Govnor Monday Okpebholo fit stop Peter Obi from visiting Edo state?

Collage of Edo state govnor Monday Okpebholo and Peter Obi

Wia dis foto come from, Monday Okpebholo/X, Peter Obi/X

Read am in 7 mins

Popular Human rights lawyer, Femi Falana [SAN] don chook mouth for wetin di Govnor of Edo state, Monday Okpebholo bin tok for a recent political rally wey bin happun for Uromi, Esan North East Local Goment Area.

Di Edo State Govnor, Monday Okpebholo bin warn di former Labour Party presidential candidate, Peter Obi, make e no enta di state if im no tell am or get security clearance.

Dis statement don draw many reactions sotay di human rights lawyer chook mouth.

For statement, Femi Falana say Govnor Monday threaten di life of Peter Obi and e dey against di constitution.

Femi Falana quote wetin Govnor Monday Okpebholo bin tok "A new sheriff don dey in town. Im [Peter Obi] no go just come into Edo without informing me. Im security no go dey guaranteed. If anything happun to am for hia, im go get imself to blame. I no dey joke."

For di statement, oga Falana say "di threat to di life of Mr. Peter Obi issued by di "new sheriff in town" for Edo State, na violation of section 33 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria 1999 as amended and article 4 of di African Charter on Human and Peoples (Ratification and Enforcement) wey guarantee di fundamental right of evri citizen to life.

Oga Falana add say in view of section 14(2)(b) of di Constitution wey tok say di security and welfare of di pipo go be di primary purpose of goment.

Im say make Govnor Okpebholo withdraw di threat, and make im apologise publicly to Mr. Peter Obi and assure am of safety of im life for Edo State.

Di Human rights lawyer for im statement advice Peter Obi say if Govnor Okpebholo no withdraw di illegal threat sake of arrogance or raw power, make Peter Obi proceed to file application for di Benin Judicial Division of di Federal High Court to secure di enforcement of im fundamental right to life.

Oga Falana also advice Obi to take action sharp-sharp sake of how mob justice and oda forms of extra judicial killings dey happun for di kontri,

Govnor Okpebholo bin also allege say di last time di former Anambra state govnor visit Edo state wen e donate 15 million naira to one nursing school, crisis happun afta e comot, wey lead to di death of three pipo. BBC Pidgin don reach out to di state police command to verify dis claim, but dem neva reply yet.

Di govnor sama dis warning on Friday, 18 July for Uromi, Esan Northeast Local Government Area wen e dey receive some politicians wey decamp from di opposition Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC).

Oga Peter Obi neva react to di comment wey govnor Okpebholo make.

For 8 July, Peter Obi bin tweet on X about im visit to Philomena College of Nursing Sciences for Benin City, Edo State, wia e donate 15 million naira give dem to improve healthcare delivery.

How Nigerians react to di govnor statement

However, plenty Nigerians wey include di PeterObi Obidient Media Centre don react to di govnor statement.

For statement wey dem post on X, di Obidient Media Centre disagree wit wetin di Edo state govnor tok, as dem say Nigeria constitution guarantee di right of every Nigerian citizen to move freely and reside in any part of di kontri.

Dem say dis no be di first time dis dey happun, as di govnor of Benue state bin issue similar threat against dia principal wen e visit di state for goodwill and charity.

Di statement add say make Nigerians no see dis threat as small mata, as Nigeria belong to everybody, and no individual, no matter how highly placed, suppose try divide di kontri by inciting violence or wit dia words.

"We wish to alert Nigerians plus di international community say make dem no take dis threats lightly. If anytin untoward happun to im Excellency Peter Obi, make Nigerians know wia to look. Dis governors na di chief security officers of dia respective states, and dia utterances carry weight – no be just in words, but in potential consequences."

Di Interim tok-tok pesin for Africa Democratic Congress (ADC), Bolaji Abdullahi for im reaction say Peter Obi na free citizen and e no need di govnor clearance to visit Nigerians for dia own kontri.

"Edo State na Nigerian State. Di govnor statement betray deep insecurity. Wen a Governor begin panic ova courtesy visits and modest donations, na clear sign say sometin dey deeply wrong somewhere.

"Leaders wey don serve di pipo well no dey bother wen odas receive clap. Perhaps, di pipo wey dey celebrate PO simply dey remind di Edo state govnor di kind of leader e suppose be," Oga Abdullahi tok.

Labour Party govnorship candidate for di 2024 election, Olumide Apata say, "Peter Obi no need anyone permission to visit Edo State or any oda State for dat matter. Not now, not ever."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

Di Edo state govnor comments dey come as reports say di Kaduna state police command don stop one rally wey supporters of Peter Obi dey plan in honour of im birthday for di state, as dem cite security concerns.

For one statement on Saturday, 19 July, di police tok-tok pesin Mansir Hassan tok say di rally dey happun di same day one primary elections dey hold for di state, and e fit lead to gbasgbos and break down of law and order.

"Intelligence information wey di command receive na say certain criminal elements dey plan to intrude and hijack di proposed rally, and use am as platform to cause disruption, incite violence, and disturb the prevailing public peace for di state."

Di police warn say e go take necessary legal action against any individual or group wey violate di directive.

Oda times state govnors stop politicians from coming to dia state

Dis no be di first time a state govnor go kick against di visit of a politician to a state without security clearance from di govnor.

For April, di Kogi state goment bin ban rallies and public gatherings for di state, ahead of di homecoming ceremony of di suspended senator wey dey represent Kogi north-central Natasha Akpoti-Uduaghan to her constituency.

Di state goment bin cite security breach as dem say di intelligence reports wey dem receive show say some pipo dey plan to "stage some violent rallies in di guise of political and religious agitations" for Kogi Central.

Di commissioner of Information Kingsley Fanwo add say di state goment don direct say anybody wey wan enta di state wit convoy of security personnel must "obtain prior clearance from state commands of di deploying services.

Benue state goment for April also say any high profile pesin wey wan visit di state must get clearance from di govnor, Hyacinth Alia.

For one statement wey di Chief Press Secretary, Tersoo Kula, bin issue at di time, e say, "For anyone wey dey consider to visit Benue State without di knowledge or approval of di govnor, e dey important to reconsider, as dia safety and security no fit dey assured,"

Di statement further direct di individuals or organisations wey dey plan to visit Internally Displaced Persons (IDP) camps must obtain written clearance from di Benue State Emergency Management Agency (BSEMA).

Although, di goment no mention names for di statement, but di directive bin draw immediate criticism from many wey believe say di target na di Labour Party 2023 presidential candidate, Peter Obi, wey bin dey plan humanitarian visit to IDP camps for di state.

Meanwhile, Edo state govnor don deny say im threaten Peter Obi.

Inside statement signed by his Chief Press Secretary, Fred Itua, on Sunday, di govnor claim say im remarks dey misinterpreted.