From military ruler to democrat - ex-Nigeria President Buhari life in pictures

Muhammadu Buhari siddon in front of a Nigerian flag and sign wey say United States Institute of Peace. Im wear a black top, black cap and glasses.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

    • Author, Wedaeli Chibelushi
    • Role, BBC News
  • Read am in 6 mins

Muhammadu Buhari life track di dramatic changes for politics in Nigeria ova di last five decades – and often times im bin dey at di centre of events.

Di former Nigerian president, wey die on Sunday at di age of 82, become di kontri military leader afta one coup, di new junta send am go prison, and den decades later im reinvent imsef to win di presidency for democratic election.

For most of im pictures im bin dey wear dark glasses or thick, black-framed spectacles, im traditional zanna cap and e like to smile, much of Buhari life play out for public.

Black and white photo show Buhari as im wear suit and tie and stand besides King Gustaf and Sheikh Yamani

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Buhari - picture hia na for 1977 wit di den-King of Sweden Carl XVI Gustaf and Saudi Arabia Sheikh Ahmed Zaki Yamani for 1977 - begin im military career straight out of school.

By di time dem take dis picture, Buhari don rise to become a regional military commander.

A few years later, for 1983, sojas overthrow elected President Shehu Shagari.

Buhari, wear military uniform, stand for di back of an open top vehicle. Three oda men for military gear also dey di car, e look like say dem bin dey for arena.

Wia dis foto come from, Sygma via Getty Images

Although Buhari bin take di role of military ruler, im deny tori say im plot di coup, according to am senior commanders install am becos dem need figurehead. Oda accounts describe Buhari say im play a more active role for di takeover.

Afta two years of iron-hand rule, wit im crusade against corruption and various human rights abuses, dem remove Buhari. Di new junta bin place am under house arrest for three years.

For 2003, following decades away from politics, Buhari decide again to try again to lead di ckontri.

Dis time, im bid for di top job through a democratic election - e run for di All Nigerian Peoples Party (ANPP).

Buhari, im running mate Chuba Okadigbo and Chairman of di All Nigerian Peoples Party Don Etiebet, smile and raise dia two hand.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Hia see am for right, wit im running mate Chuba Okadigbo on di left and ANPP chairman Don Etiebet.

Olusegun Obasanjo beat Buhari for 2003, and im bin make two oda unsuccessful runs for di presidency for 2007 and 2011.

Despite dis failed bids, im accumulate supporters, including disaffected youngsters, wit im pledges to fight corruption and insecurity.

Young protesters in action for di streets of Kano - one hold a picture of Buhari aloft, a couple of odas carry bits of wood. Grey smoke dey di background.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

For one packed rally, supporters clamour to touch Buhari, wey stand above di crowd, dey smile. Im wear blue top and blue hat.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

One woman pose next to a poster of Buhari. She wear a grey top wey dem write "APC" and "Buhari".

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

APC campaign billboard bear di words "we will defeat Boko Haram #EveryNigerianCounts". Di words dey accompanied by a picture of a soldier wey carry gun.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Buhari bin dey very popular for northern Nigeria, di region wia dem born am.

One makeshift figure of Buhari, wit dis words "Sai Baba Inshallah", stand for di middle of a dusty road. one motorcycle zoom past.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Hia, na one sign wey dem bin display for di city of Kaduna during di 2015 election, wey tell passers-by say pipo dia go only vote for "Baba" Buhari.

Buhari eventually win di election for 2015, e beat di incumbent President Goodluck Jonathan.

Im break record, as im become di first ever opposition candidate to win a general election.

Di historic moment wen Jonathan call Buhari to concede dey captured on camera.

Muhammadu Buhari, wear white long-sleeved top and white cap, im raise im mobile phone for im ear.

Wia dis foto come from, Red Media Africa

But afta im finally enta office, Buhari first term bin no smooth. Di economy enter recession for di first time in a decade and security crises pile up.

Wen Buhari wife - her picture dey down - publicly criticise im administration, di president sparked outrage wen im say she belong to di kitchen.

Buhari stands next to im wife. Both of dem wear dark sunglasses and white outfits.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Despite di challenges for im first term, Buhari win re-election for 2019.

As di president of one of Africa largest economies, im bin travel around di world, to attend high-profile summits and meet im fellow heads of state.

Buhari and Queen Elizabeth dey tok for dis picture, dem dey smile togeda. Di Queen wear blue suit jacket on top of one pink top, while Buhari wear black jacket, white shirt and patterened hat.

Wia dis foto come from, John Stillwell/Getty Images

Queen Elizabeth bin greet Buhari for di Commonwealth leaders gathering for 2015.

Barack Obama bin dey out of focus for dis picture, e dey look Buhari, wey bin dey tok and look straight ahead.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Earlier for 2015, den-US President Barack Obama bin welcome am to to White House.

Donald Trump and Muhammadu Buhari - both in formal dress - in discussions while walking past some columns at the White House.

Wia dis foto come from, Getty Images

And for 2018, Buhari become di first leader from sub-Saharan Africa to meet President Donald Trump for Washington.

Muhammadu Buhari and Narendra Modi, both wear white outfits, shake hands for one formal photo opportunity.

Wia dis foto come from, Hindustan Times via Getty Images

Wetin we call dis foto, For 2015, Buhari travell to India for India-Africa summit and Prime Minister Narendra Modi greet am

Following im death, for one clinic for London, Buhari dey remembered by some as a man wey break im campaign promises and crush dissent.

For odas, im be champion of order wey bin try im best wit di dysfunctional political system.

For one tribute to im old rival, Jonathan describe Buhari as someone wey "bin dey selfless for im commitment to im duty and serve di kontri wit character and a deep sense of patriotism".

One person display one newspaper wey carry di headline wey report Muhammadu Buhari death. Three men appear for di background of di image, wey dey out of focus.

Wia dis foto come from, Reuters