Tinubu pay im last respect as dem bury late Muhammadu Buhari

Dem bury former president Buhari for inside im compound for im hometown Daura on Tuesday

Summary

Live Coverage

Victor Ezeama & Adesola Ikulajulo

  1. Una bye bye

    Dis na wia we march break for our coverage of di burial of former Nigeria president Muhammadu Buhari.

    Dis na di summary of our live updates on di event.

    • Tinubu pay last respect to Buhari
    • Body of Nigeria former president land Daura from London
    • Eight important facts about di life of di late Muhammadu Buhari
    • Why Buhari former minister, Rotimi Ameachi dey trend?
    • Goment declare public holiday ahead of former President Buhari burial on Tuesday

    We thank una as una tanda wit us throughout di coverage. Una bye bye

  2. Tinubu pay last respect to Buhari

    Tinubu wave to Buhari bodi

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Nigeria President, Bola Tinubu pay im last respect to im predecessor Muhammadu Buhari, former president.

    Tinubu bin receive di bodi of late Buhari for Katsina as dem move di bodi for burial for di late president hometown.

    Oga Tinubu in company of im oda goment officials bin dey present as dem lay di bodi of Buhari to di ground.

    E wave to di bodi as sign of respect bifor dem move am to di grave.

    Di president don alreadi order say make all national flags fly at half-mast across di kontri for seven days, from Sunday 13 July to 20 July.

    E also add say di Nigeria goment go give President Buhari full state honours wey befit im full contributions to di kontri, and na wetin happun today.

    For May 2023, Buhari hand-ova to Bola Tinubu as President of Nigeria.

    Dem bury di former president under di islamic rites.

    Tinubu siddown as e watch Buhari bodi

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, President Tinubu watch di bodi of late Buhari
    Some men in agbada bin carry di bodi of di late Buhari

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, Pipo say prayers for di bodi of Buhari
    Tinubu pay im last respect as dem bury late Muhammadu Buhari

    Wia dis foto come from, Presidency

    Tinubu pay im last respect as dem bury late Muhammadu Buhari

    Wia dis foto come from, Presidency

  3. Late Buhari bodi lower to di ground for Daura

    President Buhari grave

    Wia dis foto come from, TVC

    Di bodi of di former Nigerian president, Muhammadu Buhari wey die on Sunday don finally enta ground for im hometown, Daura, Katsina State.

    Di bodi of Buhari way accompanied by Vice President Kashim Shettima, and President Bola Tinubu receive am wit oda top goment officials.

    According to late Buhari former aide Tolu Ogunlesi, na inside di late former president compound dem bury am.

    Dem recite funeral prayers for Buhari bifor dem lower di bodi of Buhari to di ground amidst tears and sad mood.

    As di bodi dey enta gorund, dem fold di Nigerian flag wey dem use wrap im boid and hand am ova to di family.

    Di sound of gunfire bin rent dia air as a mark of farewell to di late Buhari

    During di burial, di family of late Buhari and relatives bin gada wit tears as dem surround di remains while dey cry and say some prayer for am.

    Di pikin of di late president bin get di chance to tell dia papa bye-bye bifor e enta ground.

    Among dose wey paid dia respect to di bodi of di late former president include: current President of Nigeria, Bola Tinubu, Vice President Kassim Shettima, First Lady Oluremi Tinubu and oda top dignitaries..

    Also, international leaders such as Gambia president Adama Barrow, Mahamat Déby of Chad and Umaro Sissoco Embaló of Guinea-Bissau, as well as a delegation from di military govment of di Republic of Niger led by Prime Minister Ali Lamine Zeine, and oda ministers and religious scholars.

    Former President of di Republic of Niger, Mahamadou Issoufou, also attended the funeral.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Men dressed in agbada wit cap bend down

    Wia dis foto come from, TVC

    Wetin we call dis foto, Moment wey dem lower bodi of Buhari to di ground
    Grave wey dem cova

    Wia dis foto come from, AIT/Facebook

    Wetin we call dis foto, Dem cova di grave of Buhari as e take final journey home
    Buhari grave

    Wia dis foto come from, TVC

  4. Who attend Muhammadu Buhari Burial?

    President Bola Tinubu receive Buhari body

    Wia dis foto come from, Bayo Onanuga

    Presidents, Govenors, foreign leaders, goment officials, top military officers, traditional leaders and businessmen attend di burial ceremony of Nigeria former leader Muhammadu Buhari.

    Buhari die on Sunday, July 13, 2025, for London hospital.

