US tech CEO resign afta Coldplay concert embrace go viral
- Author, Ana Faguy
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
One US tech company say dia chief executive don quit afta dem clearly catch am on one big screen for one Coldplay concert as e dey embrace one female co-worker, for inside one clip wey don go viral.
Astronomer for statement tok say: "Andy Byron don tender im resignation, and di Board of Directors don accept."
Di clip bin show as one man and one woman dey hug on one jumbo screen for di arena for Foxborough, Massachusetts, bifor dem suddenly stop and hid from di camera.
US media identify di pair as Mr Byron, one married chief executive of Astronomer, and Kristin Cabot, di firm chief people officer.
Di BBC neva fit independently confam di identities of either pesin for di video.
Di company statement on Saturday say: "As we tok bifor, Astronomer dey committed to di values and culture wey don guide us since our founding.
"Our leaders dey expected to set di standard in both conduct and accountability, and recently, dat standard non dey met."
Di New York-based tok say dia board go begin search for di next leader and dia chief product officer go continue to serve as di interim CEO.
Di video of di pair as dem dey gyrate to one music for Wednesday night concert and as dem quick try to hide bin gain millions of views.
Afta e see say di two of dem hide, Coldplay lead singer Chris Martin tell di crowd say: "Either dem dey get affair, or dem just dey very shy."
Astronomer bin announce say dem dey launch investigation into di relationship and dem place di CEO on leave shortly afta di video bin go viral.
Di original video wey pesin post for TikTok get millions of views. Den pipo start to dey share am across platforms and turn am to memes and even yab dem for television shows.
Two days afta di internet start to ginger ontop di viral clip, Astronomer come release statement say dem go investigate di mata, but dem no tok say na di video.
Di statement say, "Astronomer dey committed to di values and culture wey don guide us since we start. Our leaders dey expected to set di standard for both conduct and accountability. Di Board of Directors don start formal investigation into dis mata and we go get more informate to share soon".
Plenti tori don comot say di man wey bin dey di viral video na Astronomer CEO Andy Bryon wey don dey di company since July 2023. But oga Bryon neva comot to confam say na im dey di video.
Online pipo say di woman na Kristin Cabot, di company chief pipo officer, wey don dey di company since November 2024. She neva comot to confam say na she dey di video too.
Astronomer statement add say Oga Byron neva release personal statement, plus tori say e don drop statement no be true. E also say no oda employees dey di video.
Fake statements from oga Byron bin go viral on Thursday, 17 July.










