Eight students chop suspension afta video of assault for SA school go viral

Wia dis foto come from, Gallo via Getty images
- Author, Khanyisile Ngcobo
- Reporting from, Johannesburg
- Read am in 4 mins
South African authorities don suspend eight students wey dey linked to one case of alleged bullying wey don cause national outcry.
One video wey show di horrible assault for Milnerton high school for Cape Town last week don dey fly up and down for social media.
Di video show as plenty boys dey beat anoda fellow pupil repeatedly wit various objects, wey include hockey stick, hose pipe and belt.
According to reports, di boy dey part of di nine dem allegedly assault.
Angry parents bin gada outside di school on Wednesday, 22 October to protest but police use tear gas drive dem comot.
Members of political parties wey announce planned demonstration for di school bin join di parents.
Bullying for schools na big problem for South Africa, as videos wey show di violent attacks most times dey go viral.
Dis latest clip dey among di most horrific wey don come out in recent years.
Di mother of di 16-year-old boy wey dem attack for di video tell local online publication, News24, say her son bin get cancer and just complete im chemotherapy earlier dis year.
"My pikin just beat cancer only for dis kain tin to hapun to am," dem quote her.
Di teenager uncle later tell local broadcaster eNCA say dem don comot di boy from di school.
Various organisations don condemn di incident, wey hapun on 16 October, di police don also confam say assault case don dey opened.
Among dos wey cry out na Amnesty International South Africa, dem say di video dey "deeply disturbing" and dem call for "timely disciplinary action".
Wetin dey inside di video
Di video, wey dey just ova two minutes long, show as di boy dey beg im attackers to stop dey hit am.
As e cry dey beg dem, na so one of di boys beat am again wit belt, wey make di odas begin laugh.
Di video also show as some of di boys dey make funny faces and dey hail di students wey dey attack di boy as di camera move across di room.
Authorities response to di alleged bullying
"No pikin suppose ever endure dat kain brutality for space wia [pupils] suppose dey safe and protected from harm," international human rights organisation tok for one post on X.
South Africa education ministry tok say dem don contact di Western Cape education department, wey dey oversee di school, and dem confam say di suspended pupils go face disciplinary action.
Di provincial department tok say dem dey "treat di mata wit di seriousness e warrant".
Authorities say di first tin di school do na to immediately launch internal investigation to identify dos wey dey involved.
"Di school governing body don approve di precautionary suspension of eight learners pending disciplinary hearings. Dem also provide counselling and psychosocial support to dos affected." Di Department of Basic Education tok for one post on X.
Dem further beg kontri pipo say make dem stop to dey share di video of di assaults or di details of dos wey involve. Dem say dis go "no go only worsen di trauma wey di victims experience, but e go also undermine di rights and dignity of all di [pupils] wey dey involved".
Di chairperson of parliament education committee also share her "utter horror and deep concern" on top di video.
Joy Maimela tok say di incident "no be just bullying but e border on assault – wey be criminal offence wey demand urgent and decisive action from all relevant authorities".