    President Bola Tinubu receive di remains of former President Buhari for di Umaru Musa Yar'Adua International airport for Katsina.

    Vice President Kashim Shettima, Chief of Staff to di President Femi Gbajabiamila, na some of di ogbonge.goment officials wey show face for Katsina.

    President Tinubu, along wit Vice President Kashim Shettima, President Umaru Sissoco Embaló of Guinea-Bissau, Prime Minister of Niger, Ali Lamine Zeine, former President of Niger, Issoufou Mahamadou, and former Vice President Yemi Osinbajo, na dem receive di casket of di late president.

    Di 2015 Peoples Democratic Party candidate Atiku Abubakar aand Imo state Governor Hope Uzodima also dey dia.

    Odas wey show face for Katsina na di joint team of military pallbearers wey include nine senior officers wey carry di casket, wey dem cover wit Nigerian flag, for trolley.

    Di team include Major-General Mohammed Usman, Major-General Oluwafemi Williams, Major-General Shuaibu Nudu, Rear Admiral Suleiman Dahun, Rear Admiral Jonathan Ajodo, Rear Admiral Samuel Ngatuwa, Air Vice Marshal Adeniyi Herbert Amesinlola, Air Vice Marshal Idi Sanni, and Air Vice Marshal Obinna Obiabaka. Major General Mike Alechenu coordinated the team.

    Di burial ceremony take place for Buhari hometown for Doura Katsina state on Tuesday.

  5. Tinubu receive former President Muhammadu Buhari body, Sad mood fill di air for Katsina,

    Military officials bring down Buhari bodi

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, Dis na how di military officials bring down di bodi of Buhari from di airplane

    Di bodi of late Nigeria former President Muhammadu Buhari don finally land for Daura wia dem go bury am today.

    Sad mood, black outfits and emotions fill di atmosphere as dem dey comot di bodi of late Buhari.

    Dem bring di bodi of late Buhari down from di airplane wey carry come Katsina.

    As all attention dey for Daura, Katsina State for di burial, di mood of di pipo dey sad as dem dey mourn di death of di former President.

    President Bola Tinubu bin receive di bodi of di late Buhari as military officials bin carry di remains.

    Buhari die on Sunday for one London hospital afta a period of sickness.

    Di 82-year-old bin serve as Nigeria president two times: first as head of state for 1983 and den im win election for 2015.

    Dem go bury di late Buhari according to di Islamic rites, wia pipo go also pay dia respect to am.

    As Nigeria President Tinubu don declare seven days of National mourning, e show say several pipo go attend to pay dia respect to late Buhari.

    A military official looking at di remains of Buhari covered wit Nigeria flag

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, President Tinubu touch di remains of late Buhari
    Military officials accompany di bodi of late Buhari wit oda officials by di side

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, First Lady Oluremi Tinubu pay her respect to di late Buhari
    Military officials gada holding a casket wit Nigeria flag

    Wia dis foto come from, Abdulaziz Abdulaziz

    Wetin we call dis foto, Dis na how dem carry di bodi of late Buhari to wia dem wan bury am
    Military officials gada holding a casket wit Nigeria flag wit airplane for background

    Wia dis foto come from, Abdulaziz Abdulaziz

    Wetin we call dis foto, President Tinubu accompany bodi of late uhari to wia dem go bury am
  6. Former Nigeria VP Atiku arrive Daura for Buhari burial, El-Rufai and odas land Katsina to pay dia respect

    Atiku wit oda officials

    Wia dis foto come from, Atiku Abubakar/X

    Former Vice President of Nigeria, Atiku Abubakar don show for Daura, Katsina State.

    Atiku arrive for Daura for Tuesday afternoon wia e go attend di internment.

    "I just arrive for Daura for di interment of former President Muhammadu Buhari," e write for im X.

    Atiku arrive in entourage of Nasir El-Rufai wey dem gada recently form coalition.

    Who be Atiku?

    Atiku na former Vice President of Nigeria from 1999 to 2007.

    E get Master in international relations from Anglia Ruskin University, UK.

    E be former customs officer wey come into politics for early 1980s.

    Atiku contest to be president of Nigeria for 1993, 2007, 2011, 2015 and 2019,but e no wokr out.

