Immaculate Okochu, face of Cold Stone Creamery sudden death for Lagos traffic collision accident shock friends

Wia dis foto come from, Immaculate Okochu
Wen Immaculate Okochu post some of her beautiful pictures on 11 August for her social media page, nobodi know say na di last time dem go ever see her.
24 year old Ms Okochu, wey be di Face of Cold Stone Creamery, meet her sudden death for Lagos traffic collision accident on 12 August 2020 for Lagos Island.
"She die yesterday for Badore Road. I just get to di hospital and I meet her. Dem take her to private hospital first, from dia dem take her to General Hospital CMS Marina" Her close friend and wedding planner, Lucy Ibe confam her death to BBC Pidgin.
"I guess na dia dem stop because wen we get dia, she still dey inside boot, on drip and dem no even attend to her or nothing. I guess na dia she die.
Na between 11am and 1pm on Wednesday 12 August na im all dis tins happun to Immaculate Okochu, her friend Lucy add.
Her friend say na pesin wey pick her phone from di scene of di accident na im call to notify her before she rush to di hospital wia Immaculate Okochu give up di ghost.

Wia dis foto come from, Immaculate Okochu
Immaculate Okochu, wey from Delta State southern Nigeria, na Restaurant Manager at Cold Stone Creamery Apapa, before her death.
And she bin dem plan for her wedding in October, 2020.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di beautiful Nigerian lady, na truck crush her to death inside Lagos just hours afta she post note on her Facebook page.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 1

Wia dis foto come from, Immaculate Okochu
She be member of Christ di King Catholic Church, Ajegunle Apapa. She dey survived by her papa and her brother. Immaculate Okochu mama die five years ago.
She (Immaculate Okochu) be pesin wey get good heart, her wedding planner tell BBC Pidgin.
Warning! Di foto of wia truck crush Immaculate Okochu to death go make you feel one kain.
For Nigeria road accidents dey rampant and e don claim many lives.
Friends dey mourn her sudden death
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 2
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 3
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post, 4
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post












