Cameroon Constitutional Council announce date for release of presidential election result

Dem pour out votes for table from one ballot box

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Read am in 4 mins

Cameroon Constitutional Council go declare di results of di country presidential election on Monday 27 October.

Di President of di Constitutional Council Clement Atangana wey announce di informate for one statement say di council go declare di result of di 12 October election for di Conference centre for Yaounde by 11am on dat day.

Dis dey come afta dem conclude petition hearings dis Wednesday. Di judges bin cancel all di requests for either a partial or total cancellation of di election.

Statement from di council

Wia dis foto come from, Screengrab

Di Catholic Church for Cameroon bin recently ask di Constitutional Council judges to ensure say dia verdict reflect di will of voters. Dem beg dem say make dem no change di result in favour of anoda candidate.

Ahead of di declaration of di results, protests don hapun for some cities for di kontri, as many allege gross electoral malpractices.

March and protest if result favour di incumbent - Tchiroma

Issa Tchiroma Bakary wear one white traditional attire, e stand inside one motor and raise one of im hand up. Im supporters surround am.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Presidential contender Issa Tchiroma Bakary don disobey di authorities by declaring imsef di winner of di elections

Meanwhile, one opposition candidate Issa Tchiroma Bakary, wey dey claim victory for Cameroon presidential election don ask citizens to "march for liberation," if di Constitutional Council verdict go in favour of di incumbent President Paul Biya.

For inside one video e post on social media earlier today, di former govment tok-tok pesin claim say im win di election wit ova 50% of di votes and e go ahead to declare imself di "legal and legitimate president" of di Central African nation.

"If di Constitutional Council declare falsified and truncated results, e go be complicit in a breach of trust," e announce, and e say most of Cameroonian go kick against such outcome.

E bin don first declare victory bifor and di electoral commission describe im move as illegal. Dem ask di citizens to wait for official results from di Constitutional Council, as na dem get di constitutional right to declare di result.

Im statement bin come for di middle of one recent waves of protests for several parts of di kontri, wey include Garoua, im stronghold.

Despite threats and restrictions wey administrative authorities make compulsory, im supporters bin enta streets today and stage protests.

For di far northern city of Maroua, protesters reportedly clash wit security forces wey use teargas scata dem.

Faced by wetin Tchiroma describe as threats from Biya regime, di 76-year-old bin dey firm for im decision for pipo to "march and protest" against electoral irregularities and bad governance.

As di kontri dey wait for di election results, di govment dey beg for calm and don call on citizens to only acknowledge results wey di Constitutional Council release.

Di growing tensions for di kontri don spark fears of post-electoral violence for kontri wey separatist conflict for di Anglophone regions and Boko Haram insurgency for di Far North already dey affect.