'Why I miss Buhari burial' – Peter Obi

(R-L) - Peter Obi wear black shirt wit prints, black cap and wear glass, Nasir El-Rufai wear white kafta wit black cap and glass, former Vice president Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Peter Obi/Facebook

Read am in 3 mins

Dem don bury former Nigeria president Muhammadu Buhari wey die on Sunday.

Di state burial wey di Federal goment organise happun on Tuesday for Daura, Katsina state, Northwest Nigeria.

Dis na a day afta dem declare public in honour of di former president.

Many pipo including Nigeria President Bola Tinubu, leaders of foreign kontris and diplomats follow for di crowd of mourners wey land for Daura.

Also, ogbonge political leaders – both from the ruling and opposition parties lead by former Vice President Atiku Abubakar also full for dia.

But pesin wey many pipo notice im absence na Peter Obi, leader of di Obidient Movement. A group of young and energetic supporters of di opposition leader wey contest and pull crowd for di 2023 presidential election as a first timer.

Many pipo bin dey wonder why Oga Peter Obi no show for di burial. Dis also generate many reactions for social media.

Peter Obi tok why e miss Buhari burial

Foto of Peter Obi and oda politicians for Daura, Katsina state

Wia dis foto come from, Peter Obi/Facebook

Wetin we call dis foto, Foto of Peter Obi (wearing black shirt wit prints, black cap and wear glass) and oda politicians for Daura, Katsina state

Peter Obi na popular voice among young pipo for Nigeria wey don come to appreciate im economic lifestyle.

Most times dem dey like to see am ontop national platforms and dem don begin ginger am again to contest di 2027 presidential election.

Though e miss di former President burial, Peter Obi later join new set of mourners wey land for Daura on Wednesday - one day afta di burial.

E join former Vice President Atiku Abubakar, Nasir El-Rufai and oda opposition leaders to visit di family of di deceased former leader.

"E dey hard for me to come yesterday [Tuesday] becos like dem tok bifor, e bin dey very hard to get flight to enta Katsina," Obi tell BBC for interview for Daura.

E add say "Even wen you get di flight, e dey hard to land for di airport becos e don full. And mourning period na yesterday, today and tomorrow. And whoever dey hia now still dey part of di mourning"

Peter Obi profile

Peter Obi na politician and businessman. Im na also di presidential candidate of Labour Party for di 2023 general elections.

Im na former govnor of Anambra state for southeast Nigeria.

E serve two term between 2008 to 2016.

Oga Obi bin dey All Progressive Grand Alliance (Apga) before e join PDP for 2017.

Im also be sabi pesin for wetin concern economy matter.

For 2019, e come out as vice presidential candidate of Atiku Abubakar. But dis year 2022 e don decide to go for di president position.

Peter Obi say im administration as president go create jobs, boost Nigeria economy, and improve education.