Ghana bounce back from slow Wafcon start, thrash Tanzania to enter quarterfinal

celebration

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S FOOTBALL TEAM/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Dominant second half for Ghana as dem thrash Tanzania 4-1 to qualify for quarterfinal
Read am in 10 mins

Di Black Queens of Ghana don qualify for di quarterfinal of di Wafcon 2024 wit emphatic 4-1 win ova Tanzania.

Ghana start di game well wia dem score first for di 12th minute; striker Princella Adubea bin press di Tanzania keeper wey she force her to boot di ball wey now hit her back and enta di net.

Stumai Athumani from Tanzania grab one fine goal from tight angle afta dem put pressure for di black queens bifor halftime.

Afta di break Ghana start beta again but dem no fit break di Tanzania defense until di 63rd minute wen Princess Marfo bin win penalty - Alice Kusi step up to score 2-1.

But as time dey go, Tanzania try to equalize, dem put pressure for di Ghana backline bifor substitute Stella Nyamekye combine wit her fellow substitute Evelyn Badu for di third goal.

Stella cross di ball from di edge of di Tanzania box, wia Evelyn turn and tap di ball into di goal afta small confusion for di box.

As di game dey end, na so woman of di match Chantelle Boye-Hlorkah don collect one pass inside di box wey she place di ball beyond di keeper for 4-1.

At di end, na Ghana get emphatic victory to qualify for di quarterfinal in second place wit four points from three games.

For di oda game, South Africa knack Mali 4-0. Mali bin finish third for di group also wit four points but wit (-3) goal difference compared wit (1) goal difference for Ghana.

Mali also qualify as one of di best third place teams for di competition.

Ghana go meet Algeria for di quarterfinal. Nigeria go face Zambia, Morocco go jam wit Mali wey South Africa go play wit Senegal.

Second Half

scene from the game

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S NATIONAL TEAM/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Ghana bin create plenti chances for di first half but one defensive error mean say dem enta di break 1-1

FULLTIME!

90+5" Referee don blow whistle to end di game. Ghana win di game against Tanzania 4-1

Chantelle Boye-Hlorkah na woman of di match.

Wit dis score and di one for di oda game 4-0 to South AFrica, Ghana fit to qualify for di quarterfinal.

90+2" Ghana bin dey try to hit Tanzania for di counter now, as dem bin try to score for di oda end.

Ghana coach im substitutes wey bin change dis game for di last 10 minutes - Stella Nyamekye and Evelyn Badu.

Dem bin add 5 minutes for dis game, di Ghana coach Lars bin dey celebrate for di sidelines afta di fourth goal bin enta di net. Im go fit breathe now.

+5 mins

89" GOOOOOAAAAL! Chantelle Hlorkah don score for Ghana. She collect di ball inside di box afta Ghana counter wey she pick her spot and beat di keeper 4-1

Dis goal bin seal di win for Ghana for dis game.

GOOOOAAAAAL! Substitute Evelyn Badu don score from di freekick. Nyamekye Stella bin hook di freekick inside di box wey Badu turn and tap di ball inside di net. 3-1

85" Freekick to Ghana for di edge of di Tanzania box, afta Stella Nyamekye don dey enta di box bifor dem hack her down.

UPDATE: South Africa don score goal number 4. Donelly bin score di goal. Di defending champions don dey thrash Mali.

83" From di freekick di ball don end up for di Tanzania players, wia dem try to build one attack but di ball don spoil.

Foul. Tanzania Captain Opa Clement don foul Princess Marfo.

81" Chance for Ghana from di corner, di ball bin dey hang for air, Evelyn Badu jump to challenge di keeper but she no sabi wia di ball dey again, wey keeper collect am.

80" Ten minutes more for either of dis teams to grab anoda goal. Corner to di black queens, Alice Kusi bin win dis one.

Dangerous freekick for Tanzia! but di ball from Diana Msewa don go ova di bar

77" Chance for Tanzania! Di ball bin dey hang dangerously inside di Ghana box, but dem bin clear dia lines. Tanzania also bin dey change player. Donisia bin dey comot

Time bin dey run out for Tanzania to grab di equalizer.

75" Both teams bin dey lose di balls for di transition. Wey dem don dash plenty passes for dis game. But who fit to score di next goal?

Ghana bin dey prepare to change. Some of di players don taya. Evelyn Badu don enta di game to replace Princella Adubea wey don hurt.

73" Tanzania don dey get momentum small small.

Goal scorer Princella Adubea don sit for ground, na so dem carry am on top stretcher to di sidelines

71" Ghana bin dey want penalty inside di Tanzania box but ref wave play on. For di counter from Tanzania, Opa Clement no fit reach di ball.

