanwhile, International human rights groups don ask Cameroonian authorities to investigate di violence wey break out during nationwide protests, bifor and afta dem declare 92-year-old President Paul Biya as winner of di presidential election.

On Tuesday, reports say two pipo die for inside one protest afta di declaration of di result.

Opposition candidate Tchiroma Bakary wey come second for di election tok say ''snipers'' kill two of im supporters outside im residence for Garoua, wia protesters reportedly burn di houses of di mayor. BBC neva fit verify dis report.

For separate statements, UN Human Rights Office, Amnesty International, and Human Rights Watch bin express concern ova how security forces take handle protesters wey storm di streets to reject wetin dem describe as electoral fraud.

Cameroonian officials confam say at least four pipo die for di economic capital Douala on Sunday.

UN say dem dey shocked by reports say pipo die, some injure, and some odas dey arrested since Sunday nationwide protests.

"We call for restraint, investigations plus end to di violence," di statement add.

Amnesty International also call on di govment of Cameroon to "respect, protect, and facilitate di right to peaceful assembly."

Dem say fast and independent investigation into di deaths dey important to shed light on di circumstances wey surround di incidents.

For im first statement, afta e dey declared as winner, Biya tok say im "thoughts dey wit all dos wey unnecessarily lose dia lives, and wit dia families, as a result of di post-election violence."

Kontri pipo dey rarely see Biya wey enta office for 1982 for public dis days. Dem know am as leader wey dey spend time outside Africa for Swiss hotels. Dis long absences plus im advanced age don in di past, lead to rumours say e don die.

While pipo hail im leadership for di expansion of schools and public universities, im tenure don also face criticisms.

One violent separatist insurgency for di English-speaking west don dey operate for almost a decade, unemployment tanda at 40% for di under-35s, roads and hospitals dey crumble, and freedom of speech don reduce.

Analysts bin warn say Cameroon, a once peaceful kontri, fit descend into political turmoil if di election results no reflect di will of di pipo.

"Biya now don get shaky shaky mandate - many of im own citizens no believe say e win di election," Murithi Mutiga, Africa Program Director for di International Crisis Group, tok for statement.

"We call on Biya to urgently initiate a national mediation to prevent further escalation," e add.