Ivory Coast President Ouattara win re-election wit 89 percent of total votes

Wia dis foto come from, SIA KAMBOU/Getty Images
Di Independent Electoral Commission (IEC) for Ivory Coast, do declare incumbent President Alassane Ouattara as di winner of di kontri presidential election.
According to di president of IEC, Ibrahime Kuibiert-Coulibaly, di 83-year-old Ouattara win di presidential election wit 89.77% of di votes.
Ouattara main challenger wey be di former first lady of di kontri, Lady Simone Gbagbo gbab only 2.42% of votes.
8.7 million Ivorians na im register to vote for di kontri wey get about 32 million pipo but di electoral bodi say voter turnout na 50%.
Di Constitutional council go need approve dis results in di coming days.
Meanwhile, di African People's Party (PPA-CI) of former president Laurent Gbagbo, don criticise di process and ask for di authorities to 'reorganise di election".
Opposition concede defeat
Earlier, former Ivory Coast commerce minister Jean-Louis Billon bin concede defeat as im agree say di kontri president Alassane Ouattara don win di election on Sunday, as di partial results show say Ouattara dey lead for di votes counting.
Inside one statement on im X page, e tok say sake of di partial results wey im don review, na Ouattara win.
"On dis day, October 26, 2025, I wish to extend my republican congratulations to di President of di Republic, Alassane Ouattara, for im victory announced by di initial results wey we don collect," e tok.
"I also commend all di candidates for dia participation in dis electoral process and for di democratic vitality wey each, in dia own way, don help to sustain.
"To all di pipo wey don place dia trust in me, I wish to express my deep gratitude. Your commitment, your energy, and your faith in fairer and more prosperous Côte d'Ivoire go remain di driving force behind my action.
"I no forget all di women and men wey work by my side throughout dis long weeks to try to bring our project to life.
"Now, di new chapter wey go open gatz be one of unity, solidarity, and collective work for our Nation. Long live Côte d'Ivoire, in peace, dignity, and hope."

Wia dis foto come from, @JLBillon_/@AOuattara_PRCI/ X
Billon na one of di four opposition candidates wey contest for di presidential seat and im bin challenge 83-year-old, Ouattara wey dey try win di presidential seat for di fourth time.
On Saturday, di Independent Electoral Commission begin dey count di votes on national television.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
On Saturday, 25 October, many Ivory Coast citizens observe dia human right by voting for di next president of di kontri for dia polling stations.
Voting bin start around 8am and close at 6pm, ova 8 million adults bin dey among di eligible voters.
Oda ogbonge candidates for di election na:
Simone Gbagbo, 76, former first lady, bin marry former ex-President Laurent Gbagbo and dey seen as im main adviser
Henriette Lagou Adjoua, 66, na former minister and popular women rights campaigner
Ahoua Don Mello, 67, na former minister and former padi man of ex-President Gbagbo.









