Ghana beat Algeria on penalties to qualify for semifinal of 2024 Wafcon

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM
Black Queens of Ghana defeat Algeria 4-2 on penalties to reach di semifinal of di ongoing 2024 Women's Africa Cup of Nations.
Bifor di game, Algeria na di team wit di best defense as dem neva concede any goal so far.
Dia keeper Chloe N'Gazi na di best keeper for di group stage. Na so she shine for di game again, as she bin block all di danger from Ghana.
Algeria bin get seven shots wit two on goal as Ghana get 16 shots wit two on goal.
Di Fennecs of Algeria bin get more possession (55.9% - 44.1%)
Afta 90 minutes, di game enta extra time as both teams try to find dat goal wey go make dem progress.
But afta extra time, na penalties wey decide dis ogbonge match. Di Black Queens win di shootout as dia keeper Cynthia Konlan save two penalties from Marine Dafeur and Ines Belloumou.
Ghana take full advantage as all dia four players bin score. Josephin Bonsu, Doris Boaduwaa, Chantelle Boye-Hlorkah and Princella Adubea `9wit di winning kick).
End of Di one wey oda users dey read well well
In di end, di Black Queens qualify to meet host nation Morocco for di semifinal.
Dis na di end of di road for Algeria. Na history for dem to even reach dis stage in di first place, dem gat to keep dia head high as dem bin show say dem be team wey fit become beta and beta.
Penalty shootout
Di Ghana players don run to celebrate dia qualification.
- Ghana take di next. Princella Adubea score 2-4 and Ghana qualify for di semifinals of di Wafcon.
- Algeria take dia next. Nora Taleb Muller score 2-3. still advantage Ghana
- Ghana take di next. Hlorkah score for Ghana 1-3. Advantage black queens.
- Algeria talke dia next. Ines Belloumou don miss. 1-2. Konlan save di ball
- Ghana take dia next. Doris Boaduwaa score 1-2 advantage Ghana
- Algeria take dia next kick. Captain Sofia Guelatti take wey she don score 1-1
- Chance for Ghana to score. Josephine Bonsu take di kick wey she score 0-1 to Ghana
- Marine Dafeur take di kick for Algeria wey she don miss! Good save from Cynthia Konlan.
Algeria go take di first kick.
Di two captains Guellati and Boakye don do di toss. Di shootout go start soon.
Wit di record of di Algeria keeper Chloe N'Gazi for dis tournaent, Algeria gat hope say dem fit to win di shootout.
Both teams don dey prepare dia penalty takers.

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM
Extra time second half
FULL TIME FOR EXTRA TIME.
Penalty shootout next to decide winner for dis ogbonge quarterfinal game for di Wafcon 2024.
Ghana don change Jennifer Cudjoe wey dem bring on Nancy AMOH, be like she be one of di penalty takers for di team.
1+ Afta dis one minute, na penalty shootout.
At dis time any team wey fot get composure for di box of dia opponent fit to grtan goal.
119" Wasted! Evelyn Badu don hit one shot into row Z afta Ghana create fine chance.
118" Anoda wasted corner! But Ghana try to take advantage to di ball and create anoda chance. Di ball finally fall to Hlorkah but her shot dey off, off target.
116" Anoda attack from Ghana; Boaduwaa again try to hit one shot but dem clear for corner.
115" Chance for Ghana, Asantewaa bin pay one thru pass afta she beat two players. Boaduwaa bin dey rush to meet di ball bifor keeper Chloe N'Gazi don comot to clear.
114" Trouble for Ghana as dia captain Portia boakye don sit for floor afta she bin receive one ball. She don hurt without any tackle.
113" Chance for Ghana inside di Algeria area. Hlorkah don play one cross-field ball to Adubea for di far side. She struggle to beat her marker, wey she cut di ball back into di box but Algeria clear di danger.
112" Grace Asantewaa don dey ground afta she try to turn and collect one pass for di midfield. Freekick to Ghana. But dem bin waste am again!
Anoda poor corner from di black stars as dem no fit to pepper di Algeria keeper.
110" Boaduwaa bin dey alone for di top wey she win one leg race and enta di box but she no fit cross di ball as Algeria don clear di ball for corner.