70" For di last 30 seconds, Ghana bin dey dash di balls for di midfield - Josephine Bonsu bin dash di pass first bifor anoda Ghana defender pass to her opponent.

69" Di defender don dey receive treatment on top di pitch bifor dem carry her comot to di sidelines.

67" Ghana bin dey try to create anoda chance thru Princess Marfo again but she don foul her defenser inside di Tanzania box wey di chance don spoil.

66" For dis game, Tanzania dey try to get quick equalizer. But whenever dem try to attack, dem dey meet roadblock for di Ghana defense.

UPDATE: South Africa don score dia third goal. Hilda Magaia bin score di goal. 3-0

Wit dis goal, Ghana don get 4 points now, back to second.

GOOOOAAAAL! Alice Kusi bin take di ball wey she score. 2-1

Di black queens go fit score? Di Ghana bench bin dey celebrate for di touchline.

PENALTY! Ref don award penalty to di black queens. Princess Marfo bin enta di box wia Anastazia Katunzi don hack am for ground.

Di Tanzania coach Bakari Shime bin dey watch for di touchline.

58" Di long balls from Ghana to di Tanzania area no dey find di black queens. everitime dem go play di ball, na Tanzania player go collect.

Tins don dey shake for now, as both teams bin dey ballon di balls for di center wey dem dey dash dash balls.

56" Ghana now bin dey try to create sometin but goalkeeper Nadjati don comot her line to collect di ball wia Chantelle bin dey chase.

Game don start again.

Small break now. Dem bin dey escort Donisia off di pitch

Freekick to Tanzania afta Grace Asantewaa don foul Donisia Minja. Ref don show her yellow acrd wey she call medical team.

53" Tanzania don try to counter wia dem get 3 v 2 chance but Ghana clear dia lines bifor one player play shot from far.

52" Josephine Bonsu don try to enta behind di defense to cross but she bin win corner wey Alice Kusi don take.

Corner to Ghana!

51" Ghana continue to play wey dem play one shot from di edge of di box but di Tanzania keeper don catch di ball

50" Princess Marfo don fall for ground afta she try to enta di box. She bun dey want penalty but referee no gree.

49" Throw-in for di Tanzania area, Josephine Bonsu bin throw di ball inside - e neva find a Ghana pesin, Tanzania bin collect di ball.

From di ball, Tanzania attack, goalkeeper Cynthia catch di ball.

48" Ref don collect foul for Tanzania afta Msewa don fall for ground afta Princella Adubea im tackle.

47" Goalkeeper Cynthia Konlan catch one long ball wey she kick di ball towards Chantelle for one quick attack but Tanzania clear.

Dem bin take di freekick fast fast but di attack don breakdown.

Freekick. Jennifer Cudjoe don foul Diana Msewa for di center.

46" Ghana alreadi bin try to pepper di Tanzania area thru Chantelle Hlorkah, but Tanzania clear dia lines.

Players don return for di park.

Wit di results now South Africa 2-0 Mali, and Ghana v Tanzania 1-1, Banyana Banyana gat 7 points, Mali gat 4 points, Ghana and Tanzania get 2 points each.

celebration by ghana

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN NATIONAL TEAM/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Princella Adubea don pressure di Tanzania goalkeeper afta one backpass wey di ball hit her back wey e enta di net

First Half

Halftine

45+3" Referee don whistle for throw-in to Tanzania bifor she bin blwo for halftime.

45+2" Tanzania captain bin fall for ground afta one aeriel ball wit Comfort Yeboah

Ghana again bin dey try to get anoda goal bifor di halftime. But di Tanzania keeper bin catch di ball.

+3 mins

Chance! Princess Marfo get chance but her left shot dey weak, wey Tanzania keeper don catch am

Princess MARFO don vex dey complain about one poor pass from her teammate.

44" Ghana now try for di wings, dem cross di ball but Tanzania clear am away.

43" Since dat goal wey bin shock di Black queens, Tanzania don get confidence now.

Di Ghana defense don sleep for dia wey Tanzania capitalize to score. 1-1

40"GOOOOOOOOAAAAL! Tanzania don equalize. Stumai Athuman don score from tight angle afta Tanzania freekick.

39" Ghana bin waste all dia corner kicks so far, anoda one na di one Portia Boakye don play wia Tanzania clear am.

Ghana don win corner kick, Princella Adubea don pressure di Tanzania defense wia she win corner.

38" Chantelle Hlorkah don dash di ball to her opponent for di Tanzania area.

Again di freekick na poor one, Tanzania try to build dia own attac

37" Freekick to Ghana afat Lydia Kabambo don hook Marfo fro di far right of di Tanzania area.

Yellow CARD for Tanzania. Donisia Minja don hack down Ghana captain Portia Boakye.

34" Chaaance for Ghana! Chantelle Hlorkah din ballon on chance ova di bar wit ogbonge chance.

