Paul Biya react to presidential victory as kasala burst for Cameroon afta announcement of results

Paul Biya for stage dey give speech

Wia dis foto come from, ROBERT FIMBAYE/AFP via Getty Images

Read am in 4 mins

Cameroon President Paul Biya don drop im victory message for social media wia e tank di pipo wey vote for am.

For statement wey im party release following di announcement of results, e say, "I sabi di kain weight of responsibility wey don dey given to me and wetin my compatriots dey expect especially di ones of young pipo and women".

E add say, "As President of all Cameroonians, I go like hail di pipo wey participate for di electoral process wey make Cameroon to be true democracy. I wish to particularly extend my sincere tanks to all di voters wey choose me."

As e tok dat one, Oga Biya also torchlight wetin go happun for di kontri now wey e don win. E say "as di presidential election don pass so, my hope be say togeda we go collabo to build peaceful, united and prosperous Cameroon".

Reactions don come in afta di announcement say President Paul Biya go remain for office as di kontri president for di eight term running. At 92 years old, e be di oldest president for di world.

Opposition leader Issa Tchiroma Bakary hala for social media say snipers shoot and kill two pipo for di front of im house for Garoua as kasala burst afta di announcement of di results.

E tok say dem shoot di pipo for "close range" as dem bin dey camp outside im house.

Apart from oga Bakary, oda leading politicians for Cameroon don dey chook dia mouth for di mata.

Meanwhile anoda presidential candidate wey dem dey call Serge Espoir Matomba don dey call for peace.

For statement wey im party, di United People For Social Renovation bring come outside, e call for peace among di pipo as kasala wey don cause loss of life dey happun.

Di statement by di party share condolences wit di pipo wey die say, "any loss of life na wound to di republic".

Dis na as dem ask make pipo begin dey prepare dia self for di municipal elections wey dey happun next year.

Di only female candidate for di race, Tomaino Ndam Njoya call say she want make dem cancel di vote.

Di presidential candidate wey come third for di election Cabral Libbi don tell im supporters say make dem "no dey discouraged and make dem no lose heart".

Dis dey come as Libbi from di Cameroonian Party for National Reconciliation (PCRN) say e "acknowledge" di results and "sama congratulations for di candidate wey dem declare as winner"

How e be for ground ova di announcement of results

Paul Biya tear-tear poster

Wia dis foto come from, Reuters

Protests start for Cameroon economic capital of Douala afta di election results, na so local tori pipo tok.

Tori pipo tok say pipo bin dey jog for road dey shout Issa Tchiroma Bakary name togeda as Cameroon News Agency post video wey show council building wey di protesters allegedly damage.

Even though tori be say four pipo die for Sunday protest, dem no reduce dia volume afta announcement of results on Monday.

Meanwhile, residents from di capital city of Yaoundé don start to dey loud dia voice ontop Biya victory.

Amungwa Nicodemus tell BBC say, "we dey for di start of anoda nightmare. Di economy dey go down, corruption don turn virus and plenti tins just dey go wrong".

For Bamenda, di place don silent as dem announce say na Paul Biya win election.

Vivian Muma from di area explain say, "Wetin shock me first afta di proclamation of results na how e just quiet. No be paradox wey pipo win election and dem [no] celebrate? Di silence just tok evritin. Cameroon pipo decide, but di pipo wey dey make decisions choose anoda tin."