Abrego Garcia wey ICE detain fit get possible second deportation

Abrego Garcia look ahead as im land for ICE field office for Baltimore, wit supporters wey put dia hands for im shoulders as a show of support

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Abrego Garcia land for ICE field office, as im supporters surround am
    • Author, Tom Geoghegan and Kayla Epstein
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Kilmar Abrego Garcia dey for ICE custody afta im arrive for di US Immigration and Customs Enforcement (ICE) office for Baltimore.

For statement, Secretary of Homeland Security Kristi Noem confam im arrest and tok say ICE "dey process am for deportation".

Dem bin deport am to one notorious prison for El Salvador for March, and den bring am back to face criminal charges.

US authorities don tell am say dem fit deport am to Uganda, as im no gree accept a plea deal, im lawyers tok.

Im legal team dey accuse di US say dem dey try to "force" am to plead guilty as dem dey threaten to re-deport am "halfway across di world".

Wetin we call dis Video, Watch: Supporters rally as Abrego Garcia is detained

"Di only reason wey dem don chose to take am into detention na to punish am, to punish am for exercising im constitutional rights," one of im attorneys, Simon Sandoval-Moshenberg, told reporters outside di ICE office.

E tok say Mr Abrego Garcia bin file new federal lawsuit for Maryland wey dey challenge im current detention and potential deportation "to Uganda or any oda kontri " until im get trial.

One subsequent court order bin bar goment from removing Mr Abrego Garcia from di continental United States or change im legal status until 16:00 Wednesday, unless judge extends di order.

Dem don assign di new lawsuit to US District Judge Paula Xinis, di same jurist wey bin dey oversee di initial lawsuit ova Mr Abrego Garcia deportation by mistake to El Salvador.

Dem don tok say dia client bin decline an offer to plead guilty to human smuggling charges to exchange for deportation to Costa Rica. Dem bin ask am to check in on Monday for di field office for Baltimore.

During di interview, Mr Sandoval-Moshenberg say ICE officers bin carry Mr Abrego Garica into custody wit no explanation. One officer bin tell attorneys say dem go put am for detention center but dem no specify di exact one.

Im attorney argue say ICE no get any reason to detain Mr Abrego Garcia, as im bin dey under ankle monitoring and "basically on house arrest".

His supporters don dey fear say dem fit deport am second time- dis time to Uganda, a kontri wey im no get any known ties.

Supporters bin hold rally outside di premises to support of di Salvadorean national, wey im immigration case don make global headlines.

For statement, Ms Noem allege say Mr Abrego Garcia bin dey guilty of human trafficking and domestic abuse. President Donald Trump no go allow am to "terrorise American citizens any longer".

Di US bin reach bilateral deportation agreements wit Honduras and Uganda as part of di Trump crackdown on illegal immigration.

Documents wey CBS News, wey be di BBC US partner bin get, quote Uganda foreign ministry wey tok say dem prefer individuals wey dem accept to be from African kontris.

Di saga of Mr Abrego Garcia deportation case don dey for news since March wen dem bin deport am to im native El Salvador, and initially keep am for notorious Cecot prison.

But afta di US goment officials acknowledge say dem deport am sake of "administrative error", one judge order di administration to facilitate im return.

Dem bin send am to Tennessee wia im bin dey charged for human smuggling scheme and dem bin detain am until dem release am on Friday afta ruling by one federal judge.

Mr Abrego Garcia don plead not guilty to di charges.