    Atiku na one of di major PDP members wey pull out dat time to form di New-PDP and later enta di APC just bifor di 2015 general election, but shortly afta dat election, e return to di PDP and na im be di party presidential candidate in 2019 and 2023.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Atiku greet one man wey bend to greet am

    Wia dis foto come from, Atiku Abubakar/X

  7. Eight important facts about di life of di late Muhammadu Buhari

    Former president Buhari in military uniform

    Wia dis foto come from, Muhammadu Buhari

    Di former Nigerian president, na one of di kontri most beloved figures, e die at di age of 82.

    Na one politician wey im politics dey different from di rest, e dey quiet and courageous.

    Buhari dey among di few Nigerian leaders wey dey honest.

    Di former president tok-tok pesin, Femi Adesina, tok say "No way to link Buhari to corruption".

    Most of di pipo love Buhari becos of im honest and law-abiding nature.

    • E no spend too much time wit im papa

    Dem born Muhammadu Buhari in December 1942 for Daura, Katsina State, 18 years bifor Nigeria gain independence.

    Im Fulani papa die wen Buhari bin dey four years old, na only im Kanuri mama raise am.

    For one interview in 2012, Buhari tok say im be di 23rd child of im papa side and di 13th for im mama side.

    • Chadian military offensive in Nigeria dismantled

    One of di tins wey make Buhari reputation spread for Nigeria na im command of one Nigerian battalion for one fight between Nigeria and Chad.

    E happun for 1983, when Chadian troops occupied some islands in Lake Chad.

    • Short military rule

    In the final months of 1983, di military hijack di goment of former president Shehu Shagari.

    Buhari, dat time hold di rank of major general, become di military leader afta di coup.

    Buhari tok say im no dey among di pipo wey start di coup, dem just install am, and di same pipo later remove am.

    E bin spend just 20 months for office.

    • Fighting against corruption

    During Buhari time for power in Nigeria, many tins change.

    Wetin pipo go take remember about im first term for office na im policy of fighting corruption.

    Di goment arrest around 500 politicians on corruption charges.

    Some see dis policies by di Buhari administration as tyranny, while oda see dem as commendable step in din fight against corruption, wey fit destroy di kontri and prevent di kontri progress.

    During dat time eem bin arrest famous musician Fela Kuti on suspicion of money laundering.

    • Imprisonment afta di coup

    Afta 20 months in power, dem hijack Buhari goment, den General Ibrahim Babangida take power.

    Afta di coup, e catch am and throw am for prison for 40 months in Benin City.

    Dem release Muhammadu Buhari for December 1988, afta im mama die.

    • Petroleum Transfer Fund (PTF)

    Since im release, Muhammadu Buhari return to simple life den di Nigerian military General Sani Abacha appoint am as di chairman of di Petroleum Resources Fund (PTF).

    Dem use di money wey dem generate from di fuel price increase for development projects.

    • E try three times bifor e succeed

    Muhammadu Buhari enta politics in di early 2000s, to return to di presidency.

    In 2003, he run for president, but former president Olusegun Obasanjo defeat am.

    E run for president again in 2007, but former president Umaru Musa Yar'adua win.

    In 2011, afta e run for third term, Buhari announce say im go retire from politics.

    At di time, e tok say, "Dis na di third and final time for me. I no go run for president again. I no need anything and I no get anytin tok wey I neva tok bifor."

    • Return as civil goment

    However, two events bring Buhari back into politics in 2015 elections. Security and economy.

    As former president Goodluck Jonathan don almost finish im tenure high living standard, allegations of corruption and security concerns dey on di rise, particularly Boko Haram. Some politicians in di kontri seize dis opportunity to bring Buhari to power.

    Buhari become di elected president in 2015, na di first opposition leader to defeat di incumbent president since di kontri return to democracy in 1999.

    • Sickness worry am

    Afta returning to power, one of di biggest challenges Buhari face na sickness.

    Buhari spend plenti time for sickbed during im administration seeking medical treatment, especially during im first tenure.

    E get one time wey e spend 50 days for London wia e dey receive treatment.

    Some believe say di late president health play big role in im failure to fulfil some of im commitments.

  8. Breaking, Body of Mahammadu Buhari arrive Katsina

    Buhari corpse

    Wia dis foto come from, Abdulaziz Abdulaziz

    Body of late president Muhammadu Buhari don touch ground for Umaru Musa Yaradua airport, Katsina state.

    Na wit tearful eyes family and oda Nigerians take watch as Nigerian military officers respectfully carry di body of former President Muhammadu Buhari down from di plane

  9. President Bola Tinubu arrive Katsina to receive bodi of late Buhari

    President Tinubu wit im official arrive for Katsina

    Wia dis foto come from, Sunday Dare/X

    President Bola Tinubu don arrive Katsina to receive di bodi of di late Muhammadu Buhari, im predecessor.