109" Algeria bin get chance to score but di shot dey blocked.
108" Evelyn Badu don pass di ball to her oppoent as she bin dey try to find striker Boaduwaa
Freekick to Algeria afta Hlorkah foul Ould Braham inside di Algeria area.
107" Long shot from Algeria outside di box. Keeper Konlan catch di ball wit two hands.
106" Evelyn Badu tink say she don win one ball ova her defender but ref whistle say di ball don cross line for throw-in
Freekick to Ghana for dia area. Dem try hit di ball inside wey dem lose possession to Algeria.
105" Ghana bin pass di ball start di second half.
Di players don taya at dis stage but dem get anoda 15 minutes to try to win dis game.
Extra time first half
105" +1 Thow-in for Ghana. Ref whistle for di end of first half of di extra time.
104" Algeria for di last 30 seconds wia dem almost score but Duah don make ogbonge tackle to stop dat chance. Great block!
102" Khartouni from Algeria shoot from outside fi box but her shot bin dey rise ova di bar.
101" Chances bin dey open up for both sides. but none of dem fit take advantage.
100" Chaaance! Hlorkah don miscontrol one dangerous ball from di freekick inside di Algeria box. If she trap dat ball well, na goal. But di chance don vanish.
99" Yellow card for Ould Braham afta she bin kick di Ghana captain for di centre circle. Ref don alreadi whistle for freekick bifor Ould bin hit her.
Ghana coach bin dey shout for di touchline for foul but ref carry dey ball, wey she drop am.
97" Chance for Ghana as Adubea bin dey enta di box , wia dem bin hack ger down for di edge of di Algeria box.
96" Captain Portia Boakye bin dey solid for di back for Ghana , she bin dey control balls inside her defense well well.
95" Ref allow di dropball; Ghana play am from di back but Princella Adubea fall for ground as try to collect di ball.
Ghana player Chantelle Boye-Hlorkah bin fall for ground for di centre of di park afta she don land awkwardly.
94" Ghana bin fly one cross from di corner side into di box; Chloe N'Gazi don grab di ball.
93" From di long freekick, algeria fail to take advantage, na so linesman raise flag for offside.
92" Algeria don make anoda chance wit di substitute Naili, her first touch make she win freekick inside di Ghana area.
Ghana try to control di ball, Hlorkah don cross to di far side wey Evelyn Badu carry go back. From di fresh attack di black queens now win throw-in inside di Algeria area.
90" Di fennecs try to create anoda early chance for here but Ghana defend well
Ghana and Algeria don enta di park again to begin di extra time first half.

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM
Second Half
Ref don blow whistle for fulltime. Dem go need extra time to decide who go win dis game and qualify for di semifinal.
90+5" FULL TIME
90+4" Ref bin now give foul against Algeria afta Ould Braham don drag Adubea im shirt during di counter. Na surprise say di ref no give for dat foul.
90+3' Wasted! Ghana bin waste anoda freekick for one edangerous position. Jennifer Cudjpoe don blast di freekick wide
Meanwhile one Algeria player bin dey for ground ould Braham fall for ground afta one challenge. She bin dey receive di ball.
90+2" Ghana bin win frekick in front of di Algeria box. Chance for Ghana.
90+1"Anoda offside against Ghan as Boaduwaa try to win one ball for di Algeria area.
Dem bin add 5 minutes to di game. Ref give offside against Ghana as dem try to dey build one attack.
+5 mins
Ghana bin give away corner to Algeria, after ref judge say di ball cross di line afta keeper Konlan try to save a backpass.
87" From di corner Ghana don waste di ball wey N'Gazi catch di ball.
CHAAANCE! Evelyn Badu dey inside di box alone, she try to reach one cross to score but she delay wey Algeria clear for corner to Ghana.
85" Ghana try to create sometin wit Adubea; her shot dey wayward but e still bin find Boaduwaa, her cross no find any Ghana player for di box. Den when di ball finally reach a Ghana player, di header dey weak.
Freekick to Algeria for dangerous position for di Ghana area. Di player don ballon di ball ova. Goalkick to Ghana.
