Canada new immigration levels plan for di next three years to reduce student visas

Canada passport

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Canada don announce new immigration levels plans wey go increase di number of economic immigrants wey intend to come di kontri, and cut down di number of temporary residents, mostly through student visas.

For one statement wey di Canada Immigration release on dia website on Wednesday, 5 November, dem unveil di plans for 2026-2028, wey include di plan to take in 380,000 permanent residents and reduce di number of pipo wey wan come di kontri for work and study.

Di statement explain say di reason na say Canada don enta phase of stabilization and no get plan to bring in more pipo, but to balance dia population wit di housing, healthcare and infrastructure capacity of di kontri.

"Di fixed target of 380,000 permanent residents each year na deliberate effort to pause rapid growth and focus on manageable integration," dem tok for statement.

Wetin be di new immigration plan for 2026 - 2028

Under di new plans, Canada say dem go admit 380, 000 permanent residents every year for 2026, 2027, and 2028, within a range of 350,000 to 420,000.

For 2026, out of di 380,000 new immigrants dem go take in, nearly 240,000 go be through economic pathways like di Express Entry and di Provincial Nominee Program.

Canada say di reason for di heavy emphasis on economic immigration na bicos dia population dey age and many sectors dey face chronic labour shortages, so dem need skilled, talented pipo wey go fill essential positions, particularly in skilled trades, healthcare, and technology.

Di breakdown for 2026 na:

  • Economic class: 239,800
  • Family reunification: 84,000
  • Refugees, protected persons, humanitarian, and odas: 56,200

For 2027 and 2028:

  • Economic class: 244,700 each year
  • Family reunification: 81,000 each year
  • Humanitarian and other: 54,300 each year
Graphics wey show Canada immigration plans for 2026 - 2028

Wia dis foto come from, Canada Immigration

Temporary Resident

Under di new plans, Canada say dem go reduce di number of Temporary residents from 385,000 to 370,000. Di temporary residents admission include pipo wey wan enta di kontri for work or study.

Dis new levels plan cut into half di planned number of student visas for di next three years, dem bring am down to 155,000 in 2026 from about 306,000 for di previous year plan.

For 2027 - 2028, dem go reduce di number of student visas to 150,000.

Temporary resident projections:

2026: 385,000 total (230,000 workers and 155,000 students)

2027: 370,000 total (220,000 workers and 150,000 students)

2028: 370,000 total (220,000 workers and 150,000 students)

Canada govment also say dem go change 33,000 work permit holders to permanent residency.

Pipo wey go benefit from these, na workers wey don establish strong roots for dia communities, migrants wey dey pay tax and wey dey hep build di strong economy wey Canada need.

Graphics wey show Canada immigration plans for 2026 - 2028

Wia dis foto come from, Canada Immigration

How dis plan go affect international students and temporary foreign workers?

For 2026, 385,000 new temporary residents dey expected – wey go include 230,000 workers and 155,000 students.

By 2027 and 2028, dis numbers go drop further to 370,000.

Dis one mean say dem go reduce di number of intending international students wey wan go Canada to further dia studies.

Di number of temporary foreign workers go also reduce and di number of pipo wey dem dey give visa to join dia family for di kontri go also reduce.

Govment say di gradual reduction from 385,000 to 370,000 by 2027–2028 na to reduce di pressure on housing and public services while maintaining economic productivity.