Ghana international flights dey resume afta months of Covid-19 restrictions - See how you fit qualify to use di airports from now on

Wia dis foto come from, facebook/@ghanaairports
Ghana dey join kontries like Ethiopia, Egypt and Senegal to open dia international airports to resume travel by 1st of September .
President Nana Akufo-Addo na im order say make air, land and sea borders open again afta Ghana see drop in number of covid-19 cases.
For ontop television on Sunday 30 August, 2020 Ghana President, Nana Akufo-Addo say all travellers must show proof say dem no get coronavirus as dem must present Covid- 19 test result wey read negative and neva pass 72 hours before dem comot di airport.
Dem go also do anoda test wen dem reach airport and di result go comot within 30 minutes. Di passengers go pay for di test. Those wey test positive, go undego further assessment and treatment. All passengers go follow all di safety protocols wey include wearing of face mask wey dey compulsory.
Airline wey no follow all goment directive go chop sanction.
Cases of coronavirus don continue to dey drop for di kontri, di number of active cases na over one thousand inside di 44, 205 confamed cases.
Usually for every week, around 24, 500 passengers na im dey enta Kotoka International Airport for Accra. Domestic flights bin don resume three months ago. But di kontri land and sea borders go still dey closed.

Wia dis foto come from, Ghana Airports Company

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP/Getty Images
Inside one televised address to di nation on Sunday 17 August, 2020 President Akufo - Addo say di decision to reopen di airport to international flights go depend on whether dem go fit test all di passengers wey enta di airport.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di move na prevent further spread of di virus in kontri. About twenty four thousand five hundred (24,500) passengers arrive for di Kotoka International Airport everi week.

Wia dis foto come from, facebook/@ghanaairports
Domestic flights don alreadi dey operate for di west African kontri.
Di president also announce further relax restrictions and reopening of higher schools alias tertiary institutions inside di kontri next week.
Director General of di Ghana Health Service Dr Patrick Aboagye don tok say dem go do exercise ontop di mata dis week to know di kontri strength to test all di passengers as dem arrive.

Wia dis foto come from, Ghana Airports Company Limited
Dem dey consider adopting di covid-19 rapid testing system at for di airport next week.
Covid-19 cases don see huge drop from over three thousand active (3,3007) cases inside di last three weeks to more than one thousand active cases (1,847) as of Saturday.
Di kontri don so far cari out over four hundred thousand (427,121) covid-19 tests.













