Lucky Igbenidion: EFCC arrest former Edo state governor over N1.6 billion fraud allegation

Wia dis foto come from, EFCC
Nigeria corruption police, di Economic and Financial Crimes Commission don confam di arrest of former govnor of Edo State, Lucky Igbinedion.
Di tok-tok pesin for di commission, Wilson Uwajuren tell BBC Pidgin say dem carry oga Igbinedion go dia Abuja headquarters to answer questions concerning 1.6 billion naira public funds wey allegedly miss road.
Tori be say Edo State goment bin collect di money as loan but di money waka enta company wey oga Igbinedion allegedly get hand inside.
But dis no be di first time di govnor wey im tenure run from 1999 to 2007 dey face wahala for EFCC hand.
For 2008, EFCC secure conviction on top im head for embezzling 2.9 billion naira wey belong to Edo State.
Dem sentence am to six months im prison afta im plead guilty to one out o di 191 count charges dem bin bring against am.
Who be Lucky Igbinedion?

Wia dis foto come from, Instagram/@osasuigbinedion
Lucky Nosakhare Igbinedion become di governor of Edo state under di platform of Peoples Democratic Party (PDP) on May 29th 1999 after democracy return.
Dem born am on 13 May, 1957. Im rule di state from 1999 to May 29, 2007.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Lucky go school for University of Wyoming, and Jackson state University wia e do im Bachelors for Marketing and im Masters for Business.
For 1987 dem appoint am as di Mayor of Oredo Municipality wey dem bin call local goment dat time.
Tori be say for di last year of im Mayorhood, dem vote am as di best Mayor for Nigeria.
Dem go remember im administration for human capacity development and for di fight against human trafficking and prostitution, di fight wey im wife Eki Igbinedion bin lead.
After e comot office, di Economic and Financial Crimes Commission declare am wanted on January 2008 on 142 counts of financial fraud.
Di allegations na say e embezzle 24 million dollars i.e 12 million pounds using fake companies.











