Cameroon Election: Voters don ready to choose new leader

Cameroon Presidential election
Read am in 3 mins

Polls don open for Cameroon as citizens line up to vote for dia next president.

Over eight million pipo dey await for polling stations nationwide dis Sunday.

For di Govment Bilingual Primary School Bastos, one polling station for di capital Yaoundé, attendance dey so far, plus plenti security checks for di entrance. President Paul Biya and im family go cast dia votes for dia.

First time voter Gabriel say e get as body dey do am as im dey "happy " say im go choose di president of im kontri.

"We want leadership wey dey near us, a leader wey go dey in contact wit di population," na wetin di 24-year-old tell BBC.

Im also express im desire to see evribody say evribody dey play dia role for di electoral process, including di electoral body Elecam.

Cameroon presidential election
Cameroon presidential election
Cameroon presidential election

For di regions wey dey speak English separatists bin impose lockdown to disrupt voting, movements dey restricted although some pipo dey for di polling stations.

Di separatists wey want to create a breakaway state bin ban residents make dem no take part for di govment-organised elections.

Ten candidates dey run for di biggest job for di kontri, wit di current President Paul Biya wey dey seek re-election for di eighth consecutive mandate.

Im don already dey for power for over 40 years and im dey insist say "di best go still come."

For two weeks, candidates for di presidential election bin travel across di kontri to campaign for votes.

Biya bin face criticism sake of say im no show face for most of di campaign waka dem.

Na only once im bin showface for di far north region afta in spend ten days for Europe.

Im bin wan launch im campaign wit one AI-generated video, wey bin draw widespread criticism from across di board.

Cameroon presidential election
Cameroon presidential election

Ninety-two-year-old Biya neva lose any election bifor and many pipo believe say na im go still win.

If e win and finish anoda seven-year term, e go don rule for 50 years just one year bifor e reach 100 years old.

Cameroon presidential election
Cameroon presidential election
Cameroon presidential election