Algeria striker Muller don win di aeriel ball against Ghana captain Portia Boalye.
82" Time bin dey go now for both teams to get di opening goal.
Ghana bin dey change Princess Marfo for Princella Adubea.
Ghana now bin dey play wit high line at dis point, but Algeria no fit take advantage.
80" Anoda chance for Ghana, anoda bad decision for Marfo. She bin dey try too hard to take on pipo, wey she don lose di ball again for goalkick.
Yellow card for Ives Boutaleb.
78" Princess Marfo now bin dey waste di balls wit her solo run, dis time di ball dey too strong wey e don comot for throw-in.
Portia alredi bn get yellow card bifor dat foul on Taleb Muller.
76" Algeria now get breathing space to begin to pass di ball from di back wey end wit foul against Ghana captain Portia Boakye.
Di second time di freekick don crash against di Algeria wall.
75" Di ref now change her mind to give di freekick to Ghana away from di box for foul on Boaduwaa instead of di foul by di keeper outside her area.
Pressure bin dey on Ghana bifor dem try to break for di counter. Boaduwaa try to reach di ball na so goalkeeper N'Gazi comot wey she don handle di ball outside di box.
Ghana bin dey change Stella Nyamekye wia Evelyn Badu don enta.
72" Ghana bin hold di ball to make some passes in front of di Algeria area, di chance don vanish, dia cross into di box enta di hand of goalkeeper N'Gazi.
70" Di winner for dis game go face host nation Morocco for di semifinal. Ghana don waste di corner kick
69" Boadiuwaa bin hit di freekick, but di Algeria wall don clear di ball for corner.
Foul. Freekick to Ghana as Nyamekye don dey run towards di box bifor dem foul her. Chance for Ghana.
67" Algeria play di freekick but Ghana clear wey dem kick di ball inside for counter attack. Di long ball towards Boaduwaa dey too strong wey goalkeeper N'Gazi don comot to pass to her teammate.
66" Algeria bin dey possess di ball well until ref bin whistle for foul against Ghana wey she don show dia captain Portia boakye di yellow card.
64" Long cross into di box to Nyamekye but di Algeria defense don clear di ball.
63" Goalkeeper Konlan don catch di ball wey Algeria try to play into di box. Princes Marfo now try to drive for di Algeria area and win freekick.
Grace Asantewaa blast one shot way ova di bar from 37, 38 yards.
Princess Marfo now bin dey hold di ball too much when she gat to pass to her teammate.
61" Ghana bin dey try to create sometin but Chantelle im pass go straight to Algerian player.
60" Jennifer Cudjoe don commit anoda foul in front of her area, from di freekick, Algeria almost test di Ghana keeper.
Morgane Belkhiter don hurt, wia dem bin change her. Di fennecs dey mnake three straight changes.
57" Chantelle vex say ref don whistle for anoda foul against her when she bin win di ball.
56"Algeria try to reach one long ball for di Ghana box, if di striker fit reach dat ball, na oal be dat.
Plenty fouls for dis game so far.
Di black queens get freekick for di Algeria area, afta Portia Boakye play di ball inside, Algeria win possession.
CHANCE! Doris Boaduwaa bin win di ball, she turn bifor she shoot from distance but di shot go wide. Di striker bin create dat chance from nothing.
53" Princess Marfo bin dribble two, three players bifor she pass to her team mate.
Algeria dey pass di ball from di back patiently bifor dem win freekick for dia own area.
51" Anoda freekick for Algeria as Nyamekye try to use her body to block di defender to take one long ball.
50" Di game dey disjointed so far. Both teams dey struggle to hold on to di ball.
49" Chantelle tink say she bin win corner kick but ref tok say na goalkkick to Algeria to di surprise of Chantelle.
47" Algeria now dey try for di right hand side of di Ghana area but di striker no fit beat her marker wey Ghana win throw-in.
Throw ball for Ghana for di far left of di Algeria area. But Marfo don dey offside.
Algeria bin take di freekick but Ghana don defend di ball.
46" Ines boutaleb bin dey limp now to di side of di pitch for treatment now.