Wit di South Africa result now, Ghana don dey second.

UPDATE: South Africa don score second goal from a freekick. Captain Refiloe Jane. 2-0 for South Africa v Mali.

29" Ghana keeper Konlan bin dey ground, medical team don enta di park

From di freekick, Lydia don balloon her ball ova di bar.

28" Lydia Kabambo dey try to beat her marker to cross one ball into di box, but dem bin foul her.

CHAAAANCE! Aisha Mnunka bin dey wait inside di Ghana box for one cross from di Ghana left side, but ghana defenders clear di ball.

27" Tanzania bin try to create sometin wia dem nearly score.

26" Anoda wasted corner, Tanzania don clear wia dem try to begin counter attack

Corner to Ghana! Dis time Marfo im cross bin hit di Tanzania defenderAnastezia Katunzi.

25" Marfo bion dey get plenty joy for di left hand side of di Tanzania area - but her crosses dey poor so far.

23" Wasted! From di freekick, Portia play di ball inside di Tanzania area but di ball no fit meet any Ghana player wia e go out of touch.

22" Foul! Goalscorer Princella Adubea don fall for ground afta foul, di Ghana captain Portia Boakye bin dey tok di ref to book di player but di ref no mind am.

UPDATE: For di oda game na Lebohang Ramalepe wey score di goal for South Africa for di 5th minute v Mali.

Di midfield don set, both teams dey battle for dia but Ghana bin dey find di spaces

21" Ref don vex wit Ghana keeper Konlan wey she bin dey warn her say she dey waste time. If she continue di ref fit show her card.

CHAAANCE! Tanzania captain Opa Clement don enta di Ghana box wey she try to shoot, but di ball enta di side net.

19" Captain Portia Boakye bin play di corner but Chantelle Hlorkah no fit connect to di ball wia di chance vanish.

Black queens player comfort Yeboah don fall for ground but dem bin win corner.

18" Ghana bin dey try to get second goal but so far Tanzania bin dey defend well.

16" Tanzania don enta di black queens box, di strikers bin dey chase one long ball ova di top. Goalkeeper Cynthia Konlan bin comot to catch di ball.

15" Chance for Ghana from one freekick in front of di Tanzania box, but di keeper don catch di freekick.

Tanzania try to pass di ball from di back wey dia keeper Najiati Idrisa clear di ball, but di ball hit di black queens striker wey bin dey pressure her for dat goal.

key players for Ghana and Tanzania

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S NATIONAL TEAMS/TANZANIA FOOTBALL FEDERATION/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Both teams go comot di tournament if dem play draw on Monday

GOOOOAAAAL! Ghana don score. Striker Princella Adubea don put pressure on top di Tanzania keeper wia di ball enta di net. 1-0

11" Wit dis scoreline for di oda game, Ghana gat no oda option but to win dis game if dem wan stand chance to qualify, Tanzania also fit qualify if dem win dis game.

Update for di oda game between South Africa and Mali, di Banyana Banyana don score early goal 1-0.

9" Tanzania captain Opa Clement bin try to create sometin but her pass go striaght to di Ghana area wia di black queens captain Portia Boakye don collect di ball, but later dem foul Opa.

8" Dem bin foul Jennifer Cudjoe for di midfield wia referee whistle for foul. Freekick to Ghana.

7" Tanzania now dey try hold possession small, but black queesn don collect di ball

So far di black queens dey pepper di Tanzania area, anoda chance bin go ova di bar.

6" Chance for di black queeens as dem carry di ball enta di Tanzania area but di striker balloon her ball ova di bar.

3" Ghana bin try already to start quick quick, but di Twiga ladies dey hold dia own.

1" Referee don blow whistle to start di game, Ghana wey pass di ball for center circle.

Ghana don repeat dia all yellow jersey wia Tanzania bin dey wear dia traditional blue jersey wit black shorts.

Center referee na Dorsaf Ganouati, assistant 1; Houda Afine, assistant 2 – Mmahawa Kourouma and di fourth official na Ghada Mehat.

Welcome everibody to dis live text commentary for Ghana v Tanzania for di Wafon 2024, final group C round of games.

Line-up

Ghana XI: Cynthia Konlan (GK); Susan Duah, Grace Asantewaa, Jennifer Cudjoe, Princess Marfo, Chantelle Hlorkah, Princella Adubea, Kusi Alice, Comfort Yeboah, Portia Boakye ©, Josephine Bonsu.

Tanzania XI: Najiati Idrisa (GK); Anastazia Katunzi, LidyaKabambo, Donisia Minja, Opa Clement ©, Stumai Athuman, Aisha Mnunka, Diana Msewa, Julitha Singano, Esther Marwa, Enekia Lunyamila