Ghana dey tight corner for Wafcon afta draw wit Mali

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S NATIONAL TEAM/FACEBOOK
Di Black Queens of Ghana now dey without a win fro di 2024 Wafcon wey dey go on for Morocco.
Dem play 1-1 draw wit di female eagles of Mali for di West African derby for group C.
Ghana bin dominate di first half wia dem create plenty chances bifor dem score dia goal thru Kusi.
Mali also try to create sometin for dat first half but dem no fit get dia goal.
For di second half, di game change as Mali bin dey control wey dem manage to equalize thru Traore.
Wit dis result, Ghana im chances to qualify dey slim.
Mali now get four points from four games, South Africa bin dey play Tanzania wia di defending chances gat di firepower to win to qualify.
Now Ghana gat to beat Tanzania for dia last group game to see if dem fit qualify as one of di best third place teams.
Ghana coach go dey worried say im team no fit take all three points from dis game.
But for Mali coach Mohammed, dis result na good result to push dem to di next stage.
For di last group games, South Africa go face Mali, wey Ghana go face Tanzania.
How tins go go for those games, and Ghana fit to qualify for di knockout stage?
Na time go tell.

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S NATIONAL TEAM/FACEBOOK
Second Half
FULLTIME!
Di game don end 1-1. Na poor result for Ghana as dem still dey without a win for two games for dis Wafcon.
90+5 Dis last minutes na Mali dey for control but ref don blow whistle for di end of di game.
90+4" Di pressure now bin dey on Ghana as Mali now dey create chances for di last minutes.
90+3" Chaaance! From di corner Mali get chance to score but di player im shot dey wide. Her coach don dey go mad for touchline.
Time now don dey go.
90+2 Mali bin get corner for di Ghana left side. Dem go take time to play dat ball.
+5 mins
89" Afta some treatment Karentao don get up. Dem bin add 5 mins to di game.
88" CHANCE for Ghana! Asantewaa play ogbonge pass to Adubea, her first touch dey poor, na so di ball dey close to Karentao, wia she catch am, but she clash wit Adubea, so she dey for ground.
87" Jennifer Cudjoe bin dey try start one attack for Ghana from di back, she pass to her goalkeepr Konlan wia she also play to Chantelle.
86" Ghana shoot one ball from outside di box, but Mali clear am, di ball neva spoil, Ghana take am, back wey dem pass to midfield.
85" Time don dey pass now, every time Mali go make pass, dia fans go chant. Ghana also bin dey try everitin to carry di ball enta di box but dem no dey succesful so far.
Mali get one chance wey dem balloon di ball ova di bar, dia coach Mohammed don frustrate.
81" Ghana bin dey try to start one attack but di black queens player Princess try too many tricks wey she lose di ball, bifor Chantelle Hlorkah foul her marker.
80" 10 minutes to di end of dis derby game, but stiull 1-1. Any of di two teams fit grab late goal to win di game? Na time go tell.
79" From di freekick meters away from di center circle, Ghana bin hook one long ball into di Mali area. Captain Boakye wey play am into di hands of di Mali keeper.
Anoda Ghana player bin dey for ground, captain Boakye. She bin dey receive treatment. Di stops bin dey slow down di game wey e dey scatta di momentum for both teams.
76" Mali bin dey make anoda change, Angiessa Diarra don comot for Fatimata
75" Mali bin dey string some fine passes togeda bifor lose possession, Ghana attack straightforward; di ball fall to Adubea, but instead say she go pass di ball, she bin shoot from distance ova di bar.
74" Now Ghana swing di ball to di far right of di Mali area but she carry di ball go back instead say she go enta di box.
73" Mali bin dey control di ball for di far end wit dia player holding di ball wia she bin dey dribble di Ghana defender, but she carry di ball go back to di midfield.
Time don dey run out for dis two teams to find dia second goal for dis game. Di game don equal now.
71" Di game don reach di final 20 minutes. Ghana bin dey make anoda change, Josephine bonsu dey enta di game to replace Anastesia Achia.
Anoda freekick just around di center area for Ghana afta Assisat Trore bin dey ground again.