From di pass, Algeria try to enta di Ghana area wey Ghana captain Portia Boakye tackle Boutaleb for di Ghana area.
45" Algeria bin pass di ball for di centre circle.
No changes both sides as dem bin try to restart di second half.
Di players don comot for di second half of dis game.
First Half

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM
HALFTIME!
Ref don whistle for halftime between di two teams. 0-0.
Di ball now dey wit Algeria, di fennecs dey try to pepper di Ghana area bifor di break, na so Yeboah don push Boutaleb for ground.
45+2" Boaduwaa tink she don win di ball inside di Algeria box but ref don blow whistle.
45+1" Ghana try to create chance wit Hlorkah, but she try to take too many touches wey she lose di ball.
Ghana neva win di Wafcon bifor, even tho dem bin dey play well to reach di finals (at least three wia dem bin los to Nigeria).
+4 mins
44" Stella Nyamekye try to reach one ball for di far corner, but di ball go ova di line.
43" Anoda freekick for Algeria afta Jennifer Cudjoe foul Boutaleb. From freekick, Algeria almost score but ref whistle for offside.
Algeria bin dey defend well well for dia area whenever Ghana bin dey try to advance.
Princess Marfo tink say she don pass di ball to her mate but ref blow whistle say di ball don comot for throw-in.
41" Boaduwaa don win freekick as two players bin surround her wey she win freekick.
40" Jennifer Cudjoe don foul Ghouthia Karchouni in front of di Algeria box.
Algeria bin get freekick, di ball dey search Bousaha she hold am bifor she try to cross. Ghana now win di ball and Marfo wan start counter but she bin dey fouled for freekick.
37" Wasted pass from Ghana. Di pass towards Boaduwaa dey too hard, she gat to pass to Hlorkah for her right side bifor but she decide to find Boaduwaa.
36" Ghana try to take one chance wit Boaduwaa but her first touch dey too hard so di ball go close to N'Gazi wia she catch am.
35" Freekick to Algeria, captain Guellati bin hit am from dia area. Afta dat kick, dem bin wi anoda freekick for di center.
34" Bousaha bin run to reach one fine pass from di midfield but di Ghana defender try to block her wey she pass to di keeper Cynthia Konlan. Di keeper hit di ball against Bousaha bifor ref whistle for offside.
Freekick to Ghana in front of di Algeria box. Nyamekye Stella go play am.
32" Ghana don win throw-in, Yeboah don throw di ball - as Ghana dey try to advance, Algeria collect di ball wey dem pass to dia keeper N'Gazi.
Di game don restart.
31" Afta di long VAR check and disallowed goal, ref don whistle for cooling break.
Afta VAR check, ref don cancel di goal for offside. 0-0
Di VAR room bin dey check sometin for dat goal, to see if anybodi bin dey offside.
GOOOOOOAAAL! Stella Nyamekye don blast di ball into di roof of di next afta Hlorkah don cross di ball into di box. 1-0
25" Algeria captain Guellati dey strong for di bakc, na so she don prevent Hlorkah from getting space to cross one ball into di six yard box.
So far both teams dey try create chances but none of dem fit take advantage so far.
24" Susan Duah don jump to clear one long ball but ref say she bin foul Ines Boutaleb.
Ghana try to create one chance from di counter attack but di final ball dey poor, Algeria collect possesion.
23" Lina Bousaha don try to beat her marker for di line but she lose di ball, throw-in to Ghana
22" Marine Dafeur don trip Princess Marfor, Yeboah don take di freekick bifor Ghana lose di ball for Algeria throw-in.
21" Corner kick for Algeria as Yeboah try to shield di ball but ref whistle for corner.
20" Susan Duah don do mistake for di back wey she dash di ball; Algeria don try to take advantage but dem foul Josephine Bonsu for freekick.
19' Hlorkah bin get di ball wey she dey drive for di Algeria area, instead say she go pass to Boaduwaa for her left, she try to shoot from 40 yards, wia di ball go ova.
18" Chaaaance! Boaduwaa play one fine pass into di box for Hlorkah, but di Algeria defender Guellati don block di ball wey she win freekick.
