Burkina Faso military rulers scrap electoral commission, take control of future election

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Chris Ewokor & Damian Zane
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Burkina Faso military rulers don disband di kontri electoral commission, call am waste of money.
Di interior ministry go handle elections in di future, state-run RTB TV report.
Since dem seize power in September 2022, di coup leaders don initiate sweeping reforms, including di postponement of elections wey go lead to a return to civilian rule.
A nationwide vote bin dey due last year, but di junta bin extend di period of transition to democracy until July 2029, e allow leader Capt Ibrahim Traoré to remain in power and free to contest di next presidential election.
Di AFP news agency quote Territorial Administration Minister Emile Zerbo say di electoral commission dey "subsidised" wit around $870,000 (£650,000) a year.
To scrap di commission go "reinforce our sovereign control on di electoral process and at di same time limit foreign influences", e bin add.
Afta e come to power three years ago for middle of criticism say di civilian authorities dey fail to deal wit one growing Islamist insurgency, di military leaders don reject di assistance of former colonial power France in favour of Russia.
Rights groups since don accuse di army say dem dey target civilians for attempt to quash di militants, as well as suppress political activity and di freedom of expression.
Question marks also dey over di effectiveness of di military operation. In di first half of 2025, jihadist group JNIM tok say dem don carry out over 280 attacks in Burkina Faso – double di number for di same period in 2024, according to data wey di BBC verify.
Additional reporting by BBC Monitoring and David Bamford.