    Na Buhari bin hand-ova to Tinubu for May 2023 as President of Nigeria under same party, APC.

    President Tinubu bin land Katsina wit oda govment officials to pay dia respect to di late Buhari.

    Dressed for im usual agbada and logo cap, Tinubu enta Katsina through flight bifor e begin waka go wia e go receive di bodi of im late predecessor.

    Dem go bury di former president under di islamic rites.

    Tinubu receiving certificate from Buhari

    Wia dis foto come from, MBuhari/X

  10. Why Buhari former minister, Rotimi Ameachi dey trend?

    Rotimi Amaechi

    Wia dis foto come from, Rotimi Amaechi

    Former Govnor of Rivers State Rotimi Amaechi dey trend for social media sake of di cloth wey im wear for di Burial of di late former President Muhammadu Buhari

    Ameachi wey server as minister of Transport under Buhari administration wear a traditional turban in honour of im chieftaincy title.

    Amaechi, bin collect di title “Dan Amanar Daura” wey mean (Trusted Son of Daura) for February 2022.

    Daura na di hometown of di late President Buhari.

    Dis na some of tins pipo dey tok about Ameachi outfit

    @Rheedwhan say ''Alhaji Rotimi Amaechi wit laughing emoji, Nigerian politicians no be good pipo''.

    And @sire_sommy say ''For those wey say na politics, Rotimi Amaechi na titled man for Daura.

    While @EddyHeavens say ''Rotimi Amaechi dressed in turban to Buhari burial, Man dey seek attention''.

    Meanwhile @rolad4yct say ''Sheikh Rotimi Amaechi say We get too much comedians as our politican''.

    Di former Govnor and minister join oda dignitaries to pay im final respect to di late former Nigerian leader wey die on July 13 for London United Kingdom.

  11. Life and times of former Nigerian leader Muhammadu Buhari

    Nigeria former president Buhari

    Wia dis foto come from, Muhammadu Buhari

    Nigeria President Muhammadu Buhari, wey die at di age 82 na one former military ruler and self-styled converted democrat wey return to power through elections but struggle to convince Nigerians say e fit deliver on di change e promise.

    E no be natural politician, pipo see am as pesin wey dey difficult and pesin wey no send anybody.

    But e get reputation for personal honesty – one rare character of a politician for Nigeria.

    Afta three failed attempts, Buhari bin achieve ogbonge historic victory for 2015, as e become di kontri first opposition candidate to defeat incumbent. For 2019, e dey re-elected for anoda four-year term.

    Buhari always dey popular among di poor pipo wey dey north (wey dey known as di "talakawa" for Hausa language) but for di 2015 campaign, e bin get di advantage of one united opposition wey tanda strong for im side.

    Many of those wey support am bin reason say im military background and disciplinarian credentials na wetin di kontri need to handle di Islamist insurgency for di north. Buhari also bin promise to tackle corruption and nepotism for govment and create employment opportunities for young Nigerians.

  12. World leaders send condolences to Nigeria and late Buhari family

    Buhari saluting in military uniform

    Wia dis foto come from, X/MBuhari

    Wetin we call dis foto, Buhari bin die for London

    Plenti world leaders don send condolences to Nigeria and di family of di late former Nigeria President, Muhammadu Buhari wey die for London.

    President Cyril Ramaphosa of South Africa

    South African President Cyril Ramaphosa don also offer im "deep condolences to di family, friends, former colleagues and associates of di late President Buhari."

    President Julius Bio of Sierra Leone

    Also, Sierra Leone president Julius Maada Bio describe Buhari death as a "devastating loss".

    Akinwumi Adesina

    On im part, former president of di African Development Bank (AfDP), Akinwumi Adesina, tank Buhari for im "leadership, patriotism and selfless service to Nigeria".

    African Union

    Di Chairperson of di African Union Commission, H.E. Mahmoud Ali Youssouf, on behalf of di African Union Commission and di wider African Union family, don tok sorry to di Government and pipo of Nigeria, and di bereaved family of late President wey die on Sunday, 13 July at di age of 82.

    Speaker of di House of Representatives Abbas Tajudeen say di passing of former President Muhammadu Buhari na heavy blow.

    President Narendra Modi of India

    President of India, Narenda Modi describe di death of Buhari as sad.

