Paul Biya declared winner of Cameroon presidential election

Cameroon president Paul Biya wear black suit wit white shirt

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Paul Njie
    • Role, BBC Africa
    • Reporting from, Garoua, Cameroon
    • Author, Seher Asaf
  • Read am in 6 mins

Cameroon Constitutional Council don declare President Paul Biya di wnner of di October 12 election.

Biya win wit 53.66% percent of di votes, while im main challenger and former ally Issa Tchiroma Bakary come second wit 35.19% percent, di Constitutional Council tok.

"Di candidate Biya Paul hereby dey declared elected president of di republic, afta e obtain majority of di votes cast," Clement Atangana, President of di Constitutional Council announce.

Dem put voter turnout at 57.76%, wit an abstention rate of 42.24%.

Ten candidates bin run for di kontri top job, and Biya wey neva lose election bifor bin already dey considered as favourite to win.

Dis results different from di ones wey Issa Tchiroma wey declare imsef as winner of di election beforehand get.

Breakdown of di result region by region

Leader of di constitutional council as e dey announce di result of di 12 October presidential election for Yaounde

Wia dis foto come from, Screengrab

Di council leader Clément Atangana announce di result of di election region by region in alphabetically order from di 10 regions.

Dis na how di major candidates take win by regions.

  • Adamawa region - Issa Chiroma Bakary get 56% of votes
  • Centre - Paul Biya get 70.14%
  • East – Biya get 73.88%
  • Far North - Biya score 45.93%
  • Littoral - Tchiroma Bakary get 64.5%
  • North region - Issa Tchiroma Bakary get di majority wit 43.51%
  • North-West - 52.5% of di pipo here no gree vote – from di votes cast, di majority go to Paul Biya 86.31%
  • West region - Paul Biya get 46.21% against Tchiroma 38.6%
  • South region - Paul Biya home region na wia e get di highest share so far wit a whopping 90.86% of votes
  • South-West - about 53% of di pipo for dis restive Anglophone region no comot vote, but wit di votes dem collate, di highest share go to Biya: 68.7%.

Diaspora result

More dan half of di Cameroonian voters wey dey live across Africa - from Ethiopia to Senegal - no gree vote.

Out of dos wey vote, Issa Tchiroma Bakary receive 54.99% of di votes.

Issa Tchiroma Bakary win di backing of voters "for di Americas" - wit 66.75% of di vote.

Again proving im popularity for diaspora, Issa Tchiroma Bakary get 68.21% of di vote goes across Asia and the Middle East.

Europe also throw dia support behind Tchiroma, dem give am 62.79% and 22.63% to Biya.

Who be Paul Biya?

92-year-old Paul Biya wit im wife Chantal Biya

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Re-elected Paul Biya na Africa oldest head of state and di continent second longest-serving leader.

Neighbouring Equatorial Guinea President Teodoro Obiang Nguema narrowly beat am to di record.

E no dey too show for public, pipo know am as leader wey like to dey spend most of im time outside Africa, e dey mostly stay for Swiss hotels, and dis long absences plus im advance age bin lead to rumours say e die sometimes ago.

Biya enta power for 1982, following di resignation of im patron and predecessor Ahmadou Ahidjo, e bin promise liberal reforms bifor e cement im hold on presidency.

Since one narrow election victory for 1992, President Biya don clear off subsequent political challenges, some analysts say e fit don get help by manipulation of di polls and by di divisions among opponents.

Praise for Biya include di expansion of schools and public universities during im time for office, and di way e take handle Bakassi mata wey see as dem handle di oil-rich peninsula give Cameroon instead of Nigeria.

But, under im leadership, Cameroon dey inside one deep violent separatist insurgency for di English-speaking west for more dan 10 years now, unemployment tanda at 40% for di under-35s, roads and hospitals dey crumble, and freedom of speech be like idea instead of a reality.

Big fire near one tree wey fall

Wia dis foto come from, Michel Mvondo/BBC

Wetin we call dis foto, Di protests start afta Tchiroma Bakary call on im supporters to march peacefully afta di presidential elections

Authorities tok say at least four pipo bin die during protests for Cameroon economic capital, Douala, ahead of di official announcement of results inside one highly contested presidential election.

Di regional govnor, Samuel Dieudonné Diboua, tok say police stations bin come under attack and security forces gatz defend themselves.

Hundreds of supporters of opposition presidential candidate, Issa Tchiroma Bakary, bin disobey di ban to hold protests for several cities, dem clash wit security forces.

Tchiroma Bakary dey insist say na im win di presidential election wey hold on 12 October, as e challenge di incumbent President Paul Biya 43-year-old hold on power.

Di ruling CPDM party don dismiss di claims.

Diboua condemn di deadly protests wey e describe as "premeditated acts of violence" plus serious attack on public order and national security.

"Four pipo unfortunately lost dia lives," e tok. E add say several members of di security forces also injure.

"We don open investigations, so dat wetin lead to dis unfortunate incidents go dey clear," e add, as e threaten to take action against di instigators.

For Tchiroma Bakary stronghold for Garoua, one city for di northern part of di kontri, police fire tear gas and water cannons at im supporters.

Di protesters bin reject wetin dem say be plan of di ruling party, di Cameroon People Democratic Movement (CPDM), to "tiff di victory" from di opposition leader.

Di protests start afta Tchiroma Bakary call on im supporters for di kontri and for di diaspora to march peacefully to "liberate Cameroon".

For Garoua, di demonstrations bin start peacefully but e quickly turn rowdy wen security forces throw teargas on di streets to disperse di hundreds of pipo wey gada in support of Tchiroma Bakary.

"We no dey here to scata anytin. We dey demand di truth of di ballot," one placard read.

One protester bin carry banner wey dey ask US President Donald Trump to help dem.

"We dey here to claim our victory. We dey do peaceful march, wey be civil right for all Cameroonians - for everyone," anoda protester tok.

Supporters bin also enta streets for di south-western city of Douala. "We want Tchiroma, we want Tchiroma," protesters chant, Reuters news agency reports.

Supporters of Tchiroma demonstrate for streets ahead of di result announcement

Wia dis foto come from, Michel Mvondo/BBC

Tchiroma Bakary previously tell BBC say im no go accept a stolen vote.

E tok say im team don compile di overall picture based on results from individual polling stations.

For one video statement e post on social media, Tchiroma Bakary tok say im win di election wit about 55% of di vote, based on wetin e say be returns wey represent 80% of di electorate.

Di 76-year-old former govment minister bin fall off wit Biya, 92, wey dey seek anoda term afta 43 years in power.

Opposition supporters bin allege say irregularities, including ballot-stuffing full di 12 October poll.

Judges on di constitutional council bin dismiss eight petitions, wey cite insufficient evidence of irregularities or lack of jurisdiction to cancel results.

Tchiroma Bakary refuse to file complaints wit di council, e say na Biya appoint di judges, instead e choose to declare imsef di "legal and legitimate president".

Map show breakdown of how Cameroon vote