69" Mali dey attack Ghana now, substitute Cone bin dey try to create sometin but di ball bin end up for di leg of Marfo wey try to start her own attack but di ball don spoil.
Dat na clash between di Ghana captain Boakye and Aissata Traore. Traore receive treatment wia ref continue di match.
67" Referee wave play on. From di goalkick, Mali try to attack but ref blow for foul for di midfield.
66" Princess get di ball inside di Mali area, she beat her marker and try to cross di ball, but she fall for ground. Di Ghana coach bin dey shout for penalty for di bench.
65" Mali bin throw one long ball wia bin dey trouble di Ghana keeper but she allow di ball to go ova di bar.
63" Marfo bin dey hold di ball wey she try to take on her marker, she bin dey look for foul from di ref but di ref still dey play on. She finally release di ball to her teammate bifor las las di chance don vanish.
62" Mali bin try to create a chance from di right hand side of di Ghana area but dia cross na cool chop for goalkeeper Cynthia Konlan.
61" Mali also bin change Kadidiatour Diabate wia she dey replaced by Cone.
60" Princess Marfo and Adubea don enta di game to try and change sometin for di black queens.
59" Angiessa Diarra don play one weak shot wia Konlan don catch, simple. Wasted chance.
Chance for Mali from dis freekick.
58" Since di goal, di game don open, Mali bin get freekick for di edge of di Ghana box afta Jennifer Cudjoe bin foul her marker.
Mali now dey try to control di game but di black queens bin dey spoil all dia attacks so far.
56" Di game don become disjointed. Both teams no fit to string di passes well. Anastesia don mishit her cross from di left hand side ova di bar for Ghana.
55" Goalkick for Mali. Badu don hit one ball wide.
54" Mali don begin to dey pile pressure afta dat goal. Dem bin dey hold di ball wia dem dey build attacks.
51" GOAAAAL! Mali don equalize thru Aissata Traore. She don beat her defender wia she use di side of her boot hit di ball into di net. 1-1
50" Coulouba Sogore don get up afta di treatment wia she dey waka around, she dey okay to continue.
Na head injury to di Mali player now. She don crash her head wit Boaduwaa as dem bin dey try to reach di cross.
Injury to one Mali player inside di box as Ghana fly di cross towards Boaduwaa. Ref bin call di medical team.
48" Dis time di corner dey cleared by Mali wey dem win goalkick, dem gat to try to build dia own attack from di back - Mali.
47" Comfort Yeboah don take di corner kick into di Mali box but di ball comot for anoda corner.
Achia don throw onelong ball from di far side into di mali box, but di ball go out for corner to Ghana.
Di Ghana captain Boakye bin dey clear everytin from di midfield
46" From di restart di black queens try to attack di Mali area but dem bin clear di ball.
Players don comot for di second half. Ghana bin pass di ball.

Wia dis foto come from, CAF
First Half

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN'S NATIONAL TEAM/FACEBOOK
Halftime
45+6 Di referee don whistle for halftime wit 60% possesion for Ghana, 40% for Mali. 9 total shots for Ghana, 1 for Mali.
Jennifer Cudjoe don foul Aissata Traore for di halfway line. She don receive treatment bifor Mali take di freekick into di Ghana box.
45" Dem add 6 minutes.
43" Game don restart wey Ghana take di corner into di Mali box. Di ball dey dangerous but Ghana no fit take advantage, wey Mali bin clear dia lines.
42" As di halftime don dey reach, Ghana fans dey sing out loud to cheer dia players. For di Mali bench, dia keeper injury dey worry dem. Di keeper still dey receive treatment on di park.
40" Corner to Ghana. Mali goalkeeper Fatimata Karentao don dey for ground afta she bin comot to try and prevent Boaduwaa from reaching di ball.
39" Di game don turn scrappy, as Mali player bin hack down Chantelle Hlorkah.
Mali take di freekick thru Anguiessa but Ghana clear dia lines bifor di ball go out for goalkick.
38" Yellow card for Yeboah afta she foul Traore. Di Mali striker bin dey try enta di Ghana box, bifor Yeboah bring her down near di corner flag.
