Cameroon bishops call for calm as opposition candidate release election result wey claim say e win

Issa Tchiroma Bakary

Wia dis foto come from, Anadolu Agency via Getty Images

Wetin we call dis foto, Issa Tchiroma Bakary
Read am in 4 mins

Cameroon influential Catholic Church don call for calm, as fear dey grow say kasala fit burst once authority declare di official results from di presidential election.

For one statement wey di National Episcopal Conference of Cameroon (NECC) release, di Catholic Bishops express di need for peace and stability.

Di clerics tok say dem hope di official result go reflect di will of di electorate, and "authority wey dey involved for dis exercise no go change anytin".

Dis na as Cameroonian opposition candidate, Issa Tchiroma Bakary, begin release results from some administrative areas as im latest move to prove say na im win for di 12 October presidential election.

Im share di documents for social media on Sunday, and insist say e win for 18 important administrative units wey dem dey call divisions.

Di 76-year-old politician claim say di 18 areas out of di kontri 58 divisions represent nearly 80% of di voters.

"Since I don win dis 18 divisions, national victory don sure becos na dia voting strength dey determine who go win di election," e tok.

But Biya ruling CPDM party quick reject Tchiroma claim, say e no represent di true situation for di kontri.

"No be true say 80% of voters on October 12 dey inside 18 divisions," Gregoire Owona, Deputy Secretary General of di CPDM Central Committee, take reply.

E challenge im former colleague, wey bifor now serve as govment spokesperson, make e publish exit polls from all 58 divisions plus di diaspora.

"Try respect di law wey dey tell us make we wait small more days," Owona add.

Cameroon Constitutional Council neva release di final results.

Di Catholic Church na highly respected and pipo see dem as di moral voice of di nation.

Dia statement echo di sentiments of many, wey don ask di Constitutional Council to ensure say di result no dey rigged.

Some of di Church prelates bin dey loud for dia criticism of Biya and how e take govern.

For January, Monsignor Yaouda Hourgo, Bishop of di Diocese of Yagoua for di Far North region, tok say e dey preferable for di "devil" to take power, instead of Biya to seek re-election.

"We no go suffer pass like dis. We don already suffer enough," e tok for im sermon.

Following protests on top alleged fraud, di Constitutional Council say dem go begin hear complaints on Wednesday. Dia verdict go dey crucial in determining who go be di next president.

For inside one message to di judges, di Catholic Bishops repeat one simple message: "Di truth go set you free."

As Tchiroma dey kontinu dey claim victory, fear don dey rise say tension fit increase for di kontri.

But for one video wey he post overnight, di presidential candidate tell di current president, Paul Biya, make e "comot for power wit honour bifor power comot you."

E also tell Cameroonians make dem "defend una victory," promise say e go stand by dem throughout di process.

Meanwhile, di leader of di Cameroon National Salvation Front party still call on di international community make dem support wetin e call di will of di Cameroonian pipo.

E specially call on di African Union, Nigeria, Chad, European Union, United States, and France make dem no keep quiet.

All dis one dey happun as Cameroonians dey wait for di official election result wey di Constitutional Council go announce before 27 October.

Di council go first look di election petitions bifor dem announce di winner of di presidential election.

Last week, angry protesters enter street dey para say di election get fraud and irregularities just after voting. Dem burn buildings and destroy Biya campaign posters.

As Issa Tchiroma dey push pipo make dem defend their votes, many pipo dey fear say di coming days fit bring political wahala for di Central African kontri.