How Ghanaians react afta Ghana Electoral Commission (EC) admit foreigners & minors into new voters register

Ghana voters register

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, President Nana Akufo-Addo dey do im registration for Ghana new voters register
Read am in 2 mins

Some Ghanaians no make amused after Ghana Electoral Commission (EC) admit say some minors and foreigners find dema way onto de new register.

EC Chairperson, Jean Mensah talk media reveal say dem dey put in measures to clean de register before de December polls.

Ghana voter registration exercise

Wia dis foto come from, Ghana Electoral Commission

"We know say a number of minors find dema way onto de register," Jean Mensah admit.

"We be confident say de challenge process for all districts throughout de country go help deal plus dis illegality and rid de register of those who no for dey there," she add.

But some Ghanaians no dey take dis revelation lightly sake of de purpose of compiling new register be say dem go make sure say only citizens go dey top.

Ghana

Wia dis foto come from, Electoral commission of Ghana

Ghana voters register

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Na 3 August na im Preident Akufo-Addo perform im own voter Registration exercise

One of de major issues wey lead to de compilation of new voter register be talks say de voter register get other West African inside.

Some social media users dey react say instead of compiling new Ghanaian only register, de register rather move from de supposed old ECOWAS status to United Nations status.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Ghana voters register

Wia dis foto come from, Ghana voters register

Wetin we call dis foto, President Akufo-Addo wit im new voters card

What EC go do about minors and foreigners on register

Electoral Commission (EC) after de new registration process dem register 16.9 million persons so far.

EC say de current figures be provisional pending processes of deduplication and adjudication.

Again, EC say de challenge system wey dey in place during de registration and exhibition exercise go help dem flag unqualified voters on de register

According to Jean Mensah, EC chairperson believe say these things go help clean de register and ensure say de e be credible.