35" Chaaaance! Ghana fail to take dat chance. Chantelle Hlorkah bin dribble wey she cross one fine ball into di box, Boaduwaa head di ball wia Anastesia Achia gat to head into di net, but she head di ball wide. Ogbonge miss!
Fans for di stadium bin dey sing and chant since di first whistle.
Afta treatment to Traore di game don restart; but di tempo don reduce.
32" From di freekick, Mali bin get chance inside di box, Aissata Traore jump to meet di cross wit her head but she don use hand hit di Ghana defender. Referee blow whistle for freekick against Mali.
Freekick for di center line for Mali now.
31" So far Kandidiatou and Saratou wey bin score Mali dia only goal v Tanzania bin dey struggle to get any clear chance for di Ghana area.
Di black queens dey quick, whenever dem lose di ball, dem dey press hard to get di ball back immediately.
29" Mali bin win thorw-in but dem lose di ball immediately to Ghana
Di freekick no be dangerous, Ghana clear dia lines. Chantelle Hlorkah don hassle her marker wia she win possession for Ghana.
27" Referee bin dey warn Yeboah afta she foul Diabate. Freekick to Mali.
25" Yellow card for Fatou Dembele afta she hack down Kusi for di far side. Na di second Mali yellow card for dis game.
23" Chance for Ghana but ova di bar! Di black queens dey try to create sometin but as Grace Asantewaa enta di area, her shot enta row z!
22" Chance! Mali striker Kandidatou don enta di box wey she strike di ball but Duah don block di ball bifor Kandidiatou fall for ground dey call for penalty.
21" Trouble for Ghana at di back; Candidiata Diabate try to pounce on one Ghana backpass, but di ball go out for goalkick.
20" Aguiessa Diarra don turn well for midfield bifor she release di ball to di far side but Ghana clear am.
19" Chance! Ghana striker boaduwaa pick one long ball wey she cutback into di area but her counterpart im poor touch carry di ball away from her side wey Mali defender use bug boot clear di ball.
Di game don open now. Grace Asantewaa try to pass di ball but her pass dey weak, wey e go di side of di Malians.
18" Mali carry ball go di left hand side of di Ghana area, di mali striker beat one defender but her cross dey weak, na so Ghana bin clear am.
Mali dey try to create sometin for diaserf but whenever dem try dia pass dey go to Ghana player.
16" Offside! Kusi find herserf inisde di Mali area dey try to pounce on one ball bifor she fall for ground. Ref already bin blow whistle for offside.
Di black queens dey find soaces behind di Mali backline but dem no fit to carry threaten di Mali goal.
12" Comfort Yeboah, Chantelle Hlorkah bin dey pass di ball between dem bifor dem pass to Cudjoe but di cross into di box from Asantewaa no find her teammate, na so Fatoumata Karentao don save am.
Game don restart, wit Ghana trying to attack di Malians again.
10" Yellow card to Fatoumatou Diarra afta she foul Ghana midfielder Jennifer Cudjoe.
Referee don dey tok to two players now number 17 from Ghana (Boakye) and number 14 (Aissata Traore) from Mali.
8" Mali don retart di game afta dem treat one of dia players for dat goal.
6" GOOOOOAAAAAL! Ghana score di first goal thru dia striker Boaduwaa head di ball on target from Chantelle imm cross but Kusi don use acrobatic kick opush di ball ova di line. 1-0
Plenty of di ball dey inside di Mali area for di past minutes, but di black queens no fit take advantage.
4" Pressure now dey for di female eagles of Mali, bifor refree whistle for foul inside di Mali box. Coulouba Sogore don dey for ground.
Now di black queens dey try to create sometin. Ghana bin win throw inafta Kani Konte clear di ball for di far side.
2" Ghana don win throw in, Comfort Yeboah bin dey get plenty touches on di ball for di black queens.
Mali bin dey control di gam,e so far wit dia passes
1" From di whistle Mali try to possess di ball wey dem pass for dia backline bifor dem clear am inisde di Ghana area.
Referee don blow whistle for di game to start! Legooooooooooooooo!
Ghana dey wear yellow jersey wia Mali dey wear dia traditional white jersey
Di weather dey hot but di two teams dey focus on di football.
Welcome everibodi to dis West African derby gam,e between Ghana and Mali.