17" Freekick to Algeria, captain Ghoullati don take am quick
Ghana get one attack wit Princess Marfo for di far left but instead say she go cross di ball into di box, she bin take di ball go all di way back.
16" Di game don restart now.
Dem bin treat di Algerian for di field, she bin dey bleed for di side of her face.
Yellow card to Princess Marfo for dat tackle on Bellakhiter.
12" Grace Asantewaa don win di ball for midfield wia she pass di ball to Hlorkah. Di midfielder pass di ball to di oda side wia e don fall to Marfo. Afta she bin win di ball from Morgan Bellakhita, her shot dey weak.
Melissa Bethi no fit collect one long pass wia dem play into di Ghana area.
11" Princess MArfo don hit one weak shot from di far left of di Algeria box, bit goalkeeper N'Gazi don catch am.
9" Di game no settle well well so far, as players bin dey struggle wit dia passes.
8" Freekick to Ghana as Doris Boaduwaa don fall for ground, captain Portia Boakye don hit di freekick but everibodi watch di ball to comot di park for goalkick.
Algeria bin dey cause wahala for di Ghana defense so far wit dia pace and tricks; Ghana dey struggle to keep possession.
7" Ines Boutaleb try to enta di box and cross one ball but she don fall wey di ball comot for goalkick.
6" From di corner, di ball no rouble di Ghana defense.
5" Corner to Algeria. Ghouthia Karchouni bin beat one defender wey she enta di box, but anoda player don block her, wia dem win corner.
Anoda throw-in for Algeria for di near side wit Belloumou, di cross into di Ghana box dey dangerous but Algeria no fit take advantage.
4" Foul. Iness Boutaleb don drag di Ghana captain Portia Boakye, ref whistle for freekick.
2" From dat goalkick Algeria attack thru di left hand side of di Ghana area wia dem gat chance to shoot inside di box but di shot dey weak, goalkeeper Konlan don catch am
CHAAAANCE! Ghana almost score wit dia first attack thru Stella Nyamekye, but her cross dey too high, goalkeeper N'Gazi bin catch am.
Algeria Coach Benstiti alreadi begin waka for touchline as dem take dia first throw-in.
Early quick passes from Ghana bifor dem play di ball comot for throw-in to Algeria.
1" Referee don whistle for di start of di game. Ghana don pass first wit Chantelle Boye-Hlorkah.
Algeria coach no make any change from dia game v Bostwana. Ghana coach bin make at least three changes from dia last game.
Some fans bin dey di stadium to watch dis game between di black queens wey don dey pursue semifinal slot versus Algeria wey bin reach dis stage of di Wafcon for di first time.
Algeria bin sing dia national anthem first, bifor Ghana sing dia own.
South Africa and Senegal go play dia own game at 7PM GMT (8PM WAT).
Ghana bin dey wear dia usual yellow jersey as Algeria dey wear all white wit some green stripe for di side.
Welcome everibody to dis quarterfinal game.

Wia dis foto come from, ALGERIENNE FOOTBALL FEDERATION/GHANA WOMEN'S NATIONAL TEAM
Time don reach again my pipo for dis ogbonge quarterfinal game between di black stars of Ghana and di fennecs of Algeria.Both coaches don drop dia lineup already.
Algeria XI: Chloe N'Gazi (GK); Sofia Guellati ©, Roselene Khezami, Melissa Bethi, Morgane Belkhiter, Ghouthia Karchouni, Lina Boussaha, Ines Boutaleb, Ines Belloumou, Amira Ould Braham, Marine Dafeur
Ghana XI: Cynthia Konlan (GK); Susan Duah, Grace Asantewaa, Jennifer Cudjoe, Princess Marfo, Chantelle Boy-Hlorkah, Doris Boaduwaa, Stella Nyamekye, comfort Yeboah, Portia Boakye ©, Josephine Bonsu
We gat few minutes to di start of di game.
Background
Di black queens of Ghana go face di Fennecs of Algeria for ogbonge quarterfinal game on Saturday, 19 July.
Ghana finish second for Group C afta dem thrash Tanzania 4-1 for di last group game to qualify for di knockout stage for di first since 2016.