    "I fondly recall our meetings and conversations on various occasions. Di wisdom, warmth and unwavering commitment to India–Nigeria friendship wey e get bin stand out"

  13. Follow BBC News Pidgin WhatsApp channel

    WhatsApp logo

    Wia dis foto come from, Getty Images

    For all di updates on Buhari burial and more tori dem, follow di BBC News Pidgin WhatsApp channel

  14. Niger Republic military goment send delegation to Buhari burial

    A delegation from the Republic of Niger being welcomed by representatives of the Nigerian Government in Katsina State for the burial of late former President Buhari

    Wia dis foto come from, Imran Muhammad/X

    Delegation from di military govment of di Republic of Niger don arrive for Katsina State, to take part for di funeral of di late former Nigerian President Muhammadu Buhari.

    BBC News Hausa report say di leader of di delegation na di Prime Minister of di kontri, Ali Lamine Zeine, plus oda top govment ministers and religious leaders.

    Govnor Dikko Umaru Radda of Katsina State, di Minister of Budget and National Planning, Atiku Bagudu, and di Minister of Information, Muhammad Idris na di pipo wey welcome dem on behalf of di goment.

    Di Republic of Niger bin enjoy a very cordial relation ship wit Nigeria wen Buhari be president.

    In 2021, Buhari bin perform di groundbreaking ceremony of a railway project from Kano State, northwest Nigeria to Maradi city for Niger Republic.

    "Di connection to Niger Republic thru rail go also foster Trans-Sahara trade and contribute to di expected gains for di African Continental Free Trade Area Agreement," Buhari tok dat time.

  15. WATCH: Nigerians react to death of Buhari

    Wetin we call dis Video, Nigerians get mixed feelings about dia former President wey die at age 82.

    From e time as military leader, to wen e serve as democratic president, Nigerians get mixed feelings about dia former President wey die at age 82.

    BBC News follow some Nigerians tok for different parts of di kontri to get dia reactions on di death of former Nigeria President.

    "E fit get pipo wey enjoy from am, but I bin no benefit from am."

    Dis na wetin one Nigerian bin tok wen e dey react to di death of Buhari.

    Anoda one tok say Buhari na ogbonge leader to am and dem go miss am.

  16. Nigeria first lady Remi Tinubu arrive Daura

    First Lady Remi Tinubu arrives at Katsina Airport

    Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

    Di wife of Nigeria President, Oluremi Tinubu, don land for Daura, Katsina State, for di funeral of Buhari.

    Mrs Tinubu dey accompanied by di wives of some top politicians, including di wife of di Speaker of di House of Representatives, Fatimah Abbas; wife of di Deputy Senate President, Laila Barau; and di wife of National Security Adviser, Zarah Ribadu.

  17. Former transport minister Amaechi arrive early for im 'boss' burial

    Rotimi Amaechi

    Wia dis foto come from, Rotimi Amaechi

    Former minister of Transport Rotimi Amaechi follow for di first set of guests for Daura Katsina state.

    Rotimi Amaechi arrive di town wearing turban as im na title holder for di former president hometown.

    For 2022 dem turban Amaechi as Ɗan Amanar Daura, title wey e still dey hold till today.

    Rotimi Amaechi

    Wia dis foto come from, Rotimi Amaechi/Facebook

  18. Flight rader show air traffic to Katsina

    Flight rader show say many aircrafts dey enta Katsina state.

    E dey clear say na sake of di funeral of di former President wey dey happun today.

    Flight rader

    Wia dis foto come from, Flight Rader

  19. Goment declare public holiday to honour former President Buhari burial

    As Nigeria President Bola Tinubu don declare seven days of National mourning, di Federal govment don also declare Tuesday, 15 July, 2025, as a public holiday to honour di late former President of Nigeria, Muhammadu Buhari.

    Minister of Interior, Dr Olubunmi Tunji-Ojo, make di announcement on behalf of di Federal goment afta di approval of President Tinubu.

    "Di Minister say di holiday na a mark of respect for di late President service to di nation, im contributions to Nigeria democratic journey, and im legacy for governance and national development," according to di statement by Dr Magdalene Ajani wey be di Permanent Secretary of di ministry.

  20. Welcome to di live coverage of President Buhari burial

    Muhammadu Buhari foto

    Wia dis foto come from, Getty Images

    All attention dey for Daura, Katsina State and we dey to bring una live updates of di burial of Nigeria former President Muhammadu Buhari.

    Buhari die on Sunday for one London hospital after a period of sickness.

    Di 82-year-old serve as Nigeria president two times: first as head of state for 1983 and den im win election for 2015.

    Make you tanda wit us.