Abdulrasheed Maina: Court sentence former pension boss to eight years inprisonment for money laundering

Di Federal High Court, Abuja don sentence Abdulrasheed Maina, di former oga of Pension Reform Task Team to eight years in prison afta dem find am guilty of money laundering charges.
Di trial judge, Okon Abang, wey deliver di judgement on Monday say Mr Maina tiff over N2 billion Pensioners moni.
Di court say di prosecutor, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring correct evidence through witnesses to prove beyond reasonable doubt say Maina dey guilty of money laundering in di sum of N171,099,000.
Di Court say Maina dey guilty of asking staff of Fidelity Bank to open bank accounts for am without conducting any due diligence.
Di court also say e dey guilty sake of say e hide im identity as signatory to accounts wey im open for UBA and Fidelity bank wit di identity of im family members without dia knowledge.
Di accounts dem bin get cash deposit wey reach N300 million, N500 million and 1.5 billion Naira.Di court say Maina tiff di moni wey belong to pensioners becos e no fit prove wia e get di moni wey dey I'm account from.Trial judge, Justice Okon Abang also say if you put all Maina moni togeda as civil servant e no reach all di moni dem wey dey im account.Di court say di prosecution, goment lawyer produce essential evidence thru dia witnesses say Maina also dey guilty of Money laundering in di sum of N171,099,000 and di moni na proceeds of unlawful act.
Di trial judge say Maina dey guilty say e buy property for Abuja wey e pay cash, di sum of $1.4million wey dey above di normal level of N5million wey e no suppose pass and di transaction no pass through any financial institution. E say na criminal offense.
Olusegun Jolaawo wey be lawyer of Maina say dem go appeal di judgement.
End of Di one wey oda users dey read well well
Meanwhile Maina go remain for di correctional Centre for Kuje.
How Maina mata don waka

Wia dis foto come from, Helen Oyibo
- 2010 - E be chairman of di Presidential Task Team on Pension Reforms
- 2012 - Dem accuse am of corruption
- 2013 - Dem sack am from federal civil service
- 2015 - E enter EFCC wanted list
- 2015 - Dem say e begin hide (tori be say e dey for Dubai)
- 2017 - Dem appoint am acting Director Human Resources for Interior ministry
- 2017 - October 23. President Buhari sack am again from civil service
- 2017 - E bin still dey under investigation… tori be say im don go into hiding
- For 2020, Di Nigerian Police Force announce say dem don re-arrest arrest Abdulrasheed Maina for Niamey, the Niger Republic and extradite to di kontri to kontinu I'm trial.
- For 2021: Afta plenti court hearing, di Federal High Court sentence Maina to prison for eight years
Abdulrasheed Maina Profile

Wia dis foto come from, MEDIAMAFIA
Dem born Abdulrasheed Maina for im village for Biu Local goment area of Borno state of Nigeria. Dem born am around 1950.
Abdulrasheed Maina marry Laila Maina and dem get pikin and one of dem, Faisal Maina don chop 14 years prison sentence ontop accuse of money laundering.
Before Maina become di oga of Pension Reform Task Team, Maina serve as senior administrator for Customs, Immigration, and Prison Pensions Office (CIPPO) for years.
For 2010, dem come appoint am as di chairman of PRTT (Pension Reform Task Team) and e head di task team from 2010 to 2013.











