Goment declare public holiday ahead of former President Buhari burial on Tuesday

Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Muhammadu Buhari/Facebook

Wetin we call dis foto, Buhari, 82, die for one hospital for London on Sunday, 13 July, 2025.
Read am in 4 mins

Katsina state govment don announce di burial arrangement for former Nigeria president Muhammadu Buhari wey die for one hospital for London and im burial go take place on Tuesday while di federal govment declare public holiday.

According to di statement from Katsina State govnor, Malam Dikko Umaru Radda, di bodi of late Buhari go arrive Nigeria on Tuesday 15 July.

Di govnor say dem take di decision afta dem consult wit di late 'president family and close associates for London'.

"We don agree say di remain of di former leader go arrive Katsina tomorrow, Tuesday, July 15, 2025, by 12 noon."

Di burial of late Buhari go now happun for Daura, di hometown of di late President, by 2:00 p.m. on di same day.

"We pray Almighty Allah to grant im soul eternal rest and reward am wit Aljannatul Firdaus. We also condole His Excellency, di President and Commander-in-Chief of di Armed Forces Bola Ahmed Tinubu, ova di passing of im predecessor," di govnor tok.

Nigeria Vice President and oda delegates sitting for London afta death of former Nigeria president

Wia dis foto come from, Presidency

Nigeria govment declare public holiday to mourn late Buhari

As Nigeria President Bola Tinubu don declare seven days of National mourning, di Federal govment don also declare Tuesday, 15 July, 2025, as a public holiday to honour di late former President of Nigeria, Muhammadu Buhari.

Minister of Interior, Dr Olubunmi Tunji-Ojo, make di announcement on behalf of di Federal goment afta di approval of President Tinubu.

"Di Minister say di holiday na a mark of respect for di late President service to di nation, im contributions to Nigeria democratic journey, and im legacy for governance and national development," according to di statement by Dr Magdalene Ajani wey be di Permanent Secretary of di ministry.

Dem say make citizens use di day to honour di late President memory.

Also, di National flags go fly for half mast for di seven days of mourning period from Sunday 13 July, 2025.

Body of late President Buhari go return from London for a simple burial for Daura

Di body of late President Muhammadu Buhari return from London to Daura im hometown for Katsina state wia dem go give am simple burial.

Buhari die for one London hospital on Sunday at di age of 82.

Guvnor of Katsina State, Dikko Radda, who already dey for London wit Buhari family tell tori pipo say dem go bury am later dis Monday for Daura town, about 80 kilometres from di state capital.

Nigeria Vice-President Kashim Shettima and di Chief of Staff of President Bola Tinubu, Femi Gbajabiamila, also fly into di UK capital early Monday to accompany Buhari body home.

"I just leave im family for di hospital wia e die and di decision be say we go take im body to Daura for burial," Radda tell tori pipo.

Nigeria VP wear black dress wit oda women wey wear black outfit too

Wia dis foto come from, Presidency

Also in a social media post, Vice President Shettima confirm say na for Daura dem go bury Buhari.

E tok say Buhari bin die afta small sickness but e no tok di exact sickness wey e suffer from. However, Buhari bin don dey sick for many years now.

In line wit Islamic religion, dem go bury Buhari as quickly as possible for simple ceremony, according to weitn one Islamic cleric Abdullahi Garangamawa tell di BBC.

"Di only tin wey fit stop di burial of Buhari bodi today [Monday] na if im body arrive Daura for night bicos Islam no dey allow night burials. In dat case, Tuesday morning go dey ok," di cleric tok.

Tributes still dey pour in for di late army general who be one of only two pipo wey don led Nigeria two times, both as military and civilian president. Di oda pesin na former President Olusegun Obasanjo wey dey 88 years old now.

Former President Goodluck Jonathan, who Buhari bin win for di 2015 election, don describe di late leader as someone wey "dey selfless for im commitment to im duty and bin serve di kontri wit character and deep sense of patriotism".

Also, former military head of state Ibrahim Babangida, who Buhari bin overthrow in a coup in1985, shower praises on di late president.

"He na man wey, even for retirement, e remain moral compass to many, and na example of modesty for public life,” Babangida tok.

President Bola Tinubu dey expected to attend di funeral prayer for Daura, and e don declare seven-day national mourning period in honour of im predecessor.

Tinubu say di nation go pay dia final respect to di former leader wit dignity and honour, and e go wit bringing down all national flags to half-mast across di kontri from Sunday.

Nigeria Chief of Staff dress in suit wit Vice president Shettima wit oda men wey dey stand

Wia dis foto come from, Presidency