Obi Cubana: EFCC don grant Obinna Iyiegbu bail

Wia dis foto come from, OBI CUBANA/INSTAGRAM
EFCC don finally free socialite Obinna Iyiegbu alias Obi Cubana afta im spend three days for dia custody.
EFCC been give am two weeks notice to report for dia Wuse Office.
Im report dia on Monday around 11 a.m and dem been dey investigate am for money laundering, tax evasion and abuse of di Naira.
Even though Obi Cubana wey be di owner of Cubana chain of restaurants don free, BBC Pidgin source reveal say investigations still dey go on on di allegations wey EFCC sama for im head.
Di 46-year old business man, Obi Cubana na from Anambra state for eastern Nigeria and e dey into entertainment and hospitality business.
E bin make headlines early dis year for July, 2021 with di burial of im mama for im hometown of Oba, Idemili South with di kain money dem spend and showcase during di burial.
Tins to know about Obi Cubana

Wia dis foto come from, OBI CUBANA/INSTAGRAM
Obinna Iyiegbu aka Obi Cubana na businessman, entertainer, entrepreneur plus philanthropist dey for di custody of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Oga Iyiegbu na di chairman and owner of di popular Cabana groups.
End of Di one wey oda users dey read well well
E enta limelight during di burial of ceremony of im mama, Mrs Uche Mabel Uyiegbu wey take place for im home town for Oba, Idemili South Local Goment Area of Anambra State.
Di 46-year old business man dey into entertainment and hospitality business. Dem born am for 12 April 1975.
Di political science graduate say im make im first one million naira for 1999 during im National Youth Service Corp (NYSC) scheme.
Oga Iyiegbu career as businessman start for 2006 wen e establish one Nite Club for Abuja. E later build anoda hospitality club e call Cubana for Owerri for Imo state and get multiple businesses from there.
Im be family man: Obi Cubana dey married to Ebele Iyiegbu and dem get children together.
Believer in God: From im post on social media and di interview e get wit BBC Pidgin, Obi Cubana come across as pesin wey believe in God as e say "Prayer, consistency in handiwork, human connections wit pipo, na di road of success."
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.