Di black queens bin reach di final for di Wafcon (1998, 2002 and 2006) but since dem di team bin dey blow hot and cold.
Dem comot di group stage for 2008, 2010, 2014 and 2018 for dia home.
Di team now bin dey desperate to reach di final, but dem gatz conquer Algeria wey be first timers for dis stage.
Di fennecs bin progress to dis stage afta dem play goalless draw wit Nigeria for dia last group game.
Dem neva concede goal so far for di Wafcon; dem win 1-0 v Botswana and 0-0 wit Tunisia.
Dia keeper Chloe N'Gazi wey dem name as di best goalkeeper for di group stages bin dey solid for dem so far.
Dia na crunch time for both teams, afta Nigeria sama Zambia 5-0 to profess to di semifinal.
Host nation Morocco na di oda kontri wey don scatter dia opponent to reach di semifinals.
Di Atlas lionesses sama Mali 3-1, wia sabi pipo tok say dem bi one of di favourites for dis Wafcon.

Wia dis foto come from, CAF WOMEN'S FOOTBALL
Wetin Ghana and Algeria coaches tok
Algeria coach Farid Benstiti dey aware of di ogbonge game wey dey ahead wit Ghana, and e get confidence.
"Dis na our first time for di quarterfinal, we sabi Ghana, dem be strong team but just like di group stage, we go try to do our best."
Benstiti add say "anytin dey possible for football, I tink Ghana dey close to Nigeria, dem dey athletic but we wan prove say we deserve to be in di quarterfinal."
"We bin respect Ghana but we go try to win di game."
But dia coach get one headache- di fennecs na di team wit di lowest shot conversion rate among di quarterfinal teams wit 4.17%.
Dem neva get even one shot on target for dia game against Nigeria wia dem only score one goal for di group stage from 13 shots.
Coach Benstiti admit say tins bin dey tough but di team go do beta.
"Na true tin say we bin score only one goal, but we still get di same target (to qualify for di next stage)."
"For dis quarterfinal, na 50/50 game, we gat to be more efficient than Ghana, we go continue to attack," Benstiti tok for pre-match press conference.

Wia dis foto come from, CAF ONLINE
But for Ghana coach Kim Lars Björkegren, di black queens gat to maintain dia form from di last game.
Kim Lars Björkegren tok say "Algeria na good team for defence, wia dem gat ogbonge goalkeeper. We go make tins difficult for her."
"We no fit dey shoot from 45 yards and expect to score her, we gat to create beta chances and take dem all."
Kim Lars Björkegren add say "di game na difficult game but I dey sure say we go play good game against dem."

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM
Key players and wetin dem tok
Algeria goalkeeper Chloe N'Gazi na ogbonge player for dem wey she go be key player.
She tok say "we go try to reach di semifinals. Dis na ogbonge responsibility for us. We neva go make anitin bother us."
She bin keep clean sheet for di three group games.
Na so dem bin name her as di best goalkeeper for di group stage; ahead of di reigning goalkeeper of di year Chiamaka Nnandozie from Nigeria.
But she go dey tested for dis game versus Ghana, but she dey confident.
Anoda player wey bin dey key for di fennecs na Ghoutia Karchouni.
Di 30-year-old na di player wey score dia only goal for di tournament so far v Botswana to win only dia third nations cup game in 11 years.
She say she go try to help di team for dis ogbonge match.
For di black queens, dem go hope say dia key players - Chantelle Boye-Hlorkah wey bin win woman of di match for dia last game, go turn up.
Also di coach expect midfielder Jennifer Cudjoe and captain Portia Boakye to dey in form.

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM
Ghana also bin dey welcome striker Doris Boaduwaa from suspension afta she miss di last game.
Princella Adubea wey replace Doris against Tanzania bin play well wey she score one goal, but she bin hurt bifor di game end.
So Doris gat di chance to start against Algeria.
Di game go happun at 4PM GMT (5PM WAT) for di stade municipal de Berkane.
Join us for di live text commentary for dis ogbonge game.
Algeria go make history ?
Or Ghana go qualify for di semifinal ?
Make una join us make we find out ..














