Nigeria: Who employ Abdulrasheed Maina?

Wia dis foto come from, Facebook/Abdulrasheed Maina
President Muhammadu Buhari don receive report of how Abdulrasheed Maina take get government work, even though say dem dey find am for corruption.
Presidential spokesperson, Femi Adesina, bin confirm on Monday night say President Buhari don receive di report from di Head of Nigeria civil service, Winifred Oyo-Ita.
Adesina wey talk for Channels Television, say dem submit di report to di president chief of staff, Abba Kyari, on Monday evening.
President Buhari bin give order for di same Monday, say make dem sack Maina from im work as Acting Director, Human Resources inside Nigeria Ministry of Interior, as im name dey list of people wey dey face investigation on top corruption mata.
But di question wey remain na how Abdulrasheed Maina take enter government work again.
Ms Oyo-Ita, wey be di Head of Nigeria civil service bin deny say she allow person wey dey face corruption charges return to another big position for government.
She go become di second person, after di Nigeria Minister of Interior Abdulrahman Dambazau bin don also deny say no be him employ Abdulrasheed Maina.
As Head of Nigeria civil service, na Ms Oyo-Ita dey responsible for people wey dey work for federal civil service for Nigeria, while as Minister of Interior, na Dambazau ministry main-main, Maina go work under.
End of Di one wey oda users dey read well well
How Maina mata don waka
•2010 - Chairman of di Presidential Task Team on Pension Reforms
•2012 - Dem accuse am of corruption
•2013 - Dem sack am from federal civil service
•2015 - E enter EFCC wanted list
•2015 - Dem say e begin hide (tori be say e dey for Dubai)
•2017 - Dem appoint am acting Director Human Resources for Interior ministry
•2017 - October 23. President Buhari sack am again from civil service
•2017 - E still dey under investigation… tori be say im don go into hiding
Di matter dey everybodi mouth
Many Nigerians bin don dey vex on top di tori say Mr Maina dey work dey go, even though e be like e get case to answer.
Former president Goodluck Jonathan bin bring in Maina for 2010 to come clean di pension scheme wey too dey get tori of corruption for Nigeria.
But na only two years Maina spend for di job, before dem accuse am for 2012 say im do magomago for di same pension scheme, wey pass N100 billion.
Based on dat accusation, one Senate committee come issue warrant for im arrest after dem do dia investigations.
Dat one come make di Head of Service for Nigeria to sack am, and for 2015 EFCC mention im name when dem carry some people go court on top corruption mata.
Infact sef, for EFCC website dem put Maina name for dia "wanted" list, after im run comot for Nigeria when dem dey find am on top di case.

Wia dis foto come from, EFCC/Nigeria
People enter Twitter to talk dia mind on di mata, especially as e be say dis one dey happen under President Muhammadu Buhari, wey don build im government around fighting corruption.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Many people don talk say dem no get faith for all di talk-talk of President Buhari on top anti-corruption mata if dis kain thing fit happen.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4

End of X post, 5
Earlier, di Ministry of Interior bin don wash hand comot for di mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 6

End of X post, 7

End of X post, 8

End of X post, 9
But Nigerians no waste time